Blog masonry

Background

Lagos

Lagos Gornment Explain How Heavy Rain Take Wound Lagos Roads

By: Esther Daniel Lagos State Public Works Corporation don beg residents make dem get patience as di long rainy season don cause serious flood and spoil many roads and public facilities for different parts of di state. Di agency tok say di bad roads don make movement hard for motorists, commuters and other residents, but dem dey work round the clock to repair roads and make dem safe for use. General Manager Tokunbo Ajanaku explain say di heavy rainfall wey […]

todayJuly 17, 2026 21

Sports

Tobi Amusan Land Scotland Camp, Eye Third Commonwealth Gold

By: Yusuf Abuh World record holder Tobi Amusan don join Team Nigeria training camp for Aberdeen, Scotland, as athletes dey prepare for the 2026 Commonwealth Games for Glasgow. Di women 100m hurdles champion join di team after another strong season for Diamond League, where she don secure place for di final event for Brussels, Belgium. Amusan go be one of Nigeria biggest medal hopes for di games as she dey target her third straight Commonwealth Games gold medal for di […]

todayJuly 17, 2026 22

obodo oyinbo

World Energy Oga, Birol Fry Mouth On How Middle East War Fit Spoil Things

By: Yusuf Abuh Di head of International Energy Agency, Fatih Birol, don warn say global energy security fit face serious threat if US-Iran tensions no reduce and oil flow through Strait of Hormuz no improve. Birol put for statement say di world need to worry about oil supply if di situation no change in di next few weeks. His warning come as US attacks on Iran continue, while Tehran dey respond with missile and drone strikes on some American allies […]

todayJuly 17, 2026 16

OBODO NAIJA

Police Wire Call To Nigerians Say Make Everybody Surrender Dia Illegal Tools 

By: Yusuf Abuh Inspector-General of Police, Olatunji Disu, don announce say Nigeria Police don begin nationwide operation to recover illegal guns ahead of di 2027 general elections. Disu yarn dis one on Thursday for Force Headquarters, Abuja, when e receive delegation from di National Centre for di Control of Small Arms and Light Weapons, wey retired Deputy Inspector-General of Police Johnson Kokumo lead come im office  . According to di IGP, di operation go become more serious as election dey […]

todayJuly 17, 2026 10

OBODO NAIJA

How Shettima Take Collect APC VP Ticket

By: Yusuf Abuh Wi oga Presido Bola Tinubu don present Vice Presido, Kashim Shettima with official sabificate to konfam am as APC vice-presidential candidate for di 2027 general election. Tinubu give Shettima di paper during small ceremony on Thursday for im office inside State House, Abuja. Di State House media office release 45-second video wey showing how Shettima enter Tinubu office before e receive di certificate. Dis one sef dey hapun few days after APC submit Tinubu and Shettima nomination […]

todayJuly 17, 2026 18

Lagos

Lagos Deploys Swamp Buggy To Fight Flooding For Ogombo Communities

By: Yusuf Abuh Lagos State Gornment don send swamp buggy go Ogombo canal for Eti-Osa Local Government Area to help reduce flooding caused by heavy rainfall across parts of di state. Commissioner for Environment and Water Resources, Tokunbo Wahab, reveal dis on Thursday through him X handle after inspecting flood-affected areas for Eti-Osa and Ibeju-Lekki. E explain say di machine don start clearing and removing dirt from di drainage channel to allow water flow better. Wahab add say di work […]

todayJuly 17, 2026 22

Lagos

Sanwo-Olu Promise Better Drainage System for Lekki Residents

Lagos State Govo, Babajide Sanwo-Olu, don promise say im gornment go increase drainage work to make water flow better and reduce flooding for different parts of Lagos. Baba Govo tuk dis one on Wednesday after e inspect communities wey flood dey disturb for Chevron Drive, Ibeju-Lekki, and other areas dem. Di govo promise say government go increase dredging, excavation and drainage expansion work for di affected areas so water go flow wella. He also blame residents say na dem dey […]

todayJuly 16, 2026 16

obodo oyinbo

Orphanage Home Catch Fire As Heatwave Scatter Algeria

According to authorities for Inside Algeria, on Thursday, at least 11 pipo, including childrensis, don kpai after serious fire burn one orphanage for Mohammadia, one area for Algeria capital, Algiers. Dis badness happen as di country dey battle severe heatwave wey don cause hundreds of fire outbreaks. According to one resident, Abdessalam Merrah, he talk say around 3 a.m. dem hear fire engines and childrensis wey dey scream inside di orphanage home, say dem try to hellep some but later […]

todayJuly 16, 2026 22

Sports

Messi Pass Yamal On Top World Cup Dribble Chart

Argentina captain Lionel Messi don climb reach number one for players wey don complete di highest successful dribbles for di ongoing FIFA World Cup, as e don overtake Spain wonderkid Lamine Yamal. Messi achieve dis record for Argentina dramatic 2-1 comeback win over England for Wednesday World Cup semi-final with nine successful dribbles and two assists. According to official FIFA World Cup statistics, di 39-year-old don record 24 successful dribbles, pass Yamal wey get 22. Brazil star Vinicius Junior dey […]

todayJuly 16, 2026 37

WHO WE ARE

We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.

We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!

Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!

 

listen with your app

This will close in 0 seconds