Blog masonry

Background

National

Ecowas Declare Emergency For West Africa Sake Of Security Wahala

By: Alice Iduh Di Economic Community of West African States, ECOWAS, Ecowas don provoke oh, declare state of emergency for all West Africa say region political and security wahala don tire dem. Na di Commission Presido, Omar Touray, dey yan dis one  on Tuesday for Abuja during di 55th Mediation and Security Council meeting. Touray tell im  ministers and diplomats say recent gbege show say dem need serious thinking about di future of democracy and how to secure di community. […]

todayDecember 9, 2025 29 1

Sports

Mbappe Wunjury Shake Real Madrid Ahead City Clash

By: Alice Iduh Real madrid french superstar kylian mbappe no show for training on tuesday as them dey prepare for big champions league clash against manchester city on wednesday. According to report, di 26-year-old striker weh don score 25 goals for 21 matches this season, break him finger for la liga match against celta vigo on sunday and e get other wahala wey dem sti dey treat for sick bed. If mbappe no fit play, e go be better  yawa […]

todayDecember 9, 2025 9

obodo oyinbo

….Russian Military Plane Crash, 7 Dey Onboard

By: Alice Iduh Russian defence ministry don yanyanpu update say dia  military plane don crash for ivanovo region tuesday. Di an-22 transport plane carry seven people, but nobody sabi if dem survive or not. Di crash happen for one bush for the area, and like this like this, authorities don enter area with dia fork and knife search for the team. Investigation don start as di whole country dey wait make dem find out wetin cause di wahala.

todayDecember 9, 2025 9

obodo oyinbo

Zelensky Meet Pope, Enter Italy For Back Up

By: Alice Iduh The russia, ukrain kwanta just dey gather weight everyday,  say ukrainian president volodymyr Zelensky don enter area go meet  pope leo xiv for him country house for castel gandolfo near rome on tuesday. Whether prayer im go collect or go gather army, nobodi know However sha, according to aproko pipo, after meeting the pope, Zelensky go piante enter  italian prime minister Giorgia Meloni office, wia dem go tuk about the war for  kyiv. Italy don dey supply […]

todayDecember 9, 2025 5

National

Atiku Yarn Matas Say Late Yar’adua Still Dey Inspire Naija

By: Rilwan Agbomeji Wi former vice-presido Atiku Abubakar betterlicious don thruway salute give wi late general,  Shehu Musa Yar’adua, say im still dey inspire politics for Naija. Im dey yanyanpu dis one for Abuja for inside union gathering, Atiku yarn say Yar’adua na correct mentor, brother-in-arms, and moral compass wey dey guide people even till now. Di former vice presido say,  Yar’adua legacy dey motivate Nigerians wey still dey believe for truth and progress for di country.    

todayDecember 9, 2025 9

Lagos

Lagos APC Shake Opposition With Talks Not To Disturb Tinubu

By: Esther Ayoola Lagos branch of the alll progressives congress (APC) dey vex carry matter for head that  make opposition no dey disturb president bola tinubu with “fake politicking and fake wahala” as 2027 dey waka  don near. APC Lagos tuk ,tuk, Seye Oladejo,  ni dey yan this one dey  talk say dis time no be for confused coalitions or any political experiments. Di warning follow after adc yan peter obi make e decide if e wan join any coalition, […]

todayDecember 9, 2025 7

National

FG To Pay ₦185b Gas Debt, Promise Better Light

By: Esther Ayoola Federal Government say dem don take big step to shake life back into Nigeria gas sector and make power supply stable after President Bola Tinubu gree say dem go pay ₦185 billion wey government don owe gas producers . Minister of State Petroleum Resources (Gas), Ekperikpe Ekpo, yarn  dis one on Tuesday say, the  move wey National Economic Council (NEC) under VP Kashim Shettima back, na one of di biggest interventions for Nigeria energy sector for recent […]

todayDecember 9, 2025 8

National

Niger State Pipo Beg For School After 315 Students Abuction

By: Esther Ayoola One parent of di catholic school wey bandits abduct 315 students for agwara, niger state, don beg authorities make dem no shut down di school despite di kpai wahala last month. Bishop bulus yohanna, catholic bishop for kontagora diocese and can boss for niger, yarn dis one tuesday for tv sit down talk. Di plea come just one day after governor umar bago receive 100 rescued students wey don come back from di kidnappers. Bishop talk say […]

todayDecember 9, 2025 6

National

Reps Tell NNCPL To Drop 2021 Audit Papers Dec 15 For Audit

By: Rilwan Agbomeji House of Reps Public Accounts Committee don claer marras dat make di  nnpcl  drop all di missing documents  of company and show face for Abuja before December 15, 2025, over  2021 spending audit wahala. Chairman Bamidele Salam vex for Monday sitting as e blast NNPCL for always dodging summons and refusing to bring di papers wey dem ask for. E talk say di kain disrespect wey di company dey show Parliament dey block proper audit review and […]

todayDecember 9, 2025 11

WHO WE ARE

We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.

We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!

Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!

 

listen with your app