News-edi 2

1832 Results / Page 12 of 204

Background

Lagos

Customs Kram Smugglers with N43.5bn Hard Drugs

By: Kofoworola Olayinka Kasala burst wetin nor gud for  Apapa port as Naija Customs Service, kpake  13 giant containers full of hard drugs and expaya goods total N43.58 billion. Dis one nor be say dem shoot bird mama fly, Say if to say dem allow dis expaya guds enter obodo Naija, omo tins for spoilli say leg go turn hand and gutter for turn swimming pool, na so eyes for […]

todaySeptember 11, 2026 9

Politics

APC Don Ready For 2027, Say Campaign No Go Be Fight fight

By: Ayobami Dada APC Presidential Campaign Council don talk say dia 2027 campaign no go be about dragging or insulting pipu, but dem go face issues and wetin Presido Bola Tinubu gornment don achieve. Na di council Director-General, Senator Abdulazeez Yari, tok dis one for Gusau on Wednesday after e meet Zamfara Gofnor Dauda Lawal and some traditional rulers for di state. Yari say Naija don see plenty wahala wey […]

todaySeptember 10, 2026 7

Sports

Flick Back Yamal for Ballon d’Or

By: Ayobami Dada Barcelona coach Hansi Flick don back Lamine Yamal to win di 2026 Ballon d’Or after di teenager shine for Barcelona 5-1 win over Feyenoord for Champions League. Flick say Yamal na exceptional and special player, adding say e deserve to win di award this year. Yamal dey among di 30-man shortlist for di Ballon d’Or, after helping Barcelona win LaLiga and Copa del Rey last season. At […]

todaySeptember 10, 2026 7

Education

Sanwo-Olu Appoint Prof Badejo As New LASU VC

By: Ayobami Dada Lagos state Gofnor Babajide Sanwo-Olu don approve di appointment of Professor Ayodeji Olawunmi Badejo as di new Vice-Chancellor of Lagos State University, LASU. Na di Lagos State Commissioner for Information and Strategy announce di appointment fir statement wey e release on Wednesday. Professor Badejo wey be professor of Guidance and counselling go take over from professor Ibiyemi Olatunji Bello, as her five-year tenure don finish. Di new […]

todaySeptember 10, 2026 9

obodo oyinbo

Trump Say Republicans Win, Every Adult Go Get $5,000

By: Ayobami Dada Us presido Donald Trump don promise to give every adult American $5,000 if Republicans win control of both House of Representatives and Senate for November midterm election. Trump make di promise on Wednesday for Republicans Party first midterm convention for Dallas, Texas, as e turn di campaign rally into plan wey fit put plenty money for American pocket. Trump call di money "dividend" but e no explain […]

todaySeptember 10, 2026 11

Sports

Raphinha Fire Two As Barca Scatter Feyenoord 5-1 for Champions League

By: Ayobami Dada For Wednesday UEFA Champions League match, Barcelona Captain, Raphinha continue im fine goal-scoring form as e score two goals to hellep Barca scatter Feyenoord 5-1 and start dia Champions League campaign with big win. Karim Adeyemi score one beautiful long-range goal, while Lamine Yamal bend one free-kick enter net as Hansi Flick boys dominate dia Dutch visitors. After Sem Steijn score one goal for Feyenoord, Barcelona substitute […]

todaySeptember 10, 2026 9

obodo oyinbo

Flights To Di United Kingdom Worwor As Dem Cancel Nearly 400 Flights

By: Ayobami Dada Pipu wey dey travel by air for UK face more wahala on Wednesday as dem cancel nearly 400 flights across di country, after technical problem affect Britain air traffic control service, wey say di incident no be cyberattack. After 1,746 flights cancel on Tuesday following di outage, another 399 flights cancel on Wednesday, mostly flights wey dey go or come from London Heathrow Airport, one of Europe […]

todaySeptember 10, 2026 8

National

Shettima Hail NELFUND As Lifeline For Poor Students

By: Ayobami Dada Vice Presido, Kashim Shettima don tok say di Nigerian Education Loan Fund, NELFUND, as landmark programme wey don give poor families better financial relief and remove money wahala wey dey stop students from going higher school. Di Vice Presido tok dis one on Wednesday for statement wey Senior Special Assistant to di President on Media and Communications, Stanley Nkwocha, release, after Shettima receive University of Abuja management […]

todaySeptember 10, 2026 8

National

Akpabio Carry Alleged Anti-North Statement Go Giv Department of State Service

By: Ayobami Dada Senate Presido,  Godswill Akpabio don petition Department of State Services, DSS, on top one statement wey dem dey circulate for Facebook and other social media platforms, wey allegedly dey attack pipu from Northern Nigeria. Na di Special Assistant on Media to di senate presido, Jackson Udom, carry di petition for hand giv tori pipu for Abuja on Wednesday. Akpabio Chief of Staff, Chinedu Akubueze, file di petition […]

todaySeptember 10, 2026 7

WHO WE ARE

We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.

We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!

Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!

 

listen with your app

This will close in 0 seconds