Blog horizontal

Background

Sport Yarns

FIFA Select 11 Man Team to Analyse Players and Teams For Award For 2026 World Cup

By : Jolayemi Olajide FIFA don announce 11-member Technical Study Group wey go analyse matches and decide winners of major individual awards for di 2026 World Cup. Dem unveil di panel on Monday during virtual media briefing ahead of di tournament wey go start next month for Estadio Azteca. Di group go dey led by FIFA Senior Football Expert, Pascal Zuberbühler, and e include big football names like Pablo Zabaleta, […]

todayMay 11, 2026 15 2

Sport Yarns

Chelsea Crew, Victor Moses Pay Curtesy visit to Oba Elegushi Palace for Lagos

By : Jolayemi Olajide Chelsea F.C. wow dia football fans for Lagos send a delegation do surprise visit Lagos on Sunday, and na Oba Saheed Ademola Elegushi for im palace. Say na Former Super Eagles star Victor Moses follow di delegation. According to Oba Elegushi, di visit make sense cause e go hellep connect football, culture and international friendship. Dis meeting show say Chelsea still get strong link with Nigeria […]

todayMay 11, 2026 15 2

obodo oyinbo

Macron Insist Say Make Colonial Masters Return Africa Stolen Artefacts

By: Esther Ayoola French Presido, Emmanuel Macron don declare say di plan to return African artworks wey dem bin thief during colonial time don become something wey nobody fit stop again. Macron yarn dis one for economic summit for Nairobi, and e remind people say e don promise since 2017 to help return di stolen works back to Africa. According to reports, France parliament just pass law wey go make […]

todayMay 11, 2026 18 2

Lagos

Lagos NMA Leadership Enter Gear 5, Suspending Dia Chairmo Saheed

By: Esther Ayoola Say like dis, na serious Leadership gbege dey inside Nigerian Medical Association, Lagos chapter, dat different groups dey claim leadership position. Dis one sef start on Monday few days afta national leadership konfam, Dr. Babajide Saheed as chairmo of di Lagos branch. One faction for di Lagos chapter later announce say dem don remove Saheed from office over alleged violation of di association constitution. According to di […]

todayMay 11, 2026 13

OBODO NAIJA

WAEC bring new mean to stop student from using sukili during exams

By: Jolayemi Olajide WAEC don announce new way, wey dem wan take fight exam malpractice and make examination process faster and more transparent for candidates across obodo Naija. Di exam body don launch one “examination malpractice quarter” for im website, where candidates wey get issues related to misconduct fit check dia status directly without delay. Head of WAEC Nigeria National Office, Dr Amos Dangut, naim announce di update on Monday […]

todayMay 11, 2026 11

OBODO NAIJA

JAMB Set 150 Cut-Off Mark for Universities, Polytechnics Get 100

By : Jolayemi Olajide Di Joint Admissions and Matriculation Board (JAMB) don announce cut say 150 go remain di official cut-off mark for university admission for 2026/27 academic session. JAMB tuk dis one on Monday during dia policy meeting wey sup for Abuja, after vice-chancellors and heads of tertiary institutions vote and agree on di new admission scores. According to JAMB, colleges of nursing go also use 150 as minimum […]

todayMay 11, 2026 9

Lagos

Lagos Council Beg Residents To Protect Public Property

By: Esther Ayoola Oga Works and Infrastructure Supervisor for Eredo Epe Local Council Development Area, Bayo Opetuga, don call on residents make dem protect public infrastructure for dia communities. Opetuga tuk dis one on Monday during inspection of projects wey di council execute for Eredo Epe area of Lagos State. E explain dat, when pipo protect gornment facilities, e dey always hellep preserve di gorment project stay longer. Di council […]

todayMay 11, 2026 13

National

Labour Party Finally Agree Say Obi Leaving Wunjure Dia Party

By: Esther Ayoola Labour Party finally don admit say di leaving of dia 2023 presidential candidate Peter Obi to oda party really create big space for inside di party. Labour Party National Publicity Secretary, Ken Asogwa, naim dey yarn dis one on Monday during one media sitdon tuk while reacting to Obi alliance with ADC-led coalition ahead of 2027 election. Asogwa say Obi na major force inside the party and […]

todayMay 11, 2026 12

Lagos

Lagos Gorment Close Eko Bridge For Repairs, Give Traffic Alert

By: Esther Ayoola Di Lagos State Gornment don announce emergency closure of di outbound lane of Eko Bridge for Lagos Island. According to Commissioner for Transportation, Oluwaseun Osiyemi, through statement wey dem wrap like moimoi, say di closure go start on Tuesday, May 12, 2026, for safety checks and repair work. E con sti add say, inward lane for Lagos Island go sti dey open for motorists to pass. Dem advise drivers wey dey use Apongbon–Ijora Olopa route make dem […]

todayMay 11, 2026 9

Sports

Nnadozie Shine As Brighton Do Comeback Magic, Shock Liverpool 3-2 Enter FA Cup Final

By: Esther Ayoola Super Falcons goalie, Nnadozie and Brighton & Hove Albion surprise fans do ogbonge comeback, beating Liverpool 3-2 for Women FA Cup semi-final. Liverpool start well, going 2 goal up early for di match with quick goals for St Helens. Before halftime, Brighton reduce di score as Manuela Vanegas score to bring hope. For second half, Madison Haley equalise and dem complete di comeback to enter dem first […]

todayMay 11, 2026 12

WHO WE ARE

We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.

We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!

Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!

 

listen with your app

This will close in 0 seconds