News-edi 2

1385 Results / Page 36 of 154

Background

Sports

Spain Tear Austria Apart 3-0 To Enter Last-16

Spain paint Los Angeles red as dem sample sweet football block Austria comot for World Cup inside America on Thursday. Mikel Oyarzabal score two goals and Pedro Porro use header finish di job as di European champions tear Austria apart 3-0 for di round-of-32 knockout match. Big Hollywood stars like Penelope Cruz, Javier Bardem, and singer RosalĂ­a all show up for SoFi Stadium to cheer Spain as dem dominate the […]

todayJuly 3, 2026 11 2

obodo oyinbo

WHO Clear Cruise Ship From Deadly Disease, Hantavirus

Di World Health Organization (WHO) on Thursday declare say di deadly hantavirus outbreak inside di cruise ship MV Hondius don officially end after di last person leave quarantine. Inside press conference, WHO Oga Tedros Adhanom Ghebreyesus naim announce di ogbonge update. U sabi say, na 12 pipo catch di virus and three kpai since di ship comot Argentina on April 1. And dis mata bin shake everywia for dat April […]

todayJuly 3, 2026 10

OBODO NAIJA

President Tinubu Open New ECOWAS Building For Abuja

Wi oga Presido, Bola Tinubu don open mouth whaa for ground, tell di world say Nigeria and peace mata na five and six. Baba seyi tuk dis one through im vice, Kashim Shettima as dem ma go open di new ECOWAS headquarters for Abuja, Senior man presido fry mouth dat make di rest of Africa bring deal come and dat Nigeria active 2.4.7, nor be small.

todayJuly 3, 2026 19 3

OBODO NAIJA

Tinubu Say Nigeria Economy Dey Work

Wi oga Presido, Bola Tinubu don again, stand tall like nepa pool again, knack chest, say, di economic reforms wey im gornment bring out, dey show beta workings for di obodo Nigeria. Di Presido drop dis word on Thursday during di very first State House Media Dinner wey shelle for Abuja. Tinubu accept say true-true di mata hard small, like labour pain, but dat di economy don dey steady now […]

todayJuly 3, 2026 14 3

Lagos

Umahi Explain How Coastal Road Take Dey Lagos From Flooding

Wi Minister of Works, Dave Umahi, don water down di tuk say na di Lagos-Calabar Coastal Road project dey cause di heavy flooding wey dey for  Lagos. Umahi clear the air on Thursday for Plateau State, wia dem go package projects Umahi say, in fact na di road project sef dey save Lagos communities and estate from becoming river Niger

todayJuly 3, 2026 10 1

Sports

Pape Gueye Retire From International Football

Senegal midfielder, Pape Gueye, don announce say e no go play for Senegal national team again as long as head coach, Pape Thiaw, still dey in charge. Di 27-year-old make di announcement for social media after Senegal blow two-goal lead come lose 3-2 to Belgium after extra time for dia 2026 FIFA World Cup Round of 16 match. For di post wey e write for French, Gueye tok say e […]

todayJuly 2, 2026 18

obodo oyinbo

13 Pipo Kpai, 86 Wunjure As Russia Use Missile and Drone Scatter Kyiv

According to Kyiv Mayor, Vitali Klitschko, at least 13 pipo don kpai, while 86 pipo carry wunjury after Russia missile and drone attack tear plenti houses inside Kyiv for early momo Thursday. Di attack happen just few hours after Ukraine Presido, Volodymyr Zelensky, warn say Russia dey prepare one massive attack. Media tuk tuk pesin wey dey for central and eastern Kyiv tuk say dem hear more than 12 loud […]

todayJuly 2, 2026 13

OBODO NAIJA

Soldiers Burst Secret Gun Factory For Kebbi, Gbab Two Jaguda Boys

Soldiers under Operation FANSAN YAMMA don burst one secret gun factory for Kebbi State, recover five locally-made AK-47 rifles, and grab two suspected gun makers wey dey supply terrorists with weapons. Confirming di operation for inside statement on Thursday, di Media Information Officer of Operation FANSAN YAMMA, Lt. Col. Aliyu Danja, tok say di soldiers plan well well before di operation. According to di military, na correct intelligence make dem trace […]

todayJuly 2, 2026 13

OBODO NAIJA

Schools Reopen For Oyo State As Teachers End One-Month Strike

Public schools for Oyo State don reopen today after di Nigeria Union of Teachers (NUT) announce on Wednesday say dem don suspend di one-month strike. As dem suspend di strike, NUT Presido, Titus Amba, say di decision come after di union hold talks with di government and also consider say plenty children don stay house for several weeks because of di kidnapping incident. Di union bin direct all public primary […]

todayJuly 2, 2026 12

WHO WE ARE

We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.

We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!

Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!

 

listen with your app

This will close in 0 seconds