News-edi 2

1806 Results / Page 8 of 201

Background

Local

NEMA Warn River Niger Communities Make Dem Ready for Flood

By: Kofoworola Olayinka NEMA official Madukwe don warn people wey dey live near River Niger and other flood-prone areas to stay alert and ready move to safer places if flood palava start. She say residents no suppose wait make water enter dia houses before dem take action, because early preparation fit reduce di damage flood fit cause. Madukwe say NEMA, SEMA and Nigerian Red Cross go continue to monitor River […]

todaySeptember 11, 2026 12

Local

Otti Wife Give 400 Women With Disabilities N20m Support

By: Kofoworola Olayinka Abia Gofnor Wife Priscilla Otti don give N20 million and food items to 400 women wey dey live with disabilities for Umuahia on Friday. Otti, through her Safe Tent Care Initiative, say di support na to help women wey dey face financial hardship and make sure dem no dey left behind. She say her office don dey support people with disabilities since 2023, with plans to train […]

todaySeptember 11, 2026 11

obodo oyinbo

Iran President Say US Pressure Don Reach Dangerous Level

By: Kofoworola Olayinka Iran Presido Masoud Pezeshkian say US pressure on Iran don reach critical and dangerous level, as e speak for India on Friday ahead of BRICS summit. Pezeshkian say heavy sanctions and economic pressure don make Iran matter worse, especially after US and Israel military attack on Iran. He say di world dey face unprecedented complexity, as di conflict don hit Iran economy wey international sanctions already weaken.

todaySeptember 11, 2026 10

OBODO NAIJA

Police Burst Fake 50,000 Recruits Training Story

By: Mariam Ajayi Police don expose fake statement wey dey waka round social media, say IGP Olatunji Disu don order training for 50,000 new police recruits. Police tuk say dem no issue or approve di statement, even as dem use Police letterhead and name of dia spokesperson package am. Di fake paper claim say Police don arrange training for di new recruits, with focus on discipline, professionalism and human rights. […]

todaySeptember 11, 2026 13

OBODO NAIJA

Shettima Land India To Represent Tinubu For BRICS

By: Damilola Adekunle Vice Presido Kashim Shettima don land New Delhi, India, to represent Presido  Bola Tinubu for di 18th BRICS Leaders’ Summit. Shettima dey lead high-level Najia team as Najia dey look to boost trade, investment and International relations with BRICS member and partner countries. Najia time  go also push areas like agriculture, technology, AI, industrial development and digital economy. Foreign Affairs Minister Bianca Odumegwu-Ojukwu say Najia wan learn […]

todaySeptember 11, 2026 11

OBODO NAIJA

Akpata Say AI No Fit Replace Courtroom Argument

By: Damilola Adekunle Olumide Akpata tok  say pipo wey wan succeed for law must sabi build strong argument and convince pipo, as AI no fit replace human courtroom skills. Akpata, wey be di 30th President of NBA, tok dis for Port Harcourt for di NDDC 2026 Moot and Mock Trial Competition for law students across Niger Delta universities. E commend NDDC for di competition and tell universities to establish moot […]

todaySeptember 11, 2026 10

OBODO NAIJA

Federal Gornment Wan Comot Attempt Suicide From Criminal Mata

By: Mariam Ajayi Federal Government wan start to comot criminal mata  for attempt suicide, as Federal Executive Council approve Health Ministry position on di matter. Minister of State for Health, Dr Iziaq Salako, tuk dis for Abuja during 2026 World Suicide Prevention Day commemoration. E say di proposal go now move go National Assembly for lawmakers to begin necessary legislative process. Salako argue say pipo wey dey face mental health crisis […]

todaySeptember 11, 2026 11

Sports

Falconets Play Goalless Draw With China

By: Mariam Ajayi Naija Falconets don manage 0-0 draw with China for Arena Sosnowiec inside Poland, as dem bag first point for Group F after losing  dia first game two-zero to Spain. Even though di Nigerian gals create fine-fine scoring chances, e con be like say, China na AI robot dem take block dia post. With dis game, China dey four points while Spain don already secure ticket to Round […]

todaySeptember 11, 2026 10

obodo oyinbo

Gambia Vex Protest say Dem nor get light for 48 hours

By: Mariam Ajayi Nor be small tin for Gambia, say Thousands of angry youths  enter street near Banjul for Gambia overnight  vex, squeeze face like man wey mess for taxy. Before Police say jack, Youths begin sing wi nor go gree, we gree, ha, wetin ona nor dey gree, say may dem nor go get light for 2 days and heat dey> Suuuu, say na di second time dis week […]

todaySeptember 11, 2026 9

WHO WE ARE

We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.

We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!

Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!

 

listen with your app

This will close in 0 seconds