Blog masonry

Background

OBODO NAIJA

President Tinubu Hail Abdulsalami

Wi Presido, Bola Tinubu yesterday praise shege comot former military Head of State, Abdulsalami Abubakar, head, say im na oga na master for naija democratic. Tinubu tuk dis one for Abuja during public book presentation wey dem hold to honour Abdulsalami 84th birthday, and na  Vice Presido Kashim Shettima represent am fry mouth for di event. Shettima drop Tinubu message say Abdulsalami leadership naim bee di stew for naija democracy, dat naim dey make am sweet.

todayJune 15, 2026 19

Lagos

NDLEA Kramp Brazil Businessman

Operatives of National Drug Law Enforcement Agency don arrest a 41-year-old Nigerian businessman, Abugu Ikechukwu, for Lagos airport say dem gbab am with liquid cocaine inside shirts and towels. According to NDLEA tuk, tuk, Femi Babafemi, Di man, just land for Murtala Muhammed International Airport from Brazil via Ethiopia, wan bin dodge enter Nigeria, not knowing say mehn dey at alert for di airport. Babafemi say dia test confirm di drugs weigh 6.1kg, as part of bigger nationwide operation.

todayJune 15, 2026 12 12

Lagos

Lagos Police To Arrest Cars

Lagos State Police Command don announce say dem go start statewide jogolo against motors wey get covered, fake, defaced or no plate number to improve security and reduce crime. Police tuk, tuk, SP Abimbola Adebisi, talk say di order come from Inspector-General of Police, Olatunji Disu, and e go start on Monday, June 15, 2026, under CP Tijani Fatai supervision. To tell u how di mata serious reach, commissioner of Police, Tijani Fatai carry di mata tuk for tv sit […]

todayJune 15, 2026 25 1

Sports

Okocha Collect Special FIFA Award

Super Eagles legend Augustine ‘Jay-Jay’ Okocha don collect one special “Superior Player of the Match” award from FIFA for im beta doings against Spain wey im show for di 1998 World Cup. Di award, wey Michelob ULTRA and Copa90 collabo give am, na to honor players wey show dem-sef for World Cup games before di official Player of di Match award start for 2002. Di senior play naim post for Instagram, showing di silver trophy and tank di organizers for […]

todayJune 12, 2026 32 2

obodo oyinbo

Ebola Spread Enter New Areas For DR Congo

World Health Organization (WHO) on Friday don share update say Ebola don dey spread enter northeastern Democratic Republic of Congo, especially for Ituri, North Kivu and South Kivu. WHO epidemiology head, Olivier le Polain, naim dey give dis update, say di virus dey enter new health zones almost every day, showing how di outbreak big and hard to control. According to WHO, since dem declare di outbreak on May 15, dem don record 676 confirmed cases, 136 deaths, plus 119 […]

todayJune 12, 2026 26

OBODO NAIJA

Sowore Tell Presido To Resign

Still on same mata, na Omoyele Sowore carry protester dey protest for wi decision headquarters, say make wi oga presido resign. Di senior man fry, fry mouth unto many tins for di Democracy day protest wey dem do for Abuja. According Sowore, security zero, food sef nor dey, say, Nigerians don lost dia democracy and dey demand back from di gorment.

todayJune 12, 2026 21

Lagos

Falz, Femi Falana Join Protest For Lagos

Nigerian rapper, Folarin Falana ,AKA Falz di bad guy, sef join protesters for Ikeja Underbridge, Lagos, on Friday to demand action against rising insecurity, economic hardship and bad governance across di country. Di protest, wey im join alongside im papa, human rights lawyer Femi Falana, and other activists, organise, pin point say enough don dey enough and dat Democracy Without Security na zero Falz drop some bars during di protest, say, Nigerians don tire for di worsening situation and dey […]

todayJune 12, 2026 42

Sports

Bellingham Tuk Wetin Spoil England Euro

By: Shalom Ovie England midfielder Jude Bellingham don talk say Three Lions squad dey more united and connected as dem prepare for dis summer World Cup. Im say na beta wire, coach Thomas Tuchel to connect di quard compare Euro 2024, wey some tins no go well. According to Jude, too much expectation from fans and outsiders contribute to di problem.

todayJune 12, 2026 17

obodo oyinbo

How War For Iran Take Knack UK Economy Down

By: Shalom Ovie Di Office for National Statistics don go do tatafo, UK pipo di feel di Iran war, UK GDP drop by 0.1 percent, like Old mama something, wey break di fine 0.3 percent growth wey dem get for March. Dis current US and Israel war against Iran wey start since February 28 scata things, as high fuel and light bills carry UK economy go put for backyard. Finance Minister Rachel Reeves yarn say even though the UK no […]

todayJune 12, 2026 23 4

WHO WE ARE

We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.

We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!

Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!

 

listen with your app

This will close in 0 seconds