Blog horizontal

Background

Sports

Quadri Aruna Get Tough Opponents For 2026 ITTF World Cup In Macao

By: Esther Ayoola Say Quadri Aruna gat play strong match and gat ready for 2026 ITTF World Cup wey go shelle for Macao, China from March 30 reach April 5. Dis year tournament get special meaning as International Table Tennis Federation dey celebrate 100 years, with 48 men and 48 women dey compete for Evans and Hammarlund Cups. Aruna sti be di only African wey don reach World Cup quarterfinal […]

todayMarch 30, 2026 6

Sports

Tottenham Hotspur Sack Igor Tudor Afta 7 Games

By: Esther Ayoola Tottenham Hotspur don comot dia coachie Igor Tudor afta di both of dem agree to terminate im contract Asap. Tudor manage dem only for seven matches, lose five, wey make Spurs dey struggle and just one point above relegation zone for Premier League. Dem also don drop out from Champions League race as results no dey favor dem at all. Club tuk say na mutual agreement, but […]

todayMarch 30, 2026 3

Sports

CAF Increase Africa Cup Of Nations To 28 Teams

By: Esther Ayoola CAF Presido, Patrice Motsepe, say like dis now, say dem wan increase di Africa Cup of Nations teams from 24 to 28 wey go dey play di AFCON. E tuk dis one for press conference on Sunday afta CAF executive committee meeting for Africa, say di change na to turn Africa football to  world-class football. Motsepe nor explain how di tournament go fit take di extra four […]

todayMarch 30, 2026 3

Sports

NPFL Match Day 32, Niger, Ikorodu, Bayelsa, Rivers Collobi Big Wins

By: Esther Ayoola Na correct football action happen for NPFL Match Day 32 on Sunday. Niger Tornadoes knack Wikki Tourists 2-0, while Ikorodu City shock Warri Wolves 4-3. Bayelsa United crush Kano Pillars 4-1, and Rivers United waka pass Kun Khalifat 4-2. Some games end draw, like El-Kanemi Warriors 1-1 Remo Stars, Barau FC 0-0 Katsina United, and Bendel Insurance 2-2 Plateau United.

todayMarch 30, 2026 3

Sports

Ikorodu City FC Survive Late Comback, Beat Warri Wolves 4–3

By: Esther Ayoola Ikorodu City FC collobi beta 4–3 winners against Warri Wolves FC for NPFL Match Day 32 putting pressure for di title race. Abayomi Ayodeji nah im open di scoring for 8th minute, Joseph Arumala add another, but Warri Wolves begin chase di game very early. Ikorodu City sti score own goal and Tosin Oyedokun make am 4–2 before Wolves finish with late goal for 94th minute. Coach […]

todayMarch 30, 2026 2

obodo oyinbo

Former Venezuela Presido Maduro Thank Fans, Do First Post From Prison

By: Esther Ayoola Former Venezuela presido, Nicolas Maduro and im wife Cilia Flores don tuk for di first time for U.S prison say dem dey strong, calm, and dey pray inside Brooklyn prison. For a message wey dem share for Maduro’s X account, dem thank supporters for prayers and dia support. News source close to Venezuelan gornment say, Maduro dey read Bible every day, and im fellow prisoners sti dey […]

todayMarch 30, 2026 5

obodo oyinbo

Trump Say Im Go Grab Iran Oil As Gulf Leaders Dey Try Cool Tension

By: Esther Ayoola Donald Trump don change am for Iran say, e wan “take di oil for Iran,” as Iran dey accuse US say, dem dey plan ground attack, while peace tuk dey go on. Say Iran attack one power and water plant, kpai one Indian worker, and say, Gulf countries dey intercept drones and missiles every day. US and Israel hit one petrochemical plant for Tabriz, cut power for […]

todayMarch 30, 2026 3

National

SSANU Blow Hot, Give FG One-Month Ultimatum To Settle University Wahala

By: Esther Ayoola Senior Staff Association of Nigerian Universities (SSANU) don warn Federal Gornment say dem no go gree again if dem continue to delay agreement on labour mata. Dis dey sup for meeting wey dem hold for Ekiti State University from March 26 to 27, 2026, dem say, di slow tuk, tuk between gornment and non-teaching staff dey very bad. SSANU presido, Muhammad Ibrahim, in fact say, plenty tuks […]

todayMarch 30, 2026 1

WHO WE ARE

We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.

We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!

Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!

 

listen with your app