Blog masonry

Background

OBODO NAIJA

Police Approve Job For Families Of 10 Officers Weh Bandits Kpai For Kebbi

Di Inspector-General of Police, Olatunji Disu, don approve recruitment of relations of di 10 police officers wey jaguda bandits kpai  for Kebbi State, after dem apply to join di force. Disu use di opportunate promise Nigeria Police Force hin no go abandon di families of any officers wey lose dia lives based on duty call. Di IGP sti promise to pay all salaries and promise wey dem make to dis particular officers.

todayAugust 25, 2026 9 2

Lagos

Lagos Gornment Pay N168.2bn To 48,000 Retirees

Lagos State Gornment say dem don pay N168.2bn to more than 48,000 retirees under di Contributory Pension Scheme since 2007. According to statement wey dem post dia gorment facebook handle on Tuesday, say dem nor sabi wetin wan make di lagos pension pipo protest Lagos State Pension Commission say di N168.2bn na cumulative payment wey dem make to retirees across di state. Gornment say di payment cover benefits under Lagos Contributory Pension Scheme since 2007, so why dem wan protest.

todayAugust 25, 2026 10 3

Lagos

LAWMA Lock Markets Over Dirty Environment

By: Yusuf Abuh LAWMA don lock some markets and plazas for Ayobo, Lagos, on Sunday over repeated environmental violations and illegal dumping. LAWMA Project WISE team carry out di enforcement around Ayobo-Ipaja axis to clear waste backlog and stop illegal dumping. LAWMA boss Muyiwa Gbadegesin say dem target facilities wey repeatedly break di environmental rules despite several warnings. Rock of Age Plaza, Ajerogun I Market, Ayobo Market and Oba Plaza na among places wey dem seal during di exercise.

todayAugust 25, 2026 12

south west

Ogun Police Burst Alleged Baby Factory, Rescue Six

By: Yusuf Abuh Ogun Police don burst alleged baby factory for Mowe on Monday, August 24, rescuing two pregnant women and four children. Police spokesperson DSP Oluseyi Babaseyi disclose di operation on Tuesday, say six suspects dey custody over alleged human trafficking and illegal adoption. Operatives carry out di raid around 8am for Toluwalase Street, Abaren Village, after sustained intelligence on activities inside di facility. Police say dem dey continue investigation to uncover how di alleged baby factory operate and […]

todayAugust 25, 2026 9

Lagos

Lagos Pay N168.2bn To 48,000 Retirees

By: Yusuf Abuh Lagos State Gornment say e don pay N168.2bn to more dan 48,000 retirees under di Contributory Pension Scheme since 2007. Di gornment make di disclosure on Tuesday through Facebook, as e respond to concerns from protesting retirees over pension payments. Lagos State Pension Commission say di N168.2bn na cumulative payment wey dem make to retirees across di state. Gornment say di payment cover benefits under Lagos Contributory Pension Scheme since 2007.

todayAugust 25, 2026 10

Lagos

Lagos Gives Traders 7 Days To Leave Ojo Hospital Area

By: Yusuf Abuh LASISMA don give traders, squatters and illegal occupants around Ojo General Hospital seven days to comot, after enforcement start on Monday. Di exercise happen along Lagos-Badagry Expressway near LASU-Iba Road junction, as LASISMA issue contravention notices to occupants of government setbacks and corridors. LASISMA General Manager Oludaisi Oso say dem take di action to restore public spaces around government facilities and keep dem for dia original purpose. LASISMA warn say full enforcement, including possible demolition, go follow […]

todayAugust 25, 2026 7

Entertainment

UAG Demands New Team For Mohbad Investigation

By: Yusuf Abuh United Advocates Group, UAG, don ask Lagos Police Commissioner Fatai Tijani to form new team to investigate Mohbad death, say e go make di probe transparent. UAG legal adviser Oluwatosin Afolabi make di call for statement as concern grow over delay in di investigation. Di group say fresh probe start April 2025 but e never reach conclusion since dem transfer am to Lagos Police Command. UAG say new officers wey no handle di earlier investigation fit help […]

todayAugust 25, 2026 12

Lagos

FG Cut Carter Bridge Work From 36 To 24 Months

By: Yusuf Abuh Federal Gornment don reduce di timeline to complete reconstruction of Carter Bridge for Lagos from 36 to 24 months, wi Minister of Works Dave Umahi announce am on Monday during inspection of di project. Umahi, alongside Minister of State for Works Mohammed Goronyo and lawmakers, inspect Carter Bridge and Iddo Bridge projects for Lagos to speed up di work. Di minister say dem shorten di reconstruction period because Carter Bridge dey play critical role for Lagos transportation […]

todayAugust 25, 2026 8

Sports

Chelsea Burst Fulham 3-2 as Palmer Shine

Chelsea  start dia new era with ogbolicious win beating  Fulham 3-2 for West London derby as Cole Palmer shine for di Blues wetin nor gud. Di win give new Chelsea coach Xabi Alonso winning start for im Premier League reign and make am one of only three out of di club’s last nine managers wey win dia first league match. Di defeat na Fulham coach Arbeloa first Premier League game in charge of di club, as both managers make dia […]

todayAugust 25, 2026 9

WHO WE ARE

We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.

We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!

Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!

 

listen with your app

This will close in 0 seconds