News-edi 2

1385 Results / Page 35 of 154

Background

Sports

FIFA Clear Balogun To Play Belgium

By: Yusuf Abuh US Presido, Donald Trump, like dis dey dance azonto, thank FIFA, after dem suspend Folarin Balogun one-match ban, wey go allow di USA striker play against Belgium for World Cup round of 16. Balogun bin collect straight red card after VAR review show say e step on top Bosnia defender leg during USA 2-0 win for di last-32 match. Normally, FIFA rule tuk say straight red card […]

todayJuly 6, 2026 15

Uncategorized

Haaland Scatter Brazil

By: Yusuf Abuh Norway don shock Brazil 2-1 on Sunday to qualify for FIFA World Cup quarter-final for di first time, as Erling Haaland score two goals send di five-time champions waka go house. Brazil miss beta chance to take lead before half time after Bruno Guimarães miss penalty, as both teams enter halftime goalless. After di break, Martin Ødegaard and Antonio Nusa control di game, with Nusa troubling Brazil […]

todayJuly 6, 2026 17

obodo oyinbo

Iran Rake Say US And Israel Na By-Force Dem Take Recognize Iran Regional Power

By: Yusuf Abuh Iran parliament tuk, tuk, Mohammad Ghalibaf, don drop a bumbshell say United States and Israel nor get level naim make dem sign agreement to work together. Ghalibaf yan dis word for meeting with Yemen Vice Presido, Mohammed Al-Nuaimi, as e dey praising dis e achievement, say no level. E follow talk say di agreement na big political and military failure for America, but na massive win for […]

todayJuly 6, 2026 16

OBODO NAIJA

Army Chief To Employ AI

By: Yusuf Abuh Chief of Army Staff, Lieutenant General Waidi Shaibu, don call on Nigeria say time don reach for us to use artificial intelligence (AI) and other new technology take fight di insecurity gbeges  for di country. E tok dis one during Nigerian Army Day Celebration lecture for Port Harcourt, say insecurity don pass terrorism and banditry enter cyber attacks, organised crime and other tech-driven threats. Shaibu say di […]

todayJuly 6, 2026 11

OBODO NAIJA

Reps Beg Tinubu To Hold On NYSC Reform

By: Yusuf Abuh One house of Rep member from Benue, Philip Agbese don beg wi oga Presido, Bola Tinubu, make im match break for  di proposed NYSC reform until beta eyes look di mata wella. Di lawmaker wey be number 2 tuk-tuk person, yan dis one on Sunday, say even though dem need to modernise di scheme, e no suppose spoil di main aim wey be to unite Nigerians. U […]

todayJuly 6, 2026 15

south west

Oyebanji Vow To Fight Kidnappers After Victims Regain Freedom

By: Yusuf Abuh Ekiti State Governor Biodun Oyebanji don visit di Eda-Oniyo worshippers wey kidnappers release afta dem spend more dan two months for captivity. Di govo see di survivors for Ekiti State University Teaching Hospital, wia dem dey receive treatment, and say sugar wan finish am as im see one small pikin regain consciousness. Oyebanji promise say na di state gornment go pay all di victims' medical bills. E […]

todayJuly 6, 2026 11

Lagos

Lagos Court Give 80-Year-Old Maale Joy Order Gornment To Leave Her Land

By: Yusuf Abuh   One Lagos court, don cut joy soap for one maale, Chief H.A.K. Shonowo, 80-year-old widow, giving her temporary court order wey stop Lagos State Gornment and four oda defendants from taking her land for Lekki Peninsula Scheme I. Justice E.O. Ashade for Lagos High Court, Yaba, give di order pending when di court go hear di  main application for the case. Madam Shonowo, wey dey sue […]

todayJuly 6, 2026 17

Lagos

Lagos Gornment Order Task Force Make Dem Bring Article Shopping Complex

Lagos State Gornment don order make dem demolish Article Shopping Complex for Satellite Town, (nor be only dia) and give traders and building owners for Agric and Coker markets inside Ajeromi-Ifelodun 14 days to carry out structural integrity tests. Officials from Lagos State Building Control Agency (LASBCA) naim go  inspect di markets on Thursday and dem see plenty building wey don weak like old papa teath. Senior man wey dey […]

todayJuly 3, 2026 15

WHO WE ARE

We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.

We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!

Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!

 

listen with your app

This will close in 0 seconds