Blog horizontal

Background

obodo oyinbo

China Move Mehn To Guide Latin America Say Ameriaca Dey Misbehave

By: Esther Ayoola China Foreign Ministry don yarn again say dem no dey happy with wetin US dey do for Venezuela and dem ready join other countries make international law stand gidigba. Dem tuk say dem ready to join hand with countries for di region to protect peace for Latin America plus Caribbean. You sabi say, China don call on US make dem free Maduro sharp-sharp and stop dey topple […]

todayJanuary 6, 2026 9

Lagos

LSFRS Update GNI, Fire Scarra House, Church for Lagos

By: Esther Ayoola Say nor be small fire burn area yesterday for 15, Pipeline Road, off Ekoro Road, Abule Egba, Lagos, wey scarra one residential house plus small church for di area. Lagos Fire Service wey confamate di tori  say, dem receive distress call around 1pm. and sharp-sharp na so dem rush with  dia fire crews from Agege and Abesan station go fight di blaze. Controller General, Margaret Adeseye, tuk […]

todayJanuary 6, 2026 7

National

NNPP Clear Marras On Who Be Dia Party Leader

By: Esther Ayoola National Vice Chairmo of New Nigerian Pipo Party  for Northwest, Sani Danmasani, don reveal tuk say oga Govo of Kano state, Abba Yusuf, na be di real leader of di party, no be Rabiu Kwankwaso. Im sukili dis one for inside statement, say according to NNPP constitution, anybody wey be sitting governor and party member automatically be leader, and na why Abba Yusuf take get dat position […]

todayJanuary 6, 2026 10

Sports

Chelsea Carry Liam Rosenior E As New Head Coach

By: Esther Ayoola Chelsea don carry Liam Rosenior to con be dia new men head coach, say dem wan build strong team and return to top football. Di Club confamate dis report for dia official website, say Rosenior sign contract wey go run reach 2032, afta e do well for France with Strasbourg and carry dem enter Europe for first time in 19 years. Chelsea tuk say Rosenoir show beta […]

todayJanuary 6, 2026 9

National

APC National Secretary, Wike No Be Our Member

By: Esther Ayoola APC National Secretary, Ibrahim Abdullahi Basiru, tuk say former Governor Nyesom Wike no be member of APC, so e no get right to interfere for party affairs. E yarn dis one for official APC X page afta Wike warn am make e no touch Rivers politics. Basiru tuk say as National Secretary, e get duty to protect APC and all im members and structures. E add say […]

todayJanuary 6, 2026 13

National

Minister Of Information Declare Say Tinubu Reforms Wan Show Beta Workings

By: Esther Ayoola Information and National Orientation Minister, Mohammed Idris, tuk say dis year budget na to make sure President Bola Tinubu reform dem dey yield better result. Idris yarn dis one for one ogbonge paper, wey dem call “A Defining Moment for Nigeria: Why Staying the Course Matters.” E tuk say di budget na to support wetin dey work and make sure plenty Nigerians fit enjoy better life faster. […]

todayJanuary 6, 2026 10

National

Ondo Govo Ginger Im Mehn To Deliver Key Projects

By: Esther Ayoola Ondo State Govo, Lucky Aiyedatiwa, enter area oh dey ginger mehn for all ministries, departments and agencies say make dem show workings, deliver projects and programmes wey people dey expect. Him yarn dis one on Monday for Ondo First Working Day Prayer Meeting for 2026 for Governor’s Office, Akure. Governor Aiyedatiwa sha beg citizens make dem support government by dey patriotic and responsible.

todayJanuary 6, 2026 9

Lagos

Lagos Pastor Nor Show Face For Police Station Over Rape Case

By: Esther Ayoola Police say Senior Pastor of Mountain of Liberation and Miracles Ministries, Chris Okafor, no honour invitation wey dem give am to report on Monday by 10am for State CID, Panti, Lagos, over alleged rape and other offences. Police Public Relations Officer, Abimbola Adebisi, tuk on Sunday say di invitation na order from Commissioner of Police, Olohundare Jimoh, afta several complaints reach police. According to police, dem invite […]

todayJanuary 6, 2026 15

Sports

Anthony Joshua Dey Consider Quit Boxing

By Ebi Oboko Former world heavyweight champion Anthony Joshua say, like dis, dey plan to quit or to continue boxing. According to im uncle, Adedamola Joshua wey conversate dis marra give tori pipo, say, after di tragic car accident for Nigeria wey kill two of im close friends, Joshua tell im family say e wan stop while people still dey greet am. Di uncle tuk say di family sef dey […]

todayJanuary 6, 2026 18 3

Lagos

Governor Sanwo-Olu Do Give away for Lagos Military Veterans

By Ebi Oboko Lagos State Govo, Babajide Sanwo-Olu, don do give away with N100 million, four two-bedroom houses for Ajara, and two pick-up vehicles to Lagos Chapter of Nigerian Legion. Im tuk dis one on Monday during State Executive Council meeting for Lagos House, Ikeja, as part of the launch for 2026 Armed Forces Remembrance Day Emblem. Di Govo say, him dey do dis to remember fallen heroes wey serve […]

todayJanuary 6, 2026 14 1

WHO WE ARE

We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.

We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!

Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!

 

listen with your app