Blog horizontal

Background

Sports

PSG And Bayern Play Goal Fest For Paris With 9 Goals For dia First Leg UCL Semis

By: Esther Ayoola Na serious Champions League semi-final first leg wey PSG and Bayern Munich play for Parc des Princes, PSG sha win 5-4 for di mad, high-scoring encounter. Kvaratskhelia and Ousmane Dembele score two goals each, while Harry Kane penalty naim give Bayern early lead. Di match just full everywia as Joao Neves, Michael Olise, Dayot Upamecano and Luis Diaz too enter di scoresheet. Now PSG get small advantage […]

todayApril 29, 2026 12

obodo oyinbo

Israel And Lebanon Clash Worsen As Air Strike Kpai, Kpai Rescue Workers

By: Esther Ayoola Israel military don carry out some wicked air strikes for southern Lebanon, even reach areas wey dem call “Yellow Line”. According to report, One of di strikes kpai five pipo, including three civil defence workers wey dey try rescue pipo from earlier attack, and two Lebanese soldiers sti get wunjury. Lebanon Prime Minister Nawaf Salam don condemn di attack, call am war crime, and say dem go […]

todayApril 29, 2026 12

obodo oyinbo

King Charles Preach Western Unity For US Congress

By: Esther Ayoola Britain king, King Charles III, don go scatta mouth for US Congress, say make America dey careful, even with di wahala for Iran and Ukraine. Say dem nor suppose leave dia Western allies. Di Senior King porporly dis mata for di congress without touching Donald Trump and Keir Starmer gbege, insisting say US and UK partnership strong like di wall of Jerico.

todayApril 29, 2026 12

National

Datti Baba-Ahmed Dump Labour Party, Say Im Dey Join PRP

By: Esther Ayoola Labour Party 2023 vice-presidential candidate, Yusuf Datti Baba-Ahmed, don decide say im dey comot Labour party to join Peoples Redemption Party (PRP). E yarn dis one for TV sit down tuk on Tuesday, where e explain say problem wan finish  Labour Party. According to am, di party don shift from wetin dem first stand for, na why e decide to comot.

todayApril 29, 2026 12

National

Senate Push New Law To Raise Police Funding

By: Esther Ayoola Senate don begin consider bill wey go cancel and re-enact Naija Police Trust Fund Act for 2025 to improve how police go dey receive dia  money. Senate Leader, Senator Opeyemi Bamidele, naim lead di tuk, say di bill go change things for di police. Say like dis, di Naija police dey suffer serious lack of funding and e dey affect how dem dey perform. Dem tuk say, […]

todayApril 29, 2026 13

National

Tinubu Celebrate Mike Adenuga @73, Praise Am As Naija Business Heavyweight

By: Esther Ayoola President Bola Tinubu don give beta salutate to senior  businessman and philanthropist Dr Mike Adenuga as im  turn 73 years. Tinubu tuk dis tuk inside one seven paragraph statement, say Adenuga na real man wey sabi, wey don put correct mark for Nigerian business world. E tuk say, through Globacom, Conoil, real estate, banking and oil and gas, Adenuga don show excellence for many sectors. Tinubu wish […]

todayApril 29, 2026 16

National

President Tinubu Do Close Door Meeting Plateau Stakeholders For Abuja

By: Esther Ayoola Wi oga Presido, Bola Tinubu on Tuesday don go hold one ogbonge closed-door meeting with Plateau State stakeholders for Presidential Villa, Abuja. Tatafo pipo dey suggest say na security mata dem discuss based on wetin happun for palm Sunday for Plateau state. Dem tuk for several hours, but nobody release wetin dem discuss to di public. However, say, dis meeting na follow-up to Tinubu recent visit to […]

todayApril 29, 2026 27

south west

Makinde Meet Peter Obi For Ibadan To Discuss 2027 Coalition Plan

By: Esther Ayoola Oyo state govo Seyi Makinde and di 2023 labour party presidential candidate don run anoda closed door meeting. Say di Oyo state Govo host Peter Obi with im delegation for im Office for Agodi, Ibadan on Tuesday. Speaking with tori pipo afta di meeting, Obi say di visit na part of ongoing tuks and consultation about coalition wey dem dey plan run for 2027 general elections. Dis […]

todayApril 29, 2026 16

Lagos

Federal High Court Launch Digital System For Lagos Division

By: Esther Ayoola Federal High Court for Lagos Division don launch e-filing system wey go make court work go digital, instead of using paper. Untop yarnings with tori pipo for court on Tuesday, Chief Judge, John Tsoho explain di new system, say e go improve efficiency, transparency, and make access to justice easier. E also tuk say di change na something wey  pass due process and dat di old manual […]

todayApril 29, 2026 10

Lagos

Lagos Assembly Back Tinubu Second Term, Praise Subsidy Removal

By: Esther Ayoola Members of Lagos State House of Assembly like dis, don join hand dey back oga Presido, Bola Tinubu make he run for second term as Presido. Dem take di decision for Tuesday plenary afta Ladi Ajomale from Oshodi/Isolo Constituency II move di motion. Ajomale spread bodi explain di Tinubu administration important reforms, like student loan scheme, removal of fuel subsidy, and big infrastructure projects like Lagos Coastal […]

todayApril 29, 2026 10

WHO WE ARE

We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.

We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!

Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!

 

listen with your app

This will close in 0 seconds