Blog horizontal

Background

Sports

NFF Don Tell Clubs Wey Get Debt Make Dem Pay Sharp-Sharp Or Face Sanction!

Naija Football Federation (NFF) Players Status and Arbitration Committee don send strong warning to NNL clubs wey still dey owe players, make dem clear their debts sharp-sharp or wahala go land. Di warning show face for one letter wey NNL Chief Operating Officer, Danlami Alanana, send give di clubs ahead of di 2025/26 football season wey wan start. The letter talk say:"We send una warm greetings from the Chairman, Board […]

todaySeptember 11, 2025 9

Sports

DR Congo Fans Scatter Stadium After Dem Chop Beating from Senegal

Football fans for DR Congo lose control Tuesday evening as dem run mad and scatter parts of Stade des Martyrs for Kinshasa after their team chop 3-2 loss from Senegal for 2026 World Cup qualifier. Di 80,000-capacity stadium full to the brim as di Leopards dey chase one historic win wey for push dem closer to qualify for next year World Cup, but as hope scatter, everywhere burst. Hope bin […]

todaySeptember 11, 2025 24

Local

Ogudu–Ifako Bridge Repair: LASTMA Hail Lagos People for Their Patience and Cooperation

The Lagos State Traffic Management Authority (LASTMA) don thank residents for their patience and cooperation as road diversion still dey happen because of repair works for Ogudu–Ifako Bridge corridor. For statement wey come out on Wednesday, LASTMA General Manager, Mr. Olalekan Bakare-Oki, salute Lagos drivers and commuters for the sacrifice and endurance wey dem don show since the project start. He talk say this kind resilience na wetin dey show […]

todaySeptember 11, 2025 7

Local

Police Dey Investigate the Death of Two Men wey dem dump for LASU – Igando canal

The Lagos State Command don launch investigation for the wicked killing of two young men wey dem find their body inside canal for LASU – Igando Road, Iba area for Lagos. Dem discover the dead bodies early Tuesday morning, where their hands bin dey tied for back, with blue trash bags wey tight well well around their necks, this make people dey suspect say dem don torture and suffocate the […]

todaySeptember 11, 2025 22

Local

FG Wan Link Lagos-Calabar, Sokoto-Badagry Highways With Africa First Underwater Tunnel

Federal Government don announce say dem get plans to build wetin fit become Africa first underwater tunnel, and e go connect Lagos-Calabar road and Sokoto-Badagry highway, the two major highways. Minister of Works, David Umahi, talk dis one during inspection wey happen for Lagos on Wednesday. According to am, di tunnel go run for 2.9 kilometres, start from Ahmadu Bello Way reach Snake Island, and continue go Badagry. “Our tunnel […]

todaySeptember 11, 2025 16

National

Nigerian Doctors Don Declare 5-Day Nationwide Warning Strike

National Association of Resident Doctors (NARD) don announce say dem go begin five-day warning strike from Friday, 12th of September 2025, to take press for their demands wey government never answer since. Dis one follow statement wey dem release on Thursday, as General Secretary of Resident Doctors for Federal Capital Territory Administration, Agbor Affiong, confirm the news. According to the statement, dem reach di decision after their online National Executive […]

todaySeptember 11, 2025 8

Lagos

“Lagos NOA Don Start Two-Week Campaign”

National Orientation Agency (NOA), Lagos State don kick off one two-week campaign wey dey aim to wake citizens mind make dem sabi government policy, national identity, safety, values, and development. Di State Director of NOA, Dr. Mustafa Adedeji Tukur, wey yarn dis one for press conference wey dem do for di agency headquarters for Dopemu, talk say as part of di program, dem go waka go schools, motor parks, markets, […]

todaySeptember 11, 2025 10

Lagos

Police Don Grab Fake ‘Obi Of Lagos’, Jam Lock Him Palace!

Lagos Police don carry one 65-year-old man wey talk say na him be “Obi of Lagos” plus three of him padi dem on Wednesday. The suspect, Engr. Chibuike Azubike from Obodoukwu Ancient Kingdom for Imo State, na im dem hold together with Chief Chibuzor Ani, 57; Chief Martins Nwaodika, 65; and Mr. Ikechukwu Franklin Nnadi, 41. Police talk say dem gather correct intel wey show say di group don plan […]

todaySeptember 11, 2025 8

Lagos

Lagos People Don Vex Scatter Over Blackout, Storm Ikeja Electric Head-on!

Residents wey dey Governor’s Road, Ikotun for Alimosho Local Government, Lagos don face Ikeja Electric serious gbas gbos over power wahala wey don hold ground for over 10 days straight. Di chairman of Igando Peace Estate Phase IV CDA, Emmanuel Joseph, wey speak on top di matter for residents, para say di blackout don make life hard for both families and business people for di area, scatter daily activities, and […]

todaySeptember 11, 2025 9

Sports

2026 FIFA World Cup: Bolivia Don knack Playoff, Just Dey Wait Who Go Show From CAF And Other Confederations!

Bolivia don officially knack im ticket go intercontinental playoffs for 2026 FIFA World Cup after dem finish seventh for CONMEBOL qualifiers. Di South American country gather 20 points from 18 matches, grab di only playoff spot wey di region get. Bolivia go now jam opponent wey go come from Africa plus other four Confederations. But for Africa side, their own representative go come from one small playoff wey go hold […]

todaySeptember 11, 2025 12

WHO WE ARE

We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.

We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!

Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!

 

listen with your app