News-edi 2

1371 Results / Page 75 of 153

Background

obodo oyinbo

Russia Strike Ukraine Hard Just Before Ceasefire Kpaing 26 Pipo

By: Esther Ayoola Say confusion gadinma, as Russia attack Ukraine with drone and missile, kpaing at least 26 persons and wunjur over 80, just few hours before ceasefire suppose start. According to reports from Russia, Di heavy bomb hit cities like Kramatorsk, Zaporizhzhia, Chernihiv and even Dnipro, an e cause serious damage. Zaporizhzhia alone lose at least 12 people, while Kramatorsk and other places also record casualties as attack continue. […]

todayMay 6, 2026 17

National

IGP Disu Launch New Police Unit, Promise Beta Policing

By: Esther Ayoola Oga Inspector General of Police, Olatunji Rilwan Disu don announce new police group, Violent Crime Response Unit (VCRU) to replace di former SWAT team. According to di IGP, di new unit go dey operate with strong intelligence support and dem go train di officers to respect human rights and combat crime. Baba Rilwan tuk dis one for press conference on Tuesday for force headquarters directing commissioners of […]

todayMay 6, 2026 15

National

First Lady Oluremi Tinubu Push For Women Inclusion

By: Jolayemi Olajide Naija First Lady Oluremi Tinubu don organise her women’s, dey back her hobbi, di kontri number one man, Presido Bola Tinubu, to help push women inclusion for gorment. She tuk dis one for one big women rally for Abuja, say normally for a working country, women suppose get voice. Mama Tinubu press yarns dat based on women importance, gornment gat do empowerment oh, support women full participation […]

todayMay 6, 2026 10

OBODO NAIJA

Senate Go Send Joint Committee Go South Africa Over Attack On Nigerians

By : Jolayemi Olajide Senate like dis don agree to set up one joint ad hoc committee with House of Representatives to tackle di plenty xenophobic attacks against Nigerians for South Africa. Oga Senate Presido, Godswill Akpabio, align every for senate plenary on Tuesday, say in fact dem go write South African Parliament Speaker. Say di committee, wey go dey under di Chairman of di National Assembly, go travel go […]

todayMay 6, 2026 14

Obodo Niger

President Tinubu Address Global Investors For Paris Say Make Dem Flog Business Come

By : Jolayemi Olajide Oga Presido, Bola Tinubu say like dis don meet big investors for Paris, France, yanyanpu every, as im economic reforms dey go and how im gorment take dey spend money wisely. Tinubu say di plan na to remove jogolos for inside Naija Economy and make every wia coolelecoolele. Baba Seyi explain every say Naija economy don dey stable oh and dat now dem dey find continuity […]

todayMay 6, 2026 16

Lagos

How Lagos Police Command Take Cut Chain For Cultism

By : Jolayemi Olajide Lagos State Police Command don drop strong warning on Tuesday for Lagos, say dem nor wan use eyes see cultism. Oga Commissioner of Police, Tijani Fatai, naim package dis mata dey tuk for video on Tuesday wey dem give Lagos news waka bouts. According Tijani, joining di secret cult group alone without illegal doings sef, na crime under di law, advising Lagos young boys and girls […]

todayMay 6, 2026 11

Lagos

Lagos Gorment Step Up School Safety Sensitisation, Teach Student And Teachers

By: Jolayemi Olajide Lagos State Gornment don reaffirm dia commitment to protect students for obodo Lagos through sensitisation programme for public secondary schools. Senior Special Assistant to Gov. Babajide Sanwo-Olu on Basic and Secondary Education, Opeyemi Eniola, naim im dey conversate dis mata during dia one-day sensitisation programme wey sup Alausa, Ikeja on Tuesday. Say di programme go focus on climate change, environmental sustainability and road safety, and helping teachers […]

todayMay 6, 2026 14

Lagos

Govo Sanwo-Olu Promise Cash, Hajj Packages As Lagos Pilgrims Set For Hajj Journey

By: Jolayemi Olajide Govo Babajide Sanwo-Olu on Tuesday don announce say Lagos State go give pilgrims wey dey travel for Hajj different gifts and cash to support dem go Saudi Arabia. Di governor, wey Commissioner for Home Affairs, Olanrewaju Ibrahim represent, yarn dis one for TV sit down tuk, during di pilgrim’s seminar and send-forth programme. According to am, di state go pay for ihram cloth, hadiyah ram, siyara visit […]

todayMay 6, 2026 13

National

IGP Wire Commissioners Of Police To Check Tools

By: Esther Ayoola Oga Inspector General of Police, Tunji Disu, like dis don send order to all stations across di obodo Naija to check all dia working tools make wetin hapun for Delta nor repeat imself. Im yan dis one during a meeting with senior officers in Abuja on Tuesday. Disu clear im Commissioners of Police to conduct proper check of all dia tools. Dis sef dey come afta a […]

todayMay 5, 2026 19

WHO WE ARE

We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.

We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!

Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!

 

listen with your app

This will close in 0 seconds