Blog masonry

Background

Sports

Morocco Break U-17 World Cup Record, Beat New Caledonia 16-0

Morocco don smash all-time U-17 World Cup record after dem demolish New Caledonia 16–0, a result wey still keep dia knockout hopes alive and wipe Spain old 13–0 record comot for books. Di Sunday match turn one-sided avalanche from di first whistle as Morocco attack full speed, no mercy at all. Abdelali Eddaoudi lead di charge, score twice for first half and run di show well, wey make am earn Player of di Match. New Caledonia wahala turn disaster after […]

todayNovember 10, 2025 8

National

Japanese Companies Dey Struggle To Make Profit For Nigeria — Envoy

The Japanese Ambassador to Nigeria, Suzuki Hideo, don yan say plenty Japanese companies wey dey operate for Nigeria dey struggle to make profit. Hideo talk dis one on Friday for Japan Pavilion during di opening ceremony of di 2025 Lagos International Trade Fair wey dey Tafawa Balewa Square, Lagos. Di ambassador talk say even though di companies dey face economic wahala, dem still dey optimistic about di future of dia business for Nigeria. Hideo yan, “We get about 52 Japanese […]

todayNovember 10, 2025 9

National

Furniture Makers Dey Gbese As Customers Dey Choose Sofa Covers Pass Build New Ones

Di wahala wey dey for economy don hit furniture lovers, but e dey hit di furniture makers pass. Because di cost to make even small sofa or repair old one don high, plenty people dey prefer buy sofa covers, wey dey leave furniture makers dey groan for lack of patronage. Some people sef dey buy chair fabrics make tailors make di covers for dem instead of buying ready-made ones. Lukeman Ogedengbe, wey be furniture maker, talk say e dey hard […]

todayNovember 10, 2025 15

National

Bureau De Change Operators Dey Seek Support To Boost End-Of-Year Forex Inflow

Association of Bureau De Change Operators of Nigeria (ABCON) don call for better support and empowerment of dia members to boost foreign exchange inflows during year-end festive season. ABCON President, Dr Aminu Gwadabe, yan dis during interview on Sunday for Lagos. He talk say BDC operators, wey dey close to retail forex users, fit play big role to stabilise Naira and capture more diaspora inflows. Gwadabe yan say plenty forex dey enter country toward end-of-year from Nigerians wey dey diaspora […]

todayNovember 10, 2025 6

Lagos

Iwaya Oba Dey Lament Flood As Lagos Tell Contractor Make E Finish Project On Time

The Olu of Iwaya-Yaba Kingdom, Oba Suleiman Owolabi, don beg Lagos State Commissioner for Environment and Water Resources, Tokunbo Wahab, make dem find lasting solution to di environmental wahala wey dey affect Iwaya. Oba Suleiman yan dis one during inspection of di community environment wey e do side by side with di commissioner. E remember say recent heavy rain don cause flood wey carry children go for one canal for Olaboye Olalere, wey collapse around 2:00 a.m., make two pikin […]

todayNovember 10, 2025 9

Lagos

Lagos Extend Permit Allowance

Lagos State Government don once again extend di closure of di popular amnesty programme wey dem start to bring many homeowners into di system make dem obtain dia planning permits and get documented. Di extension na response to property owners wey no fit benefit from di same programme last year. Dr. Oluyinka Olumide, Lagos State Commissioner for Physical Planning and Urban Development, talk say Governor Babajide Sanwo-Olu don approve di reintroduction of di amnesty for di third time during him […]

todayNovember 10, 2025 14

Lagos

Lagos APC Don Tell Peter Obi To Forget 2027 After Dem Lose Polling Unit For Anambra

Lagos APC don advise Peter Obi, di 2023 Labour Party Presidential candidate, make e rethink him 2027 presidential ambition afta Anambra governorship election show say LP support dey fall for ground. Di party spokesperson, Seye Oladejo, yan say di result, especially for Obi own polling unit, show say him Obedient Movement no strong again and grassroots structure dey crumble. Oladejo talk say social media fame no fit replace solid political organisation and voter engagement. Him add say di Anambra election […]

todayNovember 10, 2025 16

National

UK Warn: No Travel Go Six Nigerian States Over Rising Insecurity

UK don issue fresh travel warning make people no waka go parts of Nigeria because insecurity dey rise, violent crime, terrorism, and kidnapping dey increase for plenty areas. Dem warn say British nationals make dem dey extra careful, review dia safety plan, and get backup plan. FCDO talk say make people no travel at all go Borno, Yobe, Adamawa, Gombe, Katsina, and Zamfara states because Boko Haram and ISWAP dey pose high threat, especially for transport hubs, religious areas, and […]

todayNovember 10, 2025 33

National

Bandits Kill Elderly Woman We Dem Kidnap Because She Too Weak To Trek Kogi Forest

Suspected bandits don kidnap and k!ll one elderly woman, Mrs Elizabeth Olorunshola, for Ilafin-Isanlu community, Yagba East LGA, Kogi State. Di armed men attack di community on Saturday night, November 8, 2025, abduct di woman along Ilafin-Isanlu road and shot another person. Sources for di community yarn say di bandits shoot Mrs Olorunshola after dem see say she too weak to waka enter di forest go their hideout. Di bodies of di woman and di wounded man dem find for […]

todayNovember 10, 2025 21

WHO WE ARE

We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.

We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!

Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!

 

listen with your app