By: Esther Ayoola
Presido Donald Trump of di United States don withdraw Canada invitation to join im newly launched Board of Peace.
Di move happen hours afta Trump formally unveil di board and days afta Canadian Prime Minister Mark Carney deliver speech for World Economic Forum, Davos 2026.
For him speech, Carney praise middle powers and criticize powerful countries wey dey use economic integration as tool of coercion.
According to report, Trump decision sef na based on wetin Carney tuk for Davos wey nor sweet am, and dis mata don dey spark global reaction.