Blog horizontal

Background

Sports

Super Eagle Legend Babangida Sama Message Give Coach Chelle To Arrange Beta Team For AFCON

By: Rilwan Agbomeji Former Naija winger, Tijani Babangida don tier better warning, role am, package am, give wi Super Eagles coach Eric Chelle say, make e no base di team only on striker Victor Osimhen for di 2025 Africa Cup of Nations for Morocco. Na for tuk tuk session with tori pipo on Wednesday, Babangida dey talk dis one,  say e dey risky as Naija dey depend too much on […]

todayDecember 11, 2025 11

International

Us Drag Mata Go Seize Oil Tanker Near Venezuela

By: Rilwan Agbomeji Dem say trouble dey sleep yanga dey go wake am, US don seize one big oil tanker wey dey near venezuela,  na oga  Donald Trump dey yarn dis one on Wednesday, and dis one don dey make tension with caracas rise. Untop yanings with tori pipo for im yard, Trump yarn say na di biggest tanker wey dem don ever seize, but e no give any more […]

todayDecember 11, 2025 7

National

Fubara Explain Why Im Move To Di APC

By: Rilwan Agbomeji Rivers State Govo, Siminalayi Fubara, don explain why im cartapot enter di All Progressives Congress, say, im dey carry plenty personal and political wahala because e refuse tell im own side of di tori wey dey cause gbagan for di state. Di governor yarn dis one as e commission di newly expanded Ahoada–Omoku Road for Rivers West, road wey Julius Berger build and wey be part of […]

todayDecember 11, 2025 6

National

Tinubu Open Plan Say Im Wan Use Sea Resources Take Create Jobs

By: Rilwan Agbomeji Wi oga Presido Bola Ahmed Tinubu don drop mata again say contri pipo go join bodi use sea and mami water resources take boost economy, create work, and bring long-term progress. Vice presido Kashim Shettima talk di matt for presidential villa during meeting with senior executive course 47 from national institute for policy and strategic studies. Tinubu direct all ministries and agencies make dem check NIPSS report […]

todayDecember 11, 2025 6 1

National

President Tinubu Ginger Area Say Make Forest Guards Dey Carry Gun

By: Rilwan Agbomeji To deal with all di jaguda bois for inside di obodo Naija, wi oga Presido Bola Tinubu don vex oh, approve forest bodi guards across Naija say dem dey carry kalachi as part of new plan to fight banditry, kidnapping and illegal mining for rural areas. Di announcement come afta Federal Executive Council meeting for Abuja on Wednesday, where Tinubu talk say security matter don reach level […]

todayDecember 11, 2025 13 1

Lagos

Two Pipo Kpai For Cult Wahala For Ajah, Lagos

By: Rilwan Agbomeji Unto wahala report for Lagos, say two people, wey dem never fit get name na kpai for  suspected cult warling warling for Ajah area, Lagos state. Kofam aproko gather say, di incident happen for Tuesday night. Dem talk say di attackers enter one crowded area near Ikota complex, come start to dey shoot anyhow. Di shooting make plenty people for community and market run for safety, cause […]

todayDecember 11, 2025 9

National

Senate Argue About Di Removal Of Police Escort

By: Rilwan Agbomeji Na beta agument shelle for di Nigeria senate on Wednesday,  say  Senator Abdul Ningi cry out as dem collect im escort afta Presido Tinubu order make dem withdraw police from VIPs, while many ministers, big men and entertainers still dey move with police. Ningi ask why di directive no dey affect everybody and say National Assembly no suppose be di only pipo to suffer change. As di […]

todayDecember 10, 2025 10 1

Sports

Heartland Coachie Amuneke Vow To Show Sunshine Stars Peper For Akure

By: Rilwan Agbomeji Di fight for promotion don dey heat up for wi national league, say heartland technical adviser, Emmanuel Amuneke don yarn full ground say im team go put body make dem win against sunshine stars. Di naze millionaires dey ready for Nigeria National League, NNL, matchday five wey go hold for Akure today Wednesday. Last weekend, Heartland beat Inter Lagos 3-2 for dan Anyiam Stadium, Owerri. Amuneke dey […]

todayDecember 10, 2025 12

International

Australia Cut Rope For Under-16s Say Make Dem Comot Social Media

By: Rilwan Agbomeji Chai nor be small tin, say Australia gorment don carry beta fight wey get odour enter social media, say dem nor wan see any of dia 16 year old pikins for social media, Facebook, Instagram, Youtube, and X on Wednesday. According to di Australian Gornment say dem wan take back di power from di tech sharks and dem dat, dem dey spoil dia childrensis for dem. Dem […]

todayDecember 10, 2025 16

National

PDP National Chairmo Turaki Confamate 29 Chairmen Across States

By: Rilwan Agbomeji Di Pipos Democratic Parti  National Chairmo,  Tanimu Turaki (SAN)  don wia long nika, with long wire clear di air say, nothing like faction, nor divide for inside di parti,  say PDP still be one house, and dat 29 state chairmen tanda gallant dey await confirmation to work. Turaki dish di tori live for Abuja on Wednesday during PDP state chairmen meeting, where 29 land physically for screening. […]

todayDecember 10, 2025 9

WHO WE ARE

We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.

We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!

Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!

 

listen with your app