Blog masonry

Background

OBODO NAIJA

Presido Tinubu Explain How Hin Reforms Go Make Life Cheaper For Nigerians

By : Jolayemi Olajide Presido Bola Tinubu don explain how di economic reforms wey gornment dey carry out go help make things cheaper for Nigerians. Tinubu tok dis one for im Independence Day address on Thursday as Nigeria dey celebrate 66 years of independence. E say government go cut di cost of living by reducing how much e dey cost to produce food and other goods, plus di money wey dem dey spend to move dem from one place to […]

todayOctober 1, 2026 16

OBODO NAIJA

 Presido Tinubu Assure Nigerians Say Nigeria Dey Move From Reform To Prosperity

  Wi oga Presido, Bola Ahmed Tinubu don konfamate to Nigerians say di series of economic reforms wey government introduce go surely bring better days. Tinubu give di assurance for im address to di nation on Thursday, October 1, as Nigeria dey celebrate 66th Independence Day. Tinubu say di reforms no weaken di economy as many pipu believe, and e assure Nigerians say di promises wey e make dem dey gradually fulfill. E say when im administration enter office, dem […]

todayOctober 1, 2026 16

Lagos

Sanwo-Olu Tell Nigerians Make Dem Unite and Love Nigeria

Lagos Govo, Babajide Sanwo-Olu, don call on Nigerians to come together, love dia country and play dia part as Nigeria dey celebrate 66th Independence anniversary. Sanwo-Olu, wey be Chairman of South-West Governors’ Forum, tell Nigerians, especially Lagosians, make dem learn from di strength and determination of di pipu wey fight for Nigeria independence and help build better country. Di Govo tok dis one for Independence Day message wey im Special Adviser on Media and Publicity, Gboyega Akosile, release. Sanwo-Olu say […]

todayOctober 1, 2026 11

OBODO NAIJA

NLC Tell Gornment Say Make Dem Bring Fuel Price Down

Nigeria Labour Congress, NLC, don call on gornment to reduce petrol price, pay workers nationwide wage award and start fresh toks on new minimum wage, as Nigerians dey struggle to survive under high cost of living. For Independence Day statement wey dia Presido, Joe Ajaero, sign on Wednesday, di union tok say workers and ordinary Nigerians don dey suffer under high transport fare, food price, house rent and school fees. NLC blame part of di suffering on fuel subsidy removal […]

todayOctober 1, 2026 9

OBODO NAIJA

I Go Resign If Tinubu Lose for Rivers, FCT – Wike

Minister of di Federal Capital Territory, Nyesom Wike, don vow say e go resign from im position as minister if Presido Bola Tinubu lose di 2027 presidential election for Rivers State and FCT. Wike make dis statement during meeting with leaders and members of Apo Mechanics and Traders Association for Abuja, as e say im stay for Tinubu cabinet depend on whether e fit deliver electoral victory for di Presido. For statement wey im Senior Special Assistant on Public Communication […]

todayOctober 1, 2026 11

obodo oyinbo

Plane Almost Crash For Dubai

Israeli leaders on Wednesday say one pilot wey dem describe as “jihadist” try to crash a flydubai plane wey carry mostly Israeli passengers, but some passengers overpower am and stop wetin fit cause big disaster. Prime Minister Benjamin Netanyahu say as di plane dey near Israel, one of di pilots stab di other pilot and apparently try to crash di plane with everybody wey dey inside. Netanyahu say one Israeli passenger wey dey inside di plane rush enter where di […]

todayOctober 1, 2026 10

Sports

Ronaldo Comot From Portugal Camp, Return Madrid

Cristiano Ronaldo don return Madrid after e announce say e don comot from Portugal national team camp on Wednesday. Football transfer expert, Fabrizio Romano, disclose dis one for im post on X, as Ronaldo land for Madrid around 2 a.m. local time after e officially withdraw from di Portugal squad. Di Al-Nassr striker reportedly decide to leave di camp after e discuss with Pedro Proença, President of Portuguese Football Federation, meaning say e no go play Portugal upcoming matches against […]

todayOctober 1, 2026 15

Lagos

How Lagosians Take Fall Hand Rush Beer After Road Askident

Kwake, dem say, problem everywia, na yesterday for Ajegunle, wia one beer truck don go get askident with one dispatch rider and two vehicles for Abalti Barracks, as bottles of beer scatter for road and commuters rush to pick dem dey drink. LASTMA officials na so dem enter di area dey form defend, dey defend beer wetin nor gud. According by di LASTMA tok, tok, Adebayo Taofeeq, say the truck driver bin dey speed naim cause di askident.   Read […]

todaySeptember 30, 2026 18

OBODO NAIJA

Baba Presido Drop Hin Mouth Odour For 2027 Opposition

For di Bad belles and  opposition, ogbonge update oh, baba, aka Jagaban, President Bola Tinubu  just land Lagos yesterday  from  holiday, incase u dey think say senior man dey sick, as senior man say  hin don ready for di 2027 race, person wey leg nor strong comot body. Na so e tell all di news tatafos for airport, comot body, comot body, energy dey fully 100 percent. Baba seyi say hin dey feel am, ready to scata ground and ready […]

todaySeptember 30, 2026 18

WHO WE ARE

We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.

We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!

Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!

 

listen with your app

This will close in 0 seconds