News-edi 2

319 Results / Page 10 of 36

Background

National

NDLEA Seize Drugs Weh Dem Hide Inside Frozen Snails, Electrical Bulbs

NDLEA operatives don catch plenty illegal drugs wey dem hide for inside frozen snails, giant rechargeable electrical bulbs, and female clothes wey dem dey send go United States, United Kingdom, and Democratic Republic of Congo. According to NDLEA spokesperson, Femi Babafemi, dem intercept all dis drugs for Murtala Muhammed International Airport and one courier company for Lagos. Two suspects don dey arrested—one na cargo agent, Boladale Riliwan, wey dem catch […]

todayOctober 20, 2025 3

National

FG Do U-Turn On Maths Policy As Parents, Teachers Para

Some students wey dey study Arts and Humanities bin don begin celebrate after Federal Government talk say Mathematics no go dey compulsory again for admission into university and other higher institutions. But di celebration short as di govment sharply reverse di policy, come insist say Maths still remain compulsory for admission. Last Tuesday, dem first announce say students wey wan enter universities, polytechnics, colleges of education and Innovation Enterprise Institutions […]

todayOctober 20, 2025 3

National

ASUU Strike: Naija Lecturers Dey Yan With FG, Dem Show Better Progress

Academic Staff Union of Universities (ASUU) don yan say dem don kickstart negotiation with di federal government over di ongoing strike wey don paralyze activities for public universities. Di union reveal this one for Strike Bulletin No. 2, wey National Strike Coordinating Committee (NSCC) drop and Dr Christopher Piwuna sign over di weekend. Na after dem announce two-week warning strike last week Monday, wey make schools across Naija public universities […]

todayOctober 20, 2025 2

Entertainment

Senator Ned Nwoko Brother Yan On Regina Daniels Marriage Wahala

Michael Nwoko, di brother to Nigerian senator and billionaire Ned Nwoko, don open mouth talk say make people calm down as e be say him brother and actress Regina Daniels dey face serious marriage gbege. This one come after Regina show for viral video dey cry say she no fit endure di violence again wey she dey chop for di marriage. Her brother, Sammy West, still accuse Ned of beating […]

todayOctober 20, 2025 5

National

Wike Tell Obi: To Do Birthday For IDP Camp No Go Make You President

Minister of FCT, Nyesom Wike, don tackle Labour Party presidential candidate, Peter Obi, over wetin he talk say public schools for Abuja dey in bad condition. Obi bin visit LEA Primary School for Kapwa and describe di poor state of di school as national disgrace and show say Nigeria no serious with education. But Wike, during di commissioning of new roads for Abuja on Thursday, fire back say Obi just […]

todayOctober 17, 2025 16

National

Falana Ask FG Make Dem Withdraw And Review Presidential Pardon List

Senior lawyer falana don talk say fg suppose withdraw and review di presidential pardon list sharp-sharp, for justice and national morality sake. E talk say even though president get power to pardon people wey dem convict for federal offence, di list of pardonees still get people like politicians wey dem convict, drug barons, armed robbers, terrorists plus those wey dem convict for serious state offence like murder, culpable homicide and […]

todayOctober 17, 2025 9

International

Chimamanda Adichie Nack 3 Big Europe Book Awards For Just 3 Weeks

Renowned Nigerian writer Chimamanda Ngozi Adichie don bag three ogbonge European literary awards inside just three weeks, wey show say her voice strong wella for world literature. Di winning run start on September 20, 2025, for Germany where she collect di first-ever Felix Jud Prize for Defiant Thinking for Hamburg. Di award na for people wey dey stand gidigba for freedom of thought and bold moral stance. Di jury hail […]

todayOctober 17, 2025 18

Lagos

State Houses of Assembly Too Weak, Docile – Ikuforji, Former Lagos Speaker

Former Speaker of Lagos State House of Assembly, Adeyemi Ikuforiji don talk say Nigerians suppose hold state governors and local government chairmen responsible for governance, instead of always blaming di federal government. As e talk for him office for Lagos dis week, Ikuforiji point say state and LGs dey collect over 50% of federal allocation, yet citizens no dey hold dem to account. E say people get better access to […]

todayOctober 17, 2025 8

Lagos

Lagos Dey Redefine Agriculture As Engine For Growth, Sustainability – Sanwo-Olu

Govnor Babajide Olusola Sanwo-Olu don yan say him administration dey fully committed to turn agriculture into strong engine wey go bring growth, carry everybody along, and keep things sustainable. E talk dis one on Thursday for di 2025 World Food Day celebration wey happen for Police College, Ikeja. Di theme na “Hand in Hand for Better Foods and a Better Future.” Sanwo-Olu, wey Barrister Bimbola Salu-Hundeyin, di Secretary to di […]

todayOctober 17, 2025 5

WHO WE ARE

We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.

We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!

Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!

 

listen with your app