Blog masonry

Background

Articles

KONFAM FM DO JOINBODY COLLABO WITH MINISTRY OF HOUSING

One ogbonge proverb yarn say, House wey dem no finish, fit become hideout for wahala or Jaguda boys" and na di same message Lagos State Ministry of Housing carry come today as Konfam FM 89.5 pay dem courtesy visit for Alausa, Ikeja. For di meeting, di permanent secetary of di ministry Engr. Abdulhafis Gbolahan Toriola call on Konfam FM make e join hand with government to educate Lagos residents on housing matters wey concern everybody. One of di biggest concerns […]

todayJuly 7, 2026 32

Local

Delta Commissioner of Police Punish Two Police Officers

By: Yusuf Abuh Two police officers don chop beta koboko for Delta State, don lose dia rank after dem find dem guilty of extortion and other misconduct ontop one viral video. For di viral video di police dey collect kpaje with POS from motorist through POS Delta Police tuk, tuk, SP Bright Edafe, konfam dis development say Commissioner of Police, CP Yemi Oyeniyi, approve di punishment after orderly room trial. Di officers, Inspector Augustine Jeremiah and Corporal Miracle Ehirim of […]

todayJuly 7, 2026 22

Sport Yarns

CAF Confirm Rangers, Rivers United for Champions League Qualifier

By : Jolayemi Olajide Confederation of African Football (CAF) don confirm say Enugu Rangers and Rivers United go represent Nigeria for di qualifying rounds of di 2026/27 CAF Champions League. According to di list wey CAF release on Monday, 24 clubs from 12 African countries go compete, with each country providing two teams. Defending champions Mamelodi Sundowns of South Africa, Zamalek, Pyramids, TP Mazembe, Orlando Pirates, Esperance and oda top clubs also make di list. Rangers and Rivers United now […]

todayJuly 7, 2026 29

obodo oyinbo

Iran Warn Trump Say Dem No Go Reach Agreement If Threat Continue

By : Jolayemi Olajide Iran Foreign Minister Abbas Araghchi don warn Donald Trump say if dem continue dia threat, dem go stop peace talks. Im tuk dis one give tori pipo on Monday, after report say, Trump America  dey plan force di peace  agreement with Iran. Iran dey insist say, nor be everything dem go use force, but if US insit dem go give dem hot, hot.

todayJuly 7, 2026 16

OBODO NAIJA

FG Wan Bring back more Nigerians Back from South Africa Over Xenophobic Attack 

By : Jolayemi Olajide Nigeria Government say e go sti bring Nigerians back from South Africa on Tuesday because of fresh attacks on foreigners. Foreign Affairs Minister Bianca Odumegwu-Ojukwu tell news tatafos on Tuesday, say another flight go leave dis week. Three groups of Nigerians don already return since the evacuation start last month. She also advise Nigerians wey still dey South Africa make dem think well whether to stay or come back home.

todayJuly 7, 2026 17

Lagos

Lagos Police Burst one jaguda boys Ama, gbab 150 Suspects

By : Jolayemi Olajide Lagos State Police  command ehn, don do dia normal James Born doings  gbab 150 suspected  jaguda boys, say dem lap di  ama wey dey inside dumpsite for Boolar area near Okofilling Bus Stop, Igando. Na police oga Tijani Fatai naim use im yamchop mouth konfamate this mata for police headquarters  for im monthly tuk, tuk doings. Di senior man Police oga ehn,  konfam oh, say during di raid, police recover over 100 motorcycles, guns, mobile phones, […]

todayJuly 7, 2026 25

Lagos

Sanwo-Olu, Umahi do monitoring Spirit for Lagos-Calabar Coastal Road, explain di flood mata

By : Jolayemi Olajide Lagos State Govo, Babajide Sanwo-Olu, and wi Minister of Works, David Umahi, do small ibeji movings porporly  all di social media post about  Lagos-Calabar Coastal Road, say nor be di road di cause flood anything. Di Two both of dem  tuk dis one when Umahi and some members of the National Assembly visit di govo. Sanwo-Olu welcome oga  minister and di lawmakers, and praise di Federal Gornment for di road project. According to am, di  project […]

todayJuly 7, 2026 29

Sports

Ronaldo World Cup Dream Ends

By: Yusuf Abuh Cristiano Ronaldo World Cup journey don end for heartbreak again, after Spain beat Portugal 1-0 for Dallas Stadium on Monday night, thanks to Mikel Merino late goal. Ronaldo, wey plenty people believe say na im last World Cup match be dis, try lead Portugal attack with João Félix and Bruno Fernandes but dem no fit score goal. Spain defence stand gidigba throughout di match, while goalkeeper Unai Simón make important saves to stop Portugal. Merino late strike […]

todayJuly 7, 2026 26 1

WHO WE ARE

We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.

We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!

Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!

 

listen with your app

This will close in 0 seconds