Blog masonry

Background

Sports

NFF Promise To Pay Super Eagles Coachie Im Three Month Gbese Ahead Of AFCON 2025

By: Rilwan Agbomeji Unto matter for sport, Nigeria Football Federation don comout clear fans doubt say dem go pay di Super Eagles coachie, Eric Chelle, salary wey dem owe am before di 2025 Africa Cup of Nations for Morocco. NFF top official talk say, dem dey owe di franco Malian Coachie Chelle three months salary plus bonuses, and dem wan pay am make e fit prepare di team wella. Di NFF official say Nigeria, along with 23 other teams, suppose […]

todayDecember 10, 2025 14

National

Remi Tinubu Hail Titilola Adeleke As She Mark 60 Years

By: Rilwan Agbomeji For abuja,  afta all di plenty drama for Osun state between di dancing senator and first lady, Oluremi Tinubu, madam first lady don wire birthday message give Adeleke wife, Titilola Adeleke, as she clock 60. Na for statement  wey dem wrap like moimoi  drop for her x page, Mama Remi  dey hail Madam Adeleke for di serious work wey she dey do to uplift Osun people through di renewed hope initiative. She talk say di Osun first […]

todayDecember 9, 2025 11

Lagos

Lagos Apc Shake Opposition With Talks Not To Disturb Tinubu

By: Rilwan Agbomeji Lagos branch of di All Progressives Congress (APC) dey vex carry matter for head dat make opposition no dey disturb president Bola Tinubu with “fake politicking and fake wahala” as 2027 dey waka  don near. APC lagos tuk tuk, seye oladejo,  ni dey yarn dis one dey  talk say dis time no be for confused coalitions or any political experiments. Di warning follow afta ADC yarn peter obi make e decide, if e wan join any coalition, […]

todayDecember 9, 2025 9

Lagos

Lagos Govment Say No Structures Wey Dey Under High-Tension

By: Rilwan Agbomeji Lagos State government tire shirt oh say say dem go begin remove any building or structure wey people build under high-tension wire because e dey dangerous for residents. Na for inspection waka wey dem go do for Third Mainland Bridge area, Special Adviser Olajide Babatunde  yarn dis one as im see plenty shanty and illegal structures wey no suppose dey di 50-metre right-of-way, im belle even turn am more. E follow oda government officials waka reach Oworonshoki, […]

todayDecember 9, 2025 12 2

National

Senate Say Yes To Tinubu, Army Benin Republic Waka

By: Rilwan Agbomeji Wi Senate sharpaly do gree for wi oga Presido Bola Tinubu to carry Nigerian troops enter Republic of Benin, dem nor even stress am or do yanga say dem wan help restore peace. Oga senate Presido Godswill Akpabio announce di approval on Tuesday during plenary afta dem check Tinubu letter for Committee of di Whole according to Section 5, Part II of Constitution. Lawmakers join bodi vote,  say dem gree fully with di deployment.  

todayDecember 9, 2025 8

Niger Delta

Obi: Naija No Suppose Dey Poor, God Already Bless Us

By: Esther Ayoola Presidential candidate of Labour Paty and before before Anambra state govo, Peter Obi, don tuk say Naija no suppose dey poor, no be poverty capital of world, because God don bless us with plenty resources  wey dey under our foot and wey dey for sky. E yarn this mata for one book launch for inside Abuja wey dey talk about the ogoni experience and how di people there don dey very very courageous. Obi emphasis  say Niger […]

todayDecember 9, 2025 11

National

President Tinubu Clear Nigerian Aprokos To Stop Fake News

By: Esther Ayoola Wi oga presido, Bola Tinubu, unto doings don  tell Nigerians make dem try to dey talk truth all the time  and stop to spread fake news. He talk this through  information Minister Mohammed Idris  during the launch of the “my nigeria, my responsibility” program for inside the obodo Nigeria. Idris  say,  Nigerians must promote correct information and show the world the countri progress, peace, and national values.

todayDecember 9, 2025 10

National

Remi Tinubu Hail Titilola Adeleke As She Mark 60 Years

By: Esther Ayoola For Abuja,  after all the drama for Osun state between the dancing senator and first lady, Oluremi Tinubu,  madam first lady don wire birth messgae give Adeleke wife, Titilola Adeleke, as she clock 60. Na for statement  wey dem wrap like moimoi  drop for her x page, mama Remi hail madam Adeleke for the serious work wey she dey do to uplift Osun people through the renewed hope initiative. She talk say the Osun first lady dedication […]

todayDecember 9, 2025 16

National

Tinubu Wire Letter Give Senate Say Im Wan Send Army Go Benin Republic

By: Alice Iduh Wi oga Presido Bola Tinubu don write Senate say,  make dem allow am send Naija soldiers go Republic of Benin as di country ask for help after coup wahala wey bust on sunday. Oga Senate Presido, Godswill Akpabio, read di letter for plenary, and Tinubu talk say na section 5(5) of di 1999 Constitution give am power to seek dis kind approval. Tinubu yarn say Benin beg for backup as dem be sister country, and Naija no […]

todayDecember 9, 2025 8

WHO WE ARE

We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.

We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!

Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!

 

listen with your app