Blog horizontal

Background

Lagos

Lagos Apc Shake Opposition With Talks Not To Disturb Tinubu

By: Rilwan Agbomeji Lagos branch of di All Progressives Congress (APC) dey vex carry matter for head dat make opposition no dey disturb president Bola Tinubu with “fake politicking and fake wahala” as 2027 dey waka  don near. APC lagos tuk tuk, seye oladejo,  ni dey yarn dis one dey  talk say dis time no be for confused coalitions or any political experiments. Di warning follow afta ADC yarn peter […]

todayDecember 9, 2025 5

Lagos

Lagos Govment Say No Structures Wey Dey Under High-Tension

By: Rilwan Agbomeji Lagos State government tire shirt oh say say dem go begin remove any building or structure wey people build under high-tension wire because e dey dangerous for residents. Na for inspection waka wey dem go do for Third Mainland Bridge area, Special Adviser Olajide Babatunde  yarn dis one as im see plenty shanty and illegal structures wey no suppose dey di 50-metre right-of-way, im belle even turn […]

todayDecember 9, 2025 9 2

National

Senate Say Yes To Tinubu, Army Benin Republic Waka

By: Rilwan Agbomeji Wi Senate sharpaly do gree for wi oga Presido Bola Tinubu to carry Nigerian troops enter Republic of Benin, dem nor even stress am or do yanga say dem wan help restore peace. Oga senate Presido Godswill Akpabio announce di approval on Tuesday during plenary afta dem check Tinubu letter for Committee of di Whole according to Section 5, Part II of Constitution. Lawmakers join bodi vote,  […]

todayDecember 9, 2025 4

Niger Delta

Obi: Naija No Suppose Dey Poor, God Already Bless Us

By: Esther Ayoola Presidential candidate of Labour Paty and before before Anambra state govo, Peter Obi, don tuk say Naija no suppose dey poor, no be poverty capital of world, because God don bless us with plenty resources  wey dey under our foot and wey dey for sky. E yarn this mata for one book launch for inside Abuja wey dey talk about the ogoni experience and how di people […]

todayDecember 9, 2025 6

National

President Tinubu Clear Nigerian Aprokos To Stop Fake News

By: Esther Ayoola Wi oga presido, Bola Tinubu, unto doings don  tell Nigerians make dem try to dey talk truth all the time  and stop to spread fake news. He talk this through  information Minister Mohammed Idris  during the launch of the “my nigeria, my responsibility” program for inside the obodo Nigeria. Idris  say,  Nigerians must promote correct information and show the world the countri progress, peace, and national values.

todayDecember 9, 2025 7

National

Remi Tinubu Hail Titilola Adeleke As She Mark 60 Years

By: Esther Ayoola For Abuja,  after all the drama for Osun state between the dancing senator and first lady, Oluremi Tinubu,  madam first lady don wire birth messgae give Adeleke wife, Titilola Adeleke, as she clock 60. Na for statement  wey dem wrap like moimoi  drop for her x page, mama Remi hail madam Adeleke for the serious work wey she dey do to uplift Osun people through the renewed […]

todayDecember 9, 2025 6

National

Tinubu Wire Letter Give Senate Say Im Wan Send Army Go Benin Republic

By: Alice Iduh Wi oga Presido Bola Tinubu don write Senate say,  make dem allow am send Naija soldiers go Republic of Benin as di country ask for help after coup wahala wey bust on sunday. Oga Senate Presido, Godswill Akpabio, read di letter for plenary, and Tinubu talk say na section 5(5) of di 1999 Constitution give am power to seek dis kind approval. Tinubu yarn say Benin beg […]

todayDecember 9, 2025 6

National

Ecowas Declare Emergency For West Africa Sake Of Security Wahala

By: Alice Iduh Di Economic Community of West African States, ECOWAS, Ecowas don provoke oh, declare state of emergency for all West Africa say region political and security wahala don tire dem. Na di Commission Presido, Omar Touray, dey yan dis one  on Tuesday for Abuja during di 55th Mediation and Security Council meeting. Touray tell im  ministers and diplomats say recent gbege show say dem need serious thinking about […]

todayDecember 9, 2025 22 1

Sports

Mbappe Wunjury Shake Real Madrid Ahead City Clash

By: Alice Iduh Real madrid french superstar kylian mbappe no show for training on tuesday as them dey prepare for big champions league clash against manchester city on wednesday. According to report, di 26-year-old striker weh don score 25 goals for 21 matches this season, break him finger for la liga match against celta vigo on sunday and e get other wahala wey dem sti dey treat for sick bed. […]

todayDecember 9, 2025 4

obodo oyinbo

….Russian Military Plane Crash, 7 Dey Onboard

By: Alice Iduh Russian defence ministry don yanyanpu update say dia  military plane don crash for ivanovo region tuesday. Di an-22 transport plane carry seven people, but nobody sabi if dem survive or not. Di crash happen for one bush for the area, and like this like this, authorities don enter area with dia fork and knife search for the team. Investigation don start as di whole country dey wait […]

todayDecember 9, 2025 6

WHO WE ARE

We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.

We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!

Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!

 

listen with your app