Blog masonry

Background

Sport Yarns

England, Argentina Renew Old World Cup Rivalry

Edited by Ebi Oboko England and Argentina go face each other for one heavyweight World Cup semi final on Wednesday after both teams beat Norway and Switzerland for quarter final. Argentina, with Lionel Messi, dey chase back-to-back World Cup title, while England dey hope to  end dia 60-year wait for major trophy. Winner of di match go face either France or Spain for di World Cup final on July 19. Di semi final dey also bring back memories of di […]

todayJuly 12, 2026 8 2

Lagos

How Lagos Flood Carry Six-Year-Old Girl

Edited By Ebi Oboko One Lagos resident , Ademola Oloyede,  cry wetin nor gud explain how flood take  carry im six-year-old daughter, Asabi, during heavy rainfall for Okeleye, Charity area of Lagos State. According to am, di rain start on June 28 and later turn to serious flood wey break church fence before water rush enter dia compound. Oloyede say im dey work when dem call am, but by di time e reach house, flood water don reach im chest […]

todayJuly 12, 2026 10

Local

Anambra Ban School Graduation, Christmas Party Again

Edited by Ebi Oboko Anambra State Universal Basic Education Board (ASUBEB) don remind all public primary and junior secondary schools for the state say graduation ceremonies, Christmas parties and graduation levies still dey banned. For circular wey Executive Chairman Dr. Justina Anyadiegwu sign on July 10, 2026, ASUBEB say the directive na part of Anambra State Gornment policy for basic education schools. Di  board order Local Government Education Area officers and Education Secretaries across all 21 local government areas to […]

todayJuly 12, 2026 22 16

obodo oyinbo

 Iran Drop Revenge List, Name US, Israel Leaders

Edited by Ebi Oboko One Iran newspaper wey dem dey call,  Hamshahri, don release  list of 13 foreign leaders wey Iran dey plan  revenge for di kpaing of former Supreme Leader Ali Khamenei. Di list include leaders from United States, Israel and some European countries, an dis one comout late  Saturday. Khamenei son and successor, Mojtaba Khamenei, vow say revenge must happen, saying those wey dey on di list no go enjoy peaceful death. Di threat come after US and […]

todayJuly 12, 2026 14 12

obodo oyinbo

NATO, EU Leaders Mourn US Senator Lindsey Graham

Edited by Ebi Oboko NATO boss, Mark Rutte and European Union chief Ursula von der Leyen don mourn US Senator Lindsey Graham wey kpai, kpai recently,  age of 71. Graham, wey be close ally of US President Donald Trump, reportedly kpai on Saturday after brief and sudden illness. Rutte describe Graham as strong supporter of America and NATO, wey also work hard to help end Russia war against Ukraine. Von der Leyen say Graham na fearless leader wey fight till […]

todayJuly 12, 2026 9 12

Sport Yarns

Power Slap Hulk Challenge Anthony Joshua to Fight

Edited by Ebi Oboko Nigerian Power Slap heavyweight, Kabiru Adediran wey people sabi as "Hulk", don challenge British-Nigerian boxing star Anthony Joshua to one fight. Hulk tok say nor be cruise oh dat, im go like  enter ring with Joshua wey e call im role model. According to am, even if Joshua beat am, di fight fit change im life because e go still collect beta money. Di former Davido bouncer still boast say im get strong hand and correct […]

todayJuly 12, 2026 9 2

Sport Yarns

How Flamingos take  Fly Enter 2026 U-17 Women World Cup

Edited by Ebi Oboko Nigeria U-17 women team, di Flamingos, don qualify for 2026 FIFA U-17 Women's World Cup after dem beat Benin Republic 5-3 for second leg in Lomé, Togo. Di victory give Nigeria 8-5 aggregate win and secure one of Africa qualification tickets for di tournament. Queen Joseph shine well with hat-trick, while Mary Akpan Dunstan and Esther Enne Stephen also score for di Flamingos. Di 2026 FIFA U-17 Women's World Cup go hold for Morocco from October […]

todayJuly 12, 2026 6

National

President Tinubu Give Kudos to Security Agencies Over Oyo School Pikins Rescue

Edited by Ebi Oboko Wi oga Presido, Bola Tinubu don express joy as security agencies rescue di school pikin dem and teachers wey kidnappers hold for 56 days for Oriire community, Oyo State. Baba Seyi  hail di military, DSS and Nigeria Police for di successful operation wey lead to di arrest of eight suspected kidnappers while security operatives neutralise oda gang members. Tinubu also sympathise with di victims and dia families over di trauma wey dem pass through during dia […]

todayJuly 11, 2026 15 3

obodo oyinbo

Trump Raise Alarm, Warn Iran Not to Try Nonsense

Edited by Ebi Oboko US Presido,  Donald Trump don warn say America go completely destroy Iran if dem try say naim him Iran dey target for  office to Kpai. Trump write for him Truth Social page say plenty missiles don ready and di US military don receive order to respond if any attack hapun. According to am, di military fit launch massive operation against Iran and continue am for one year if necessary. Di warning come as tension between di […]

todayJuly 11, 2026 16 3

WHO WE ARE

We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.

We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!

Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!

 

listen with your app

This will close in 0 seconds