Blog masonry

Background

OBODO NAIJA

3 Pipo Kpai, Plenty Odas Wunjure As Ebonyi Mining Pit Collapse

By: Rilwan Agbomeji For Enyim Agalegu community, Ikwo LGA, Ebonyi State, one mining pit don collapse, kpai at least three pipo and wunjure many odas. National Chairman of Enyim Agalegu Edukwu Opeke Union, Oboke Chukwuma Collins, talk say im receive distress call around 4 p.m. on Saturday and rush go di scene. Im join community pipo help rescue, dey remove earth wey don trap miners. Di pit na one wey First Patriots Limited dey run, wey dem before dey call […]

todayFebruary 15, 2026 14

OBODO NAIJA

Fubara Impeachment Wahala – ALDRAP Storm Rivers High Court

By: Rilwan Agbomeji Association of Legislative Drafting and Advocacy Practitioners (ALDRAP) don carry serious marras go Rivers State High Court, beg make dem sharply stop Rivers State House of Assembly from continuing di impeachment wey dem start against Govnor Sim Fubara. For di suit wey dem file on February 10 with number RHC/427/CS/2026 through lawyer S. O. Abang, dem drag plenty big names join including di Attorney-General, Speaker Martins Amaehule, some lawmakers, DSS and INECĀ  and tell court make nobody […]

todayFebruary 15, 2026 26

obodo oyinbo

Budget Wahala Force US Homeland Security Close Shop

By: Rilwan Agbomeji Di Department of Homeland Security don enter partial shutdown on Saturday sake of say US Congress never gree pay dem, especially over ICE operations wey dey cause gbege afta dem kill two citizens for Minneapolis raids. Thousands wey dey work for airport security, disaster relief, and oda DHS units go either carry dia kaya go house without payment or dey continue to work with no salary until money wahala settle. Democrats dey block new funding unless ICE […]

todayFebruary 14, 2026 21 18

Lagos

Kenya, Ethiopia No Gree Leave Lagos City Marathon Title

By: Rilwan Agbomeji East Africa no wan gree leave throne for Lagos City Marathon as Kenya and Ethiopia scatter everywhere for 2026 edition. Kenya Ezra Kipchumba Kerin blaze di road finish 2 hours, 11 minutes, 55 seconds take carry men title, while Ethiopia Meseret Dinke storm di women race finish 2:37:36 for Eko Atlantic. Rain fall small but race still burst 6:30am from Orca Mall, 42km warriors grind am out while crowd line Atlantic side dey shout fire for di […]

todayFebruary 14, 2026 11

Sports

I Want Make Ibrahima Konate Remain For Liverpool FC

By: Rilwan Agbomeji Liverpool FC Coachie, Arne Slot, don talk say e dey ready to do everything within im power to make Ibrahima Konate remain for Anfield. Di 26-year-old France defender dey for di last year of im contract wey e sign for 2021 when e join from RB Leipzig for Ā£35 million deal. Konate face tough period dis season both on and off di pitch, especially afta di death of im papa, but e bounce back well when e […]

todayFebruary 14, 2026 9 1

OBODO NAIJA

Jaduga Boys Attack Tungan-Makeri, Kill 6 Pipo

By: Rilwan Agbomeji Gunmen wey dem suspect say na bandits don kill six people for Tungan-Makeri and burn police station for Konkoso, both for Borgu Local Government Area of Niger State. Di attack start around 8:00 p.m. Friday night when more than 200 armed men storm di village, dey shoot anyhow and set many houses on fire. Residents tuk say di attackers operate for hours, kill six people and force many odas to run comot from dia homes. One eyewitness […]

todayFebruary 14, 2026 15

OBODO NAIJA

Make Valentine Pipo No Drink and Drive – Plateau FRSC

By: Rilwan Agbomeji Federal Road Safety Corps for Plateau State don drop strong warning to Valentine pipo, say make dem no try drink and drive or do any kain dangerous behaviour for road during celebration. State Sector Commander, Adelaja Ogungbemi, tuk dis one for statement wey Public Education Officer, Peter Longsan, sign on Saturday. According to am, di warning follow directive from di Corps Marshal to make sure say maximum safety dey for road and no life go loss during […]

todayFebruary 14, 2026 16

National

Abuja Appeal Court Store PDP Judgement For Fridge, Say Democracy Must Win

By: Esther Ayoola Di Court of Appeal don hold another village meeting for di Pipo Democratic Parti mata for Abuja on Thursday, dis time around say dem don put nine appeals wey different factions of di Parti file for fridge, make dey coolele coolele, about di controversial national convention wey dem hold for Ibadan, Oyo State last November. U sabi say, wahala start afta two judges for Federal High Court Abuja – James Omotosho and Peter Lifu – give separate […]

todayFebruary 13, 2026 17

Lagos

Lagos Continue Free Health Drive Training To Make Road Safe

By: Esther Ayoola Lagos State Drivers’ Institute for Ikeja don continue dia free health and retraining programme for commercial drivers today, na 2,000 drivers dem wan train before di end. General Manager, Tiamiyu Afusat Abike, rake full newspaper say true, true di drivers dey receive serious coaching to stop wawawa driving for lagos Say, normally Govo Babajide Sanwo-Olu don pay di training fee normally to boost compliance, encourage responsible driving and improve road safety across Lagos. Senior Special Assistant on […]

todayFebruary 13, 2026 19 2

WHO WE ARE

We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.

We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!

Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!

Ā 

listen with your app

This will close in 0 seconds