Blog masonry

Background

Lagos

Lagos Gorment Promise To Deliver Ogbonge Security For 2026 Lagos Fanti Carnival

Lagos State Gornment say, like dis now dem dey expect nothing less than 40,000 tourists and pipo wey go participate for di 2026 Lagos Fanti Carnival. Madam Commissioner for Tourism, Arts and Culture, Toke Benson-Awoyinka, na im dey yarn dis one for news tuk on Tuesday. Madam Commissioner say security go mount every wia for di event wey go hold on April 6, 2026, for Tafawa Balewa Square (TBS), Lagos. Madam Toke say, di carnival go show Lagos rich culture, […]

todayMarch 25, 2026 21

Lagos

How FG Wan Rub Mind With Private Business To Boost Education

Naija Education Minister, Dr Tunji Alausa, like dis na, dey look for serious business pipo to hellep fix education through di Nigeria Education Sector Renewal Initiative (NESRI). Oga Education minister yan dis one for roundtable breakfast tuk tuk wey im do with stakeholders and top business pipo for Lagos. Alausa say, di new move go bring beta management to wi schools, and e go hellep Naija schools compete with resof di world. Alausa add say dem go increase Technical and […]

todayMarch 25, 2026 23

Lagos

IGP Arrange New Police Commissioner For Lagos

Ogbonge report from police headquarters Abuja, say Lagos state don get new Commissioner of Police after dem promote some senior officers. According to oga inspector general of police Olatunji Disu, CP Fatai Tijani go now be Lagos police commissioner, taking over from CP Olohundare Moshood Jimoh wey don become Assistant Inspector-General of Police. Say AIG Jimoh na im go dey  lead Zone 2 Command wey cover Lagos and Ogun states. For di new commissioner of police of lagos, CP Tijani, […]

todayMarch 25, 2026 24

Lagos

FG Open Online Package For Importers To Reduce Trade Wahala

Federal Gornment on Tuesday for Apapa, Lagos, officially don launch National Single Window project, dat is ogbonge online registration for importers. Minister of Finance, Wale Edun, na im dey ground run di parole. Edun explain say dem dey do am to reduce plenty katakata for trade, and make am easy for importers and exporters to do business.

todayMarch 25, 2026 16

Sports

Super Eagles Open Antalya Camp Today Ahead Friendly Vs Iran, Jordan

By: Esther Ayoola Say like dis di Super Eagles don open camp for Antalya, Turkey today, Tuesday, for dia international friendly matches against Iran and Jordan, According to dia media tuk, tuk, Promise Efoghe, Head coach Éric Chelle call 23 players to join di camp so dat dem fit prepare well for di games. Coaches and officials don already land Istanbul, Turkey, and di players go start enter later today. Di team go play Iran first on Friday for di […]

todayMarch 24, 2026 24

obodo oyinbo

US Airstrike Kpai 15 Iraq PMF Fighters

By: Esther Ayoola US airstrike don go kpai 15 members of Iraq paramilitary group wey dem dey call Popular Mobilisation Forces, including one senior commander for Anbar area. PMF tuk say di attack na serious violation of Iraq sovereignty and e no show respect for di country at all. Dem also say di action no follow international law or humanitarian rules. Dem come beg Iraq political leaders make dem stand strong to protect di country sovereignty and stop dis kind […]

todayMarch 24, 2026 16

National

Abubakar Malami Accuse EFCC Of Political Oppression

By: Esther Ayoola Former Attorney General Abubakar Malami on Monday for Abuja don accuse Economic and Financial Crimes Commission say dem dey use political intimidation afta dem raid im house. EFCC operatives say dem act based on court order wey grant interim forfeiture, and na why dem go mark di property. For one viral video wey surface same Monday, Malami question di officers and ask dem to show di legal paper wey allow di operation. Im say di raid nor […]

todayMarch 24, 2026 15

Sports

Fans Drag FIFA Go EU Court Over Crazy 2026 World Cup Ticket Price

By: Esther Ayoola Football Supporters Europe (FSE) and Euroconsumers don file case on Tuesday give European Commission against FIFA over high ticket price for 2026 World Cup. Dem tuk say ticket for di tournament wey go happen June 11 to July 19 for US, Canada and Mexico too cost, and accuse FIFA say dem dey use monopoly power control sales. FSE say FIFA impose unfair and confusing buying conditions for fans, wey no go fit happen for normal competitive market. […]

todayMarch 24, 2026 14

National

El-Rufai Show For Kaduna Court Over Corruption Case

By: Esther Ayoola Former Kaduna State Governor, Nasir El-Rufai, don waka enter Federal High Court for Kaduna today to answer di Independent Corrupt Practices and Other Related Offences Commission. ICPC tuk say call am over alleged corruption and financial misconduct wey im do during im time for office as governor. Say, Heavy security for court and around Kaduna town as armed policemen dey control di entrance of di court, while supporters gather outside. Court don start, but journalists no fit […]

todayMarch 24, 2026 14

WHO WE ARE

We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.

We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!

Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!

 

listen with your app

This will close in 0 seconds