Blog masonry

Background

Sports

Michelle Alozie Hail FIFPro World XI Nomination As Big Honour

By: Esther Ayoola Super Falcons defender, Michelle Alozie, don troway salutation to her Nigerian teammates say her nomination for FIFPro World XI na big recognition of her hard work with Nigeria national team. According to sport aproko pipo, dem include Alozie among di 26 players wey make di 2025 FIFPro World XI nomination list for October. FIFPro World XI na di only global football award wey professional footballers themselves dey vote for. Alozie na one of three African players wey […]

todayDecember 31, 2025 7 2

obodo oyinbo

Mali, Burkina Faso Block Americans From Dia Country

By: Esther Ayoola Mali and Burkina Faso don place travel restriction on American citizens after di US put dem for no-entry list. Both countries’ foreign ministries tuk say di action na “equivalent measures,” as response to President Donald Trump decision to expand US travel ban reach almost 40 countries dis month. Di US list include Syria, Palestinian Authority passport holders, and some African countries like Niger, Sierra Leone and South Sudan, based only on nationality. White House explain say dem […]

todayDecember 31, 2025 10

Lagos

Balogun Market Fire Kill Five As Another Blaze Burn Shops For Oshodi

By: Esther Ayoola Lagos State Fire and Rescue Service tuk say fire wey gut Great Nigeria Building for Balogun Market, Lagos Island, don kill five people, after dem recover two more bodies from di rubbles on Sunday. According to di agency Controller General, Margret Adeseye, another fire break out Monday evening for Arena Market, Bolade area of Oshodi, Lagos State. She say dem receive distress call around 5:50pm and immediately deploy fire fighters, wey reach di scene within five minutes […]

todayDecember 31, 2025 14

Lagos

Governor Sanwo Olu Cancel Lagos Greater Fiesta

By: Esther Ayoola Area spoil say Lagos State Government don cancel di 2025 Greater Lagos Fiesta wey suppose hold today, December 31, 2025. Governor Babajide Sanwo-Olu, through im media aide Gboyega Akosile, ask make instead of di fiesta, Lagos people spend di time for personal prayers for Nigeria, Lagos State and everybody wey dey live for di state. Di governor urge residents make dem pray for peace, good leadership, prosperity, productivity and general wellbeing. Im wish all Lagosians happy and […]

todayDecember 31, 2025 9

National

President Tinubu Say New Tax Law Go Run From January

By: Esther Ayoola President Bola Tinubu tuk say new tax laws wey dem pass on June 26, 2025, plus di remaining ones wey go start January 1, 2026, go take effect as dem plan am. For statement wey im sign by imself, Tinubu say di reforms be once-in-a-generation chance to build fair, competitive and strong money system for Nigeria. Im explain say di new laws no be to increase tax, but to reset di system, harmonise rules, and protect people […]

todayDecember 31, 2025 24

Sports

Arsenal Show Bad Character Beat Villa 4-1

By: Esther Ayoola Arsenal show serious power as dem beat Aston Villa 4–1 for Emirates Stadium on Tuesday night, take open five-point lead for EPL table. Afta first half tight, Gabriel Magalhaes, Martin Zubimendi, Leandro Trossard and Gabriel Jesus score all di goals for second half. Villa goalkeeper Emiliano Martinez make big mistake for corner, wey give Arsenal di first goal and turn di match around. Di win end Aston Villa 11-match winning run and slow con put small break […]

todayDecember 31, 2025 9

Sports

Lazio Coach Sarri Do Small Heart Operation

By: Esther Ayoola Lazio coach Maurizio Sarri don undergo small heart operation afta doctors find say im get atrial fibrillation wey dey affect heart rhythm. Di Serie A club talk say di operation be routine and dem expect di 66-year-old manager to resume work in few days. For statement wey dem post for X, Lazio confirm say Sarri do transcatheter ablation for Policlinico Tor Vergata hospital.

todayDecember 31, 2025 8

obodo oyinbo

Guinea Coup Leader Doumbouya Win Presidency With Big Landslide

By: Esther Ayoola Guinea election authority don declare Mamady Doumbouya, di coup leader wey take power for 2021, as winner of di guinea 2025 presidential election. Dem announce di provisional result on Tuesday, say di vote wey happen December 28 give am 86.72 percent, wey make am win straight without runoff. Dis election na di first one for di country since di military takeover, and many observers say e happen to legitimize Doumbouya as di ogbonge leader of di west […]

todayDecember 31, 2025 10

Sports

Super Eagles Sweep AFCON Group Stage

By: Esther Ayoola Super Eagles of Nigeria don finish AFCON Group C with 100% win record, beating Uganda 3-1 to finish top of di group. Before dis game, Nigeria already beat Tanzania 2-1 and beat Tunisia 3-2, so dem collect 9 points finish di group stage. For di final group match, Super Eagles open scoring 28th minute through Paul Onuachu, and Raphael Onyedika add two quick goals for second half make am 3-0 before Uganda get small consolation goal. With […]

todayDecember 31, 2025 11

WHO WE ARE

We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.

We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!

Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!

 

listen with your app