News-edi 2

319 Results / Page 8 of 36

Background

Lagos

LASG Join Hand Wit AFD and Others to Launch €360m Waterways Transport System

Lagos State Government join hand with French Development Agency (AFD), European Union (EU), and European Investment Bank (EIB) to launch big project wey dem call Omi Eko Project. Dis project go upgrade Lagos waterways transport with modern speed boats wey get better technology. Di plan na to make ferry system for Lagos organised, cheap, and better so dat e go connect places well and make life easy for Lagos people. […]

todayOctober 20, 2025 3

Lagos

Insecurity: People Wey Dey Dopemu Area For Lagos Dey Cry Out For Help

People wey dey Dopemu for Agege Local Government Area, Lagos State, don dey cry out to state government make dem help stop the yawa wey area boys dey cause for dia streets. Di boys dey always show for street every evening, especially for places wey get shops, dey carry cutlasses, axes and other dangerous weapons to dey attack traders and people wey dey return from work. Eyewitness talk say di […]

todayOctober 20, 2025 6

Lagos

Nigerians Must Fast, Pray To Avoid Wahala Wey Dey Come — Former Lagos Deputy Gov Ojikutu

Former Lagos State Deputy Governor, Alhaja Sinatu Ojikutu don announce say October 23, 2025, di day wey she go turn 80, go dey observed as day of fasting, prayer, and sobriety. She call make people from all over join body dey pray for survival and better life as hardship dey come. Ojikutu also talk say di day suppose be time to show love and help poor people wey no get […]

todayOctober 20, 2025 4

Lagos

Govt Dey Okay As Dem Dey Remove Illegal Structures For Safety Sake

Group wey concern for Lagos don show strong support for state govt as dem dey remove illegal structures for different areas of Lagos. Di group talk say dem no gree with 30-day ultimatum wey Igbo National Union Worldwide (INU-W) give Lagos govt, say make dem stop di removal. Dem call di ultimatum one way to bring back old wahala like di 1952 NCNC palava for Lagos. Di group talk say […]

todayOctober 20, 2025 3

National

Police Don Arrest Suspected Varsity Cult Leader, Recover Pistol, Others For Ondo

Operatives of di Ondo State Police Command don arrest one suspected cult leader, Boluwatife Abdul, wey be student for Adekunle Ajasin University, Akungba-Akoko (AAUA). Dem describe Abdul as notorious cultist for di school community, and dem catch am red-handed as e dey hold secret meeting with him cult members. Police tok-tok pesin for di state, Olayinka Ayanlade, confirm di arrest, say di guy don dey dia watchlist since. He add […]

todayOctober 20, 2025 4

Sports

Postecoglou Comot As Forest Coach After Chelsea Defeat

Nottingham Forest manager Ange Postecoglou don lose him job on Saturday after just eight matches as coach, minutes after Chelsea waka come City Ground carry 3-0 win. Di club put for X say, “After plenty bad results and poor performance, Ange Postecoglou don stop to be head coach immediately.” Di club no want talk more for now. Forest owner Evangelos Marinakis leave him seat during di match, and after full-time, […]

todayOctober 20, 2025 5

Sports

Paz Fire Como Wey Dey Fly High To Historic Win Over Juve

Rising star Nico Paz show big time again for Como as e score one goal and assist one more for Sunday’s important 2-0 win wey dem knack Juventus. Dis win lift di small club go sixth place for Serie A. Paz set up Marc-Oliver Kempf to score quick for di 4th minute for Stadio Giuseppe Sinigaglia, then Paz seal di deal wit one fine solo goal for last 12 minutes. […]

todayOctober 20, 2025 6

Sports

Amorim Want More After ‘Biggest’ Man Utd Win For Liverpool

Ruben Amorim talk say di first win for Anfield since 2016 na correct reward for Manchester United fans wey don suffer long after Harry Maguire late goal make Liverpool lose fourth game in a row. Di 2-1 win give United back-to-back Premier League wins for di first time since Amorim start as coach near one year ago. But di Portuguese coach talk say how di players go perform next weekend […]

todayOctober 20, 2025 5

Sports

Morocco Make History Wit First-Ever FIFA U-20 World Cup Title

For one landmark moment wey sweet African football belle, Morocco knack Argentina 2-0 for di final of di 2025 FIFA U-20 World Cup wey happen early Monday morning for Santiago, Chile. Di North African boys owe dia big win to rising baller Yassir Zabiri, wey tear net two times for first half — one for 12th minute, another for 29th — wey shut di Argentine fans mouth. Even though Argentina […]

todayOctober 20, 2025 7

WHO WE ARE

We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.

We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!

Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!

 

listen with your app