Blog horizontal

Background

Lagos

Lagos State Farmers Collobi FG Support To Boost Food Security

Federal Government don empower small-small farmers for Lagos State with farm inputs to help boost food production and improve food security for Nigeria. Di empowerment programme wey Federal Ministry of Agriculture and Food Security carry out happen for Agege, Lagos on Thursday, and dem give 68 farmers cooperatives farm materials. Agriculture Minister Abubakar Kyari, wey Dr Marcus Ogunbiyi represent, talk say di programme na part of Presido Bola Ahmed Tinubu […]

todayMarch 5, 2026 7

obodo oyinbo

First Rescue Flights Carry Stranded Israelis Back To Tel Aviv

First two flights wey carry Israelis wey dey stranded for abroad because of Middle East war don land for Tel Aviv on Thursday, after airspace close when United States and Israel launch strike against Iran. Di  flights land for Ben Gurion Airport, wey still remain closed for commercial flight operations, as first flight wey El Al Airlines operate come from Athens, while second flight wey Israir Airlines operate come from […]

todayMarch 5, 2026 6

Sports

WAFCON 2026 Fit Hold For July

Di 2026 edition of WAFCON 2026 fit move go July as uncertainty still dey around di original schedule. Di tournament suppose hold between March 17 and April 3 for Morocco, but preparation and organization wahala don raise doubt  whether competition go start as plan. Even though Confederation of African Football never officially talk anything, reports say dem don internally decide to postpone di tournament, and dem now dey consider July […]

todayMarch 5, 2026 5

obodo oyinbo

Iran Hit US Oil Tanker For Gulf – Reports

Iran state TV don yarn say dem fire missile on one United States oil tanker for Persian Gulf on Thursday, and di vessel dey catch fire for sea. Di Islamic Revolutionary Guard Corps talk say di strike happen for Northern Gulf, but independent sources never confirm di attack as tension still dey rise for di region. Di Guards still boast say dem don take full control of di Strait of […]

todayMarch 5, 2026 7

OBODO NAIJA

President Tinubu Give Order To Stop Airport Cashless Policy

Wi oga Presido, Bola Tinubu don order make dem immediately stop di cashless payment system wey dey operate for federal airports. Dis decision come out after meeting of di Federal Executive Council on Wednesday. According to Aviation Minister Festus Keyamo, plenty passengers dey miss dia flights because di system dey cause serious delay. And dat like dis Because of di suffer, suffer wey Nigerians dey face, di Presido say make […]

todayMarch 5, 2026 7

Sports

Arsenal Win, Man City Drop Points For Wednesday EPL Games

Arsenal don extend dia lead for top of premier leage table beating Brighton  1-kondo for AMEX Stadium on Wednesday. Brighton play sha, but Bukayo Saka goal give Arteta boys beta advantage after Man City go play 2-2 draw with Nottingham forest For first minute, David Raya almost spoil game as im give Carlos Baleba, but Gabriel rush save am. After 9 minute, Saka con bend small beta shot beating Brighton […]

todayMarch 5, 2026 5

obodo oyinbo

Mojtaba Khamenei Fit Take Over As Iran Supreme Leader

Say pikin of late Iranian leader Ali Khamenei, Mojtaba Khamenei, dey among di main people wey fit become new oga for Iran. Ahmad Khatami, one member of di Assembly of Experts, na im dey relate di mata to Iranian state media on Wednesday, say dem hope to vote “at di earliest opportunity” to choose di new leader. Other contenders include Alireza Arafi, Mohsen Araki, and Hassan Khomeini, wey fit also […]

todayMarch 5, 2026 8

Sports

Bayern Munich Eye Victor Osimhen To Replace Harry Kane

Bayern Munich don resume interest for Galatasaray striker Victor Osimhen, say dem need am if Harry Kane waka. Coach Vincent Kompany dey consider am because Kane dey attract Barcelona and other Premier League clubs. Kane don score 130 goals for 133 matches even though im never dey for Bayern for long. Since no offer don land yet, Bayern feel say Osimhen na di best replacement, if Kane move.

todayMarch 4, 2026 7

Sports

Atletico Madrid Stand Gidigba, Knock Barcelona Comot 4-3 For Copa Del Rey

Barcelona try dia best chase Atletico Madrid for Copa del Rey semi-final but God pass dem, losing 4-3 on aggregate. Marc Bernal score two goals and Raphinha score penalty, and still dem nor make am to di finals. Atletico hold strong, and now, go meet Real Sociedad or Athletic Club for di final. First leg, Barcelona don already lose 4-0, so e hard dem to do complete come back.

todayMarch 4, 2026 8

Lagos

Alcohol Companies Nor Gree For Sahcet Alcohol Ban

Workers of alcohol companies say dem go storm di National Agency for Food and Drug Administration and Control office for Lagos today to protest Federal Government ban on sachet alcohol and PET bottles wey small pass 200ml. Di protest, wey di Distillers and Blenders Association of Nigeria  dey organise, go start by 8:30am for Oshodi as dem say dem wan show dia anger over di decision. Dis one na di […]

todayMarch 4, 2026 11

WHO WE ARE

We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.

We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!

Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!

 

listen with your app