News-edi 2

1334 Results / Page 10 of 149

Background

OBODO NAIJA

Peter Obi Blast Tinubu Renewed Hope Agenda, Call Am “Renewed Hopelessness”

By: Esther Daniel 2027 presidential candidate of di Nigeria Democratic Congress (NDC), Peter Obi, don blast Presido Bola Tinubu Renewed Hope Agenda, describe am as "failure and renewed hopelessness." Obi tok during interview for Channels Television Sunday Politics programme say if Nigerians elect am as Presido, e go give dem real and tangible hope wey everybody go see. According to am, Tinubu policies never improve di lives of ordinary Nigerians […]

todayJuly 27, 2026 11 3

OBODO NAIJA

Babachir Lawal Say Obi-Kwankwaso Joint Ticket Fit Win 2027 Election

By: Esther Daniel Former secretary to di Gornment of di Federation, Babachir Lawal, don tok say joint presidential ticket between Peter Obi and Rabiu Kwankwaso get better chance to win di 2027 presidential election than if both of dem contest separately. Lawal make di statement during one interview wey e take assess di chances of top political leaders ahead of di next general election. According to am, if Obi and […]

todayJuly 27, 2026 9 3

Sports

Police Grab Suspect Wey Tif Super Falcons Players Money For Morocco Hotel

By: Esther Daniel Police don arrest one suspect wey confess say e tif cash from some Super Falcons players for Marriott Hotel, Casablanca, Morocco, few days before Nigeria first match for 2026 Women's Africa Cup of Nations. Di suspect go return all di money wey e thief, while criminal case don ready to start against am. Midfielder Esther Okoronkwo tok say she, goalkeeper Chiamaka Nnadozie, defender Michelle Alozie and captain […]

todayJuly 27, 2026 12 3

OBODO NAIJA

Gunmen Scatter PVC Sharing For Osun, Carry Voter Cards Go

By: Esther Daniel Some people wey dem suspect say na hoodlums storm one INEC PVC collection centre for Oyinlola DC School, Okuku, Osun State on Sunday and carry some packs of Permanent Voter Cards comot. Witnesses tok say di men enter di place quietly before dem begin shoot for air, make everybody run for safety. Di attack scatter di PVC sharing exercise as people wey come collect dia voter cards […]

todayJuly 27, 2026 11

Sports

Algeria Beat Senegal 2-0 for WAFCON Opener

By: Esther Daniel Algeria don start dia 2026 Women's Africa Cup of Nations campaign with sweet 2-0 victory over Senegal on Sunday for Rabat. Captain Marine Dafeur naim first score from penalty before halftime, while Melissa Bethi seal di win for 88th minute after Senegal goalkeeper Khady Faye make costly mistake. Senegal try put pressure for di beginning of di match, but dem no fit convert dia chances as Algeria […]

todayJuly 27, 2026 9

obodo oyinbo

Wildfire Scarra France and Spain, Hundreds of Thousands Run for Safety

By: Esther Daniel Serious wildfire don continue to burn for southwest France and central Spain near Madrid, forcing more dan 300,000 people comot from danger areas. Firefighters still dey struggle to control di fire as France describe am as "unpredictable," while Spain warn say difficult hours still dey ahead. French firefighters say di massive fire don create one rare fire cloud wey dey produce strong winds and lightning, making di […]

todayJuly 27, 2026 11

OBODO NAIJA

Obi Ginger Oga Presido Tinubu To Dey One Side For Beta Leader To Rule Naija

By: Esther Daniel Labour Party presidential candidate for 2023 election, Peter Obi, don blast Presido Bola Tinubu again, say make wi presido step aside dat im nor get di doings to solve naija security wahala. Obi yarn dis one for tv sitdown tuk on sunday, dat baba need rest oh. E still tok say no mata how many governors support Tinubu for 2027 election, na hungry and suffering Nigerians go […]

todayJuly 27, 2026 10

OBODO NAIJA

How First Lady Oluremi Tinubu Land Ogbonge Award For Heath Mata

By: Esther Daniel Nigeria First Lady, Senator Oluremi Tinubu, don receive di Diaspora Health and Humanity Champion Award for di 2026 National Diaspora Merit Awards, wey hold on Sunday. Say dis award na to thank iya kulikuli based on one or two wey she contribute to health and humanitarian development matas for di obodo naija. Na Wife of di Vice Presido, Hajiya Nana Shettima, naim carry her mouth tuk thank […]

todayJuly 27, 2026 9

Lagos

NDLEA Gbab Balogun Market Trader Over Cocaine

By: Esther Daniel National Drug Law Enforcement Agency, NDLEA, don gbab 55-year-old Lagos businessman, Onuigbo Chinedu, over alleged attempt to export 3.30 kilograms of cocaine wey dem hide inside food cartons wey dey go United Kingdom. NDLEA tuk, tuk, Femi Babafemi, konfam say, dia officers do di arrest for Murtala Muhammed International Airport, Lagos, last weekend. Babafemi explain say three cargo agents wey handle di shipment—Nkwor Onyekachukwu Justina, Adeleke Abiola […]

todayJuly 27, 2026 10

WHO WE ARE

We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.

We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!

Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!

 

listen with your app

This will close in 0 seconds