News-edi 1

2593 Results / Page 80 of 289

Background

obodo oyinbo

Iran Send Dia World Cup Team Off With Loud Ceremony For Tehran Square

By : Jolayemi Olajide Iran don hold big send-off ceremony on Wednesday for dia national football team as dem dey prepare go play for 2026 World Cup wey go happen for USA, Mexico and Canada. Players wear red and black tracksuit as plenty fans gather for Enghelab Square for Tehran dey cheer dem, while coach Amir Ghalenoei and football federation president Mehdi Taj join the event. According to Taj, the […]

todayMay 14, 2026 26

OBODO NAIJA

CSO Accuse ECN DG as EFCC Arrest Am Over Alleged N500bn Fraud, Solar Contract Scandal.

By : Jolayemi Olajide Economic and Financial Crimes Commission don arrest Director-General of Energy Commission of Nigeria, Mustapha Abdullahi, for Abuja over alleged money laundering involving about N500 billion. At di same time, one civil society organisation (CSO) accuse am of running “well-coordinated scheme” involving illegal award of solar streetlight contracts worth hundreds of millions to five companies wey allegedly belong to same group of people. Di CSO allege say […]

todayMay 13, 2026 25

OBODO NAIJA

Wike Defend Why Im Buy Waka Go see APC Chairmo

By : Jolayemi Olajide FCT Minister, Nyesom Wike, don dismiss all di yanyanpu say im go visit to APC National Chairmo, Prof. Nentawe Yilwatda, saying dat, im no dey practise “politics of enmity.” Wike tuk dis one Wednesday during inspection of road projects for Karu, Apo-Karshi and Kubwa, saying pipo misunderstand wetin be ordinary visit between former ministerial colleagues. According to am, because dem don work together before, e no […]

todayMay 13, 2026 23

OBODO NAIJA

President Tinubu Land Rwanda for Africa CEO Forum 

By : Olajide Jolayemi Wi oga Presido, Bola Tinubu don land Kigali, Rwanda, to attend di Africa CEO Forum 2026. Say na Rwanda Presido, Paul Kagame welcome am for Urugwiro Presidential Village after im arrive through Kigali International Airport. Video wey dem post show Tinubu dey do korkor come down from Nigerian Air Force plane enter red carpet, while senior Rwanda officials receive am. Di President still inspect guard of […]

todayMay 13, 2026 21 2

OBODO NAIJA

Diezani Corruption Case Near End as UK Court Await Jury Verdict

By: Jolayemi Olajide Former Petroleum Minister, Diezani Alison-Madueke, alongside oil executive Olatimbo Ayinde and her brother Doye Agama, don enter court for dia defence for Southwark Crown Court for United Kingdom. British prosecutors talk say Diezani collect luxury gifts and expensive properties from oil businessmen between 2010 to 2015 in exchange for favour during oil contract awards while she serve as minister. Dem say na dis alleged bribery mata make […]

todayMay 13, 2026 29

OBODO NAIJA

FG Approve 40% Peculiar Allowance for Federal Workers

By : Jolayemi Olajide Federal Gourment don finally approve di long-awaited 40 per cent peculiar allowance for federal civil servants after organised labour mount pressure and threaten industrial action. Di approval come after plenty meeting with Head of Civil Service of di Federation, Esther Walson-Jack, for Abuja on Tuesday. National Salaries, Incomes and Wages Commission also release circular for immediate implementation, ending nearly two years of workers’ agitation over di […]

todayMay 13, 2026 39

OBODO NAIJA

NDLEA Seize N10.4bn Canadian Loud for Lagos

By : Jolayemi Olajide National Drug Law Enforcement Agency operatives don intercept 4,173.5kg of Canadian Loud worth over N10.4 billion for Tincan Island Port, Lagos. NDLEA tuk tuk, Femi Babafemi, wrap dis like moimoi give tori pipo on Wednesday, say na after months of tracking di shipment from Canada. Dis one sef dey come just days after agents recover another large drug consignment from one Lekki stash house.

todayMay 13, 2026 18

OBODO NAIJA

Former Minister Saleh Mamman Chop 75 Years Jail for Mambilla, Zungeru Scam

By : Jolayemi Olajide Former Power Minister, Saleh Mamman don land for koto, big hole, Bag 75 Years Jail for Mambilla, Zungeru Corruption Case. Federal High Court Judge, Justice James Omotosho, naim sentence di former Minister of Power, Saleh Mamman. Say Di court find Mamman guilty on 12 different charges, and Justice Omotosho rule say all di prison terms go run one after di oda, making it a total of […]

todayMay 13, 2026 11

Lagos

Alausa Join Lagos Reps Race, Promise Beta Representation

By : Jolayemi Olajide Brother to senior minister Tunji Alausa, Dr Olayinka Alausa don pick oh, just dat im pick House of Representatives seat form to contest for Oshodi-Isolo Federal Constituency II for Lagos State. Im make dis announcement during stakeholders meeting for im constituency office on Wednesday. Alausa, wey be brother to Education Minister, Dr Tunji Alausa, say na supporters for im political group push am to join di […]

todayMay 13, 2026 41

WHO WE ARE

We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.

We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!

Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!

 

listen with your app

This will close in 0 seconds