News-edi 2

671 Results / Page 37 of 75

Background

International

Air India Crash Survivor Talk Say Life Don Tough Well-Well Since Di Accident

Di only survivor of di Air India plane crash, Vishwash Kumar Ramesh, don talk say life since di June 12 tragedy don hard well-well. Di crash wey kill 241 passengers for di London-bound flight and 19 people wey dey ground happen shortly after take-off from Ahmedabad, India. Ramesh, a British citizen from Leicester, manage waka comot from di wreckage wey he call “a miracle”, but he lose him brother, Ajay, […]

todayNovember 4, 2025 13

International

Court Order Trump Govt Make Dem Resume Food Aid For 42m Americans Amid Shutdown

Two federal judges don order Trump government make dem continue di food help wey dey reach millions of Americans even as di government shutdown still dey hold ground. Di judges for Massachusetts and Rhode Island talk say di White House no get power to stop di Supplemental Nutrition Assistance Program (SNAP), wey dey help poor people buy food every month. Dem order make di government use emergency money to make […]

todayNovember 4, 2025 5

International

South Korea Don Triple Money Weh Dem Go Spend On AI For 2026 Budget

South Korea don raise dia AI budget reach 10.1 trillion won (about $7 billion) as part of plan to push di country enter top three AI powers for di world, join US and China. Prime Minister Lee talk say di new budget go bring “major transformation” wey go usher in di real “AI era” for South Korea. Dis money wey dem wan spend na more than three times wetin dem […]

todayNovember 4, 2025 15

Sports

Arteta Talk Say Gyokeres No Go Face Slavia Prague

Arsenal coach Mikel Arteta don confirm say Sweden striker, Viktor Gyokeres, no go fit play against Slavia Prague because of di muscle injury wey make am commot for pitch during Arsenal 2-0 win over Burnley last weekend. Gyokeres no train on Monday as Arteta talk say him dey worried since di player never get this kind muscle wahala before. Di Spaniard yarn for pre-match press conference say dem dey still […]

todayNovember 4, 2025 4

Sports

Osimhen: Galatasaray Wan Show Power For Europe

Super Eagles striker, Victor Osimhen, don talk say Galatasaray get big dream for this season UEFA Champions League. Di Turkish giants don return to Europe top table after one season break. Even though dem lose dia first match 4-1 to Eintracht Frankfurt, dem bounce back strong with home wins against Liverpool and Bodo/Glimt, wey Osimhen score three goals for both games. Next, dem go face Ajax away on Wednesday as […]

todayNovember 4, 2025 6

Sports

UCL: I No Go Celebrate If I Score Against Liverpool – Alexander-Arnold

Real Madrid defender, Trent Alexander-Arnold, don talk say e no go celebrate if e score against im former club, Liverpool, for Tuesday Champions League clash wey go happen for Anfield. Di England international wey leave Liverpool go join Real Madrid this summer yarn di matter when e dey talk with Amazon Prime Sport. According to am, e still get strong bond with Liverpool and e no fit forget di club […]

todayNovember 4, 2025 5

Sports

EXCLUSIVE: Bonfrere Warn Super Eagles – Protect Nwabali To Avoid Mistake

Former Nigeria coach, Jo Bonfrere, don warn Super Eagles defenders make dem protect goalkeeper Stanley Nwabali well ahead of di crucial 2026 FIFA World Cup African qualifying play-offs for Morocco. Bonfrere talk say if dem no give Nwabali enough protection, e fit lead to careless goals wey go cost Nigeria di World Cup ticket wey go happen for Mexico, USA, and Canada. Di 79-year-old coach talk from im base for […]

todayNovember 4, 2025 9

Lagos

Lagos Beg Supreme Court Make E Uphold Dr. Olaleye Conviction

Lagos State Government don run go Supreme Court to beg make dem uphold di conviction of Dr. Olufemi Olaleye, di Medical Director of Optimal Cancer Care Foundation, wey dem first sentence to life imprisonment for defiling im wife 16-year-old niece. Di Lagos State Sexual Offences and Domestic Violence Court bin convict am for October 2023, but Court of Appeal for Lagos later free am for November 29, 2024, say di […]

todayNovember 4, 2025 20

Lagos

Cooking Gas Price No Gree Come Down, Still Dey Sell ₦1,200 Per KG

Di price of Liquefied Petroleum Gas (LPG), wey people sabi as cooking gas, still dey high even after marketers don promise say e go return to di old price of ₦950 to ₦1,000 per kilogram. For Lagos yesterday, gas stations still dey sell between ₦1,200 and ₦1,400 per kg. For Gasland, Igando for Ikotun area, and Mac Rich gas plant for Cele-Okota, one kg go for ₦1,200, while other stations […]

todayNovember 4, 2025 13

WHO WE ARE

We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.

We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!

Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!

 

listen with your app