News-edi 2

1383 Results / Page 38 of 154

Background

OBODO NAIJA

Tinubu Approve N3.9 Trillion For 27 Road Projects

Wi federal gorment again don tell igwe to give wi oga Presido Bola Tinubu, AKA Baba Seyi di award, say so fa, im don approve 27 road project-dem inside 15 states, and all di contract money na about 3.9 trillion Naira. Oga Minister of Works, David Umahi, fry mouth tuk dis one after di Federal Executive Council meeting for Abuja on Monday. Umahi list di states where di road go […]

todayJune 30, 2026 16

Lagos

Lagos Police Kpai Jaguda Boys, Seize Hard Drugs And Weapons For AGO/FESTAC

Lagos State Police Command don go gbab five suspects wey be members of Aiye cult, say dem run di package for dia normanl  stop-and-search for Ago/Festac Bridge axis. Di Operatives gbab Emmanuel John and David Godwin inside one Toyota Camry with hard drugs, and di touch lighting of dis guys naim con lead to  police arresting Samuel Owubokiri, Adetona Seyi, and David Chigozie. Police search recover dangerous items from di […]

todayJune 30, 2026 11 1

Sports

Esther Okoronkwo Bounce Back From Wunjury

Small moral don enter Super Falcons camp as  midfielder Esther Okoronkwo return to action for AFC Toronto, playing 25 minutes as dem beat Vancouver Rise 3-1 on Sunday. Di 29-year-old bin stay out for almost two months because of wunjury  wey she suffer during one league match against Halifax. Her comeback don give Nigeria better hope as di Super Falcons dey prepare for 2026 Women's Africa Cup of Nations wey […]

todayJune 30, 2026 13

obodo oyinbo

South Africa Police block Everywia To Stop Xenophobic Groups

Nor be small tin for South Africa, as police block everywia say xenophobic groups wan drive foreigners to comot. Dem lock up shops tight and streets quiet like say na grave yard for Johannesburg as police dey patrol to block any kind fight or looting. For Durban, small groups of protesters wey wear Zulu clothes and hold stick and shield gather for park dey sing "abahambe", wey mean "make dem […]

todayJune 30, 2026 12

south west

Amotekun Rescue Kidnap Victim

Amotekun senior men officers  inside Ondo State don do james bond rescue one person wey kidnappers carry and dem arrest one papa join his three sons for Oba Akoko area. Di Amotekun Commander, Adetunji Adeleye, say dem catch di papa, Iliasu, and im pikins dem, say dem turn kidnapping to family business. Dis na after di victim papa report to dem. Dem catch di suspects with different things like drugs, […]

todayJune 30, 2026 11

OBODO NAIJA

CJN Kekere-Ekun open computer System For Supreme Court Workings

Di Chief Justice, wey be di number judgii for Nigeria, CJN, Justice Kudirat Kekere-Ekun, don announce anoda ogbonge update wey go sharpen Naija Supreme Court like cutlass. Di senior woman yanyanpu dis mata during the NBA Lagos Branch Law Week 2026 on Monday. She fry fry mouth, say di court go soon start to use one new digital system, wey dem dey call, National Case Management System (NCMS) to follow […]

todayJune 30, 2026 12

Sports

Late Goal Carry Canada Enter World Cup Round 16

Canada don qualify for World Cup last 16 for di first time after Stephen Eustaquio score late winner wey give dem 1-0 victory against South Africa on Sunday for di first knockout match. Di game bin dey wan enter extra time oh, before Eustaquio fire one fine shot from outside di box for stoppage time to break South Africa heart. Canada, wey dey co-host di tournament, go now face either […]

todayJune 29, 2026 10

obodo oyinbo

Plane Crash Kpai 11 Near France Airport

Eleven pipo naim don kpai after one civilian plane wey carry skydivers crash, play, play turn to hit an go, say di plane get askident near Tomblaine for eastern France on Sunday. According to local authorities, Di victims include five instructors, five students and di pilot, as di plane fall near Nancy-Essey airport close to residential area. Authorities say nobody wey dey ground die, while dem don open investigation to […]

todayJune 29, 2026 13

OBODO NAIJA

NARD Give FG Four Weeks, Threaten Nationwide Strike

Di Nigerian Association of Resident Doctors (NARD), dat di number one body mata pipo don declare say if wi Federal Gornment nor con follow dem discuss about dia  lazy salary in di next four-week, dem go shut down all hospital house for di Country. Dis according to a paper wey di association release on Sunday after dia special meeting wey hapun online on Saturday. NARD Presido, Dr. Mohammad Usman Suleiman, […]

todayJune 29, 2026 15

WHO WE ARE

We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.

We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!

Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!

 

listen with your app

This will close in 0 seconds