Blog horizontal

Background

National

Over 3,400 Don Die For Doad Crash In 2025 – FRSC

No less than 3,400 people don kpai for road accidents across Nigeria from January reach September 2025, na di Federal Road Safety Corps (FRSC) yarn dis one. According to Corps Marshal Shehu Mohammed, wey talk dis one for Abuja during di official launch of 2025 Ember Months Public Enlightenment Campaign, 3,433 people die and 22,162 people injure inside 6,858 reported crashes. Dem say driver wahala, like fatigue, overloading, carrying people […]

todayOctober 21, 2025 5

International

Ex-French President Sarkozy Don Land For Jail Over Corrupt Waka

Ex-French president Nicolas Sarkozy don become di first former head of European Union country to enter jail, as dem carry am go La Santé prison for Paris on Tuesday. Sarkozy, wey rule France from 2007 to 2012, don dey face serious wahala since court find am guilty last month say he try collect campaign money from late Libyan dictator Muammar Gaddafi. Even as dem carry am enter prison, di 70-year-old […]

todayOctober 21, 2025 5

Sports

Nottingham Forest Don Name Sean Dyche As Third Coach 2025-26

Di Aussie coach chop sack just few minutes afta Chelsea knack Forest 3–0 on Saturday afternoon. Di club no waste time as dem sharply bring in Dyche to try rescue di season wey don dey scatter. Postecoglou own short and bitter 39-day stay no produce single win inside eight matches for all competitions. Na serious wahala as di poor results drag Forest go relegation zone and make dia fans vex […]

todayOctober 21, 2025 6

Lagos

Lagos Pikin Dem Dey Compete For Inter-School Challenge

Pikin dem from different public primary schools for Lagos West jam for Methodist Primary School Hall, Oshodi, to compete for second stage of Sweet Thinkers Top 200 Academic Excellence Competition. Di contest test dem for Mathematics, English Language, and General Knowledge as part of plan wey wan promote better school work and make pikin dem like quality education again. Di organisers talk say di project dey follow Sustainable Development Goal […]

todayOctober 21, 2025 7

Lagos

Sanwo-Olu Don Open UNILAG Medical Research Centre

Lagos State Governor, Babajide Sanwo-Olu, on Monday, open Sir Kensington Adebutu Medical Research Centre for College of Medicine, University of Lagos to boost medical innovation and improve health for Nigeria and beyond. Sanwo-Olu call am “intellectual investment” and true philanthropy wey go help human capital development. The new centre go be global hub for medical research, make university fit solve serious health problems. The governor praise donor Sir Kensington Adebutu […]

todayOctober 21, 2025 4

Lagos

LASG Scatter N1bn Pension To 463 Retirees

Lagos State Government don scatter over N1bn pension to 463 retirees wey work for state civil service. N1,006,057,173.45 na di money wey dem put inside Retirement Savings Accounts for workers wey retire from civil service, local government, local council development areas, SUBEB, Teaching Service Commission, plus other state parastatals. For the 111th Retirement Bond Certificate Presentation for NECA Auditorium, Ikeja, Head of Service, Bode Agoro talk say dis show how […]

todayOctober 21, 2025 5

National

Petrol Na Di Biggest Thing Wey Nigeria Import As Dem Bring In 613.6 Million Litres For One Year

Between October 2024 and October 10, 2025, Nigerians use 613.62 million litres of petrol (wey people sabi as Premium Motor Spirit) for transport, light, and other house use. New data from Nigerian Midstream and Downstream Petroleum Regulatory Authority (NMDPRA) show say even with Dangote Refinery and local plants working, imported fuel still be di main source. Out of di total, 377.54 million litres come from import, while only 236.08 million […]

todayOctober 21, 2025 6

National

FRSC Dey Ready To Give Driver’s Licence Wey No Need Touch, Sharp Sharp

Federal Road Safety Corps (FRSC) don announce new contactless biometric system wey go make driver’s licence issuance fast and digital for Nigeria. Dis new system go remove delay and temporary licence wahala as e go allow people get their licence sharp sharp once dem capture dem biometric data. Corps Marshal Shehu Mohammed talk say di printing facility don upgrade to fit produce 15,000 licences daily and plan dey to clear […]

todayOctober 21, 2025 5

National

Senate Wan Make Mental Health Enter School Curriculum

Senate don call make mental health education join national school curriculum to help solve di wahala wey students and teachers dey face for mind and emotions across Nigeria. Dr. Ipalibo Banigo, wey be Chairman of Senate Health Committee, talk dis on Monday for mental health programme wey Mandate Health Empowerment Initiative organize for Abuja. Senator Banigo talk say mental health get strong connection with discipline and how well pikin dem […]

todayOctober 21, 2025 4

National

Flood Don Burst: Ogun Don Issue Alert, Dey Warn People Wey Dey Riverbank And Wetland Communities Make Dem Watch Body

Ogun State government don issue warning to people wey dey live for riverbank and wetland areas say make dem ready as Ogun River fit overflow between October 20 to November 3, 2025. Some of the areas wey go fit get wahala na Akute, Alagbole, Isheri, Magboro, Makogi, Orimerunmu, Iro, Kajola, and part of Abeokuta like Lafenwa, Enugada, Adedotun, Iberekodo, Akin-Olugbade, and Ago-Odo. Commissioner for Environment, Ola Oresanya, talk say the […]

todayOctober 21, 2025 4

WHO WE ARE

We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.

We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!

Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!

 

listen with your app