Blog masonry

Background

Entertainment

Ned Nwoko Yarn Say Regina Daniels Negative Drug Test No Mean Anything

By: Esther Ayoola Senator Ned Nwoko on Thursday, yarn say Regina Daniels negative drug test no mean anything, say na temporary abstinence. E post for im X page say recovery no be social media show, and no fit come from just one test result. According to am, short break no solve di real gbege as recovery need time, honesty and professional support. Di statement come from im media team, and di marras don already cause plenty plenty tuk online.

todayJanuary 9, 2026 7

National

Edo State To Vaccinate 2.2 Million Pikin For Measles-Rubella Inside Just 10 Days

By: Esther Ayoola Edo State dey plan to vaccinate 2.2 million pikin between 9 months and 14 years against Measles-Rubella as part of Nigeria Integrated Mass Vaccination Campaign. Dr Eseigbe Efeomon, Director of Disease Control and Immunization for ESPHCDA, yarn dis one for Benin City during parley wey dem organize for journalists. Di campaign don start for Northern states Oct 4–27, 2025, and Southern states go run Jan 20 – Feb 13, 2026. Di aim na to protect children from […]

todayJanuary 9, 2026 6

Lagos

Lagos House Of Assembly Don Pass ₦4.4 Trillion Budget For 2026

By: Esther Ayoola Lagos State House of Assembly don pass di ₦4.4 trillion 2026 Budget of Shared Prosperity enter law. Committee chairmo, Hon. Sa’ad Olumoh, present di breakdown for plenary on Thursday. Di budget get ₦171 billion increase and focus on roads and infrastructure, education, healthcare, economic growth and social development. According to di report, dis na third budget of di present administration and di final new-cycle budget for Governor Babajide Sanwo-Olu second term.

todayJanuary 9, 2026 14

National

INEC Open Phase Two For Voter Registration For Lagos

By: Rilwan Agbomeji Di Independent National Electoral Commission (INEC) don drop message for all Lagosian phone, wey never register with INEC, to go do dia voter registration. Resident Electoral Commissioner (REC) for Lagos, Ayobami Salami, ni on di message on Thursday. Say, Di first phase of voter registration end December 10, 2025, but di second phase don start since January 5, 2026, and dey happen for all local government areas plus INEC state headquarters. Salami tuk say INEC wan make […]

todayJanuary 8, 2026 16 2

National

ADC Swear For New Chairmo To Do Constitution Review

By: Rilwan Agbomeji National Chairmo of Africa  Democratic congress, David Mark, don  go swear  Senior Lawyer,  Etigwe Uwa (SAN)  say make im do  Chairmo for di party Constitution Review Committee for Abuja. Untop marras wey sup for di party headquarters for Abuja on Thursday, Mark tell di committee make dem work framework wey go promote inclusiveness, transparency and accountability, and still follow di party original principles. Im say di party constitution na di moral guide and legal backbone, wey dey […]

todayJanuary 8, 2026 7

Sports

CAF To Run WAFCON Draw 2026 Fixtures For Morocco

By: Rilwan Agbomeji Confederation of African Football (CAF) share update say di Women African Cup Of Nations  2026 final draw go hold for Rabat, Morocco on Thursday, January 15. According to CAF official post on X, Di draw go start 2pm local time (1pm GMT) For di same day, CAF go announce winners for Women Coach of di Year, Interclub Player of di Year, and Women Club of di Year awards. Say, dis edition go  dey historic, because e go […]

todayJanuary 8, 2026 15

National

Afenifere Don Raise Alarm As Terror Attacks Dey Plenty For Yorubaland

By: Rilwan Agbomeji Afenifere, di pan-Yoruba socio-political group, don yarn say dem dey worried about di way terror attacks don increase for Yorubaland and oda parts of Nigeria. For statement wey dem release for Ibadan, di group publicity secretary, Jare Ajayi, call South-West governors make dem act on di security resolutions wey dem agree on for dia meeting on November 24, 2025. Recently, gunmen attack forest guards for Old Oyo National Park for Oyo State and kill five National Park […]

todayJanuary 8, 2026 8

foreign

Oxford English Dictionary Add Naija Words Like “Amala” and “Abeg”

By: Rilwan Agbomeji Di Oxford English Dictionary don add some Nigerian words come dia book, like “mammy market,” and “amala.” Di update, wey dem release for Wednesday, include over 500 new words, phrases, and tenses. Di dictionary say dis show how Nigerian language, culture, and food dey influence di world. Other Naija words wey dem add na “moi moi,” “abeg,” “biko,” and “Ghana Must Go,” plus internet slang like “DM,” “brainfart,” and “chug.”

todayJanuary 8, 2026 11

Sports

FG Promise To Clear Super Eagles Bonus, Say Money Go Enter Friday

By: Rilwan Agbomeji Unto update for di Super Eagles bonus marra, say, Federal Government don  agree to  approve money for di Super Eagles match bonus wey concern AFCON 2025. Minister of State for Finance, Doris Uzoka-Anite, tuk say players go begin see di money for dia bank accounts from today or tomorrow. Before now, Super Eagles players bin threaten say dem no go travel for dia quarter-final match because allowance wey dem never see. Nigeria go face Algeria on Saturday […]

todayJanuary 8, 2026 6

WHO WE ARE

We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.

We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!

Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!

 

listen with your app