Blog masonry

Background

National

NERC: Togo, Niger, Benin Dey Owe Naija N25bn Gbese For Electricity

By: Rilwan Agbomeji Nigerian Electricity Regulatory Commission (NERC) don share update say Togo, Niger, and Benin dey owe Nigeria about N25 billion for electricity wey dem buy from Nigeria grid. NERC tuk dis for dia Third Quarter 2025 report, wey show say di three countries suppose pay $18.69 million but dem don only pay $7.125 million, leaving $11.56 million unpaid. Di regulator explain say di debt dey because these international companies dey buy power under bilateral arrangements from Nigeria, and […]

todayJanuary 8, 2026 9

National

Court Put Ice Block For Malami, Sons 57 Properties

By: Rilwan Agbomeji Federal High Court for Abuja don order make government hold 57 properties wey dem say get link with former Attorney-General, Abubakar Malami, and two of im pikin dem, Abdulaziz and Abiru-Rahman. Justice Emeka Nwite give di order afta EFCC carry ex parte application come court on Tuesday. EFCC talk say di properties, wey value reach about N213.2 billion, be money from illegal activities. Dem say di properties dey Abuja, Kebbi, Kano and Kaduna, and e include hotels, […]

todayJanuary 8, 2026 10 4

National

Govnor Makinde Arrange Im Mehn To Rascal Di Jaguda Boys Wey Attack Oloka

By: Rilwan Agbomeji Oyo State Govo, Seyi Makinde, don condemn di attack wey kill five forest guards for Oloka Village. E talk say di people wey do am go dance ayagayagayagayo, face justice. Di Govo press tuk say na cross-border attack ni hapun, and security agencies don dey work to catch di criminals. E beg residents, especially for Oriire LGA and border areas, make dem remain calm as normalcy don return.

todayJanuary 8, 2026 7

Sports

How Di Morocco 2025 AFCON Waka So Far

By: Rilwan Agbomeji Di battle for di 2025 Africa Cup of Nations (AFCON) dey strong by every match day,  beta performances for all di top teams, and high hopes from every corner of Africa. And like dis, di tournament don reach Quater finals phase. Na 52 African countries enter di race from di qualifiers to di group stage of di competition.   Group Stage Results – AFCON 2025 (Morocco) Matchday Results December 21, 2025 Morocco 2‑0 Comoros   December 22, […]

todayJanuary 8, 2026 4 3

Sports

Super Eagles Refuse to Travel Say Dem Never See Dia Match Bonus

By Ebi Oboko Nor be small tin oh, say di Super Eagles of Nigeria and coaches no gree travel to Marrakech wia dem suppose face Algeria for AFCON quarterfinals say NFF never pay dem dia Four match bonus. Africa Aproko Journalist, Oluwashina Okeleji, ni troway dis update for Instagram, say na wetin hapun on Wednesday, normal dem supposr travel on Thursday, today from FEZ b4 dis news dey break so. Di super Eagles don beat Tanzania, Tunisia, Uganda for group, […]

todayJanuary 8, 2026 6

foreign

U.S Take Over Venezuela Oil Money

By Ebi Oboko US  say dem don dey control Venezuela oil sales and dat,  na dem go  decide how Venezuela go take spend dia money. US Department of Energy na dey troway dis one for social media, say dem don even start to sell the oil for world market, and all the money go first enter bank accounts wey US dey control. Dem say, dem don succeed sell about 30 to 50 million barrels, and the sales go continue as […]

todayJanuary 8, 2026 5

National

NLC Presido knack Akpako Untop New Tax Law

By Ebi Oboko Oga Presido of Nigeria Labour Congress, Joe Ajaero, don knock the new tax law,  say,  workers nor sabi wetin dey hapun and dat e go put more load on poor pipo. E tuk dis one for Abuja during book launch of former NLC presido Hassan Summonu and im 85th birthday celebration. Ajaero say gornment sideline workers for di tax reform marra, even though na dem dey pay plenty tax, and e nor dey sweet workers at all.

todayJanuary 8, 2026 9

Lagos

iPhone Scam: Lagos Police Catch Woman for 500 Million Scam

By Ebi Oboko Lagos police command share update on wetin dey play for tech business for di obodo naija, say dem don arrest one 35-year-old woman, Modupeola Bamisade, for allegedly scamming over 100 people of more than N500 million. The Lagos State Police Command say she dey sell iPhones, iPads and other Apple products online, dey offer 50 per cent discount to attract customers. According to Police source on Wednesday, say she dey use social media influencers to promote her […]

todayJanuary 8, 2026 2

Lagos

Top African Artistes Enter Area For Lagos As AFRIMA 2026 Take Over Naija

By Ebi Oboko Unto joliment marras for Lagos, say Sixteen top African artistes don land di obodo Naija as Lagos State dey host the 9th edition of All Africa Music Awards, AFRIMA, say di mata sef go run for one week. Dis event start from Wednesday January 7 and go end on Sunday January 11, with big Owambe pari on Friday for Ikeja and the main awards night for Victoria Island. Di Lagos State Gornment don put vow for ground […]

todayJanuary 8, 2026 5 1

WHO WE ARE

We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.

We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!

Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!

 

listen with your app