News-edi 2

1328 Results / Page 7 of 148

Background

Lagos

Sanwo-Olu Govt Launch Greenhouse Gas Registry to Fight Climate Change

By: Esther Daniel Lagos State Gornment done launch di Lagos State Greenhouse Gas Registry yesterday inside Lagos to fight climate change and cut carbon emissions. LASEPA General Manager Babatunde Ajayi tok during di event say di initiative go build climate-smart economy for di state. Dis move make Lagos di first sub-national government for Nigeria to create dis kain comprehensive climate data system. E insist say credible data na di main […]

todayJuly 28, 2026 8

OBODO NAIJA

Free Bazoum Now – Lawyers Demand Release of Niger Deposed Presido

By: Esther Daniel Lawyers for Niger deposed president Mohamed Bazoum done demand im immediate release from military detention for Niamey. Di legal team call for freedom three years after soldiers overthrow am during July 2023 coup. Dem condemn how military hold Bazoum and him wife Hadiza arbitrarily without taking dem to court. Di lawyers insist say holding dem without charge na clear violation of human rights.  

todayJuly 28, 2026 10

OBODO NAIJA

Peter Obi Na Trader, Him No Fit Be Presido

By: Esther Daniel Edo North Senator Adams Oshiomhole done blast Peter Obi on News on Monday, say im no fit ever lead Nigeria. Oshiomhole call Obi ordinary trader who only dey pursue quick profit instead of long-term country project. Di lawmaker accuse am say im business na to export local jobs go outside while importing unemployment enter Nigeria. E insist say di country need real manufacturer to rule am, no […]

todayJuly 28, 2026 10

south west

Ondo Lawmakers Vex With Aiyedatiwa Over Impeachment Crisis

By: Esther Daniel Ondo Assembly lawmakers done accuse Govo Lucky Aiyedatiwa say im dey block dem from impeaching Speaker Olamide Oladiji over N44m chop-chop allegation. Trouble enter Assembly after 21 out of 26 lawmakers sign paper to sack di Speaker for diverting OSOPADEC budget money. Di aggrieved lawmakers give Oladiji till Sunday to resign by himself or face disgrace for House floor. Dem insist say di Govo no suppose to […]

todayJuly 28, 2026 10

Lagos

Sanwo-Olu Hail Badejo Okusanya As She Become 33rd NBA President

By: Esther Daniel Lagos State Govo Babajide Sanwo-Olu done congratulate Senior Advocate Oyinkansola Badejo-Okusanya on Monday after she emerge as di 33rd President of di Nigerian Bar Association. Sanwo-Olu call her victory big history inside one official statement as she become only di second woman to lead NBA. Di govo praise di SAN say dis high position na correct reward for her long years of dedication to legal work. E […]

todayJuly 28, 2026 13

OBODO NAIJA

Shoot Criminal Direct, No Dey Beg! Oshiomhole Vex with IG Disu

By: Esther Daniel Edo North Senator Adams Oshiomhole done blast Inspector-General of Police Olatunji Disu on media station on Monday for apologizing over police shooting. Di lawmaker talk say IGP no suppose dey beg when im tell police to shoot armed criminals on sight. Oshiomhole insist say security agents must shoot bad people immediately without wasting time to clear crime for country. E talk say police need to stand strong […]

todayJuly 28, 2026 10

Sports

Commonwealth Games Organisers Bar Ochonogor From Women Long Jump

By: Yusuf Abuh National long jump champion, Prestina Ochonogor, no go fit compete for women long jump event for di 2026 Commonwealth Games for Glasgow after organisers reject Nigeria request to add her name. According to letter wey Games Technical Delegate, Chris Cohen, sign on Sunday, organisers say Nigeria don already replace Ese Brume with Ruth Usoro, and competition rules no allow another athlete to join di event. Ochonogor qualify […]

todayJuly 28, 2026 15

obodo oyinbo

US, Iran Still Dey Exchange Words As Tension Rise

By: Yusuf Abuh Tension between America and Iran still dey high as US Presido Donald Trump konfam say Washington and Tehran dey hold "friendly tuks," but e no believe say long negotiations go help. Dis one dey inside statement, Iran come reply say na America dey struggle to find beta way to end di conflict between both countries. Meanwhile, Israeli Prime Minister Benjamin Netanyahu don land Washington, DC, to meet […]

todayJuly 28, 2026 16

OBODO NAIJA

FG Send South Africa Message To Stop Attacking On Nigerians Now

By: Yusuf Abuh Wi Federal Government don warn South Africa make dem take serious action to stop di fresh wave of xenophobic attacks wey dey target Nigerians and oda Africans for dia country. Minister of State for Foreign Affairs, Ambassador Sola Enikanolaiye, yarn dis one during meeting with South Africa Minister of International Relations and Cooperation, Ronald Lamola, say na about 98 Nigerians don kpai  since 2022, and criminals suppose […]

todayJuly 28, 2026 16

WHO WE ARE

We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.

We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!

Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!

 

listen with your app

This will close in 0 seconds