Blog masonry

Background

Sports

Germany Beat Ghana 2-1 As Undav Finish Dem Late

By: Esther Ayoola Germany don give Ghana dia second defeat for dis international break beating dem 2-1 with Deniz Undav late goal. Kai Havertz naim score first from penalty give Germany di lead. Ghana, wey lose 5-1 to Austria before, try fight but no fit stop Germany attack. Germany don win seven games straight now, and dem don win three and draw two for five matches against Black Stars now.

todayMarch 31, 2026 4 2

Sports

Quadri Aruna Face Early Exit Afta Pucar Hammer Am 3-0 for ITTF World Cup

By: Esther Ayoola Quadri Aruna dey face wahala for di ITTF World Cup as e lose 3-0 to Tomislav Pucar for him first Group 6 match for Macao on Monday. Pucar carry di win with scores 11-4, 12-10, 11-6 for dia first ever match. Like dis now, Aruna, wey be di only African wey don reach World Cup quarterfinal before, gats beat Sora Matsushima for him next match if e wan continue for di tournament. Say na Only di group […]

todayMarch 31, 2026 4 2

Sports

Victor Boniface Return Werder Bremen Afta Injury Rehab

By: Esther Ayoola Victor Boniface don return to Werder Bremen afta e finish him rehabilitation for Bayer Leverkusen. According to reports, Di 25-year-old player do surgery for January afta e wunjor for training. Originally, pipo bin dey think say e no go fit play again dis season. But with di latest development e be like, im go sti show workings before di season go end.

todayMarch 31, 2026 3

obodo oyinbo

Sweden Police Gbab 62-Year-Old Man For Sexual Assault

By: Esther Ayoola For northern Sweden, say police don charge one 62-year-old man wey be former Hell’s Angel for serious pimping, several rapes, and assault. Police tuk say im wife report am last October afta she tell dem say im dey pressure her to dey have sex with men for money, about 120 men. Authorities explain say, di man don dey do am for years to make money, forcing im wife to perform sexual acts.

todayMarch 31, 2026 4

obodo oyinbo

South Africans Protest Di Appointment Of Naija King For Dia Country

By: Esther Ayoola Say nor bi small tin for south Africa, dat Pipo for East London, South Africa dey protest di coronation of one Nigerian wey call himself king, Solomon Ezika, on Monday. Community groups and traditional leaders naim lead di wahala, wey start peaceful but later turn violent. Police tuk say dem fire rubber bullets to scatter di crowd, and say di alleged stabbing of one protester tori sef, nor dey anywia. Say na More than 10 car nai […]

todayMarch 31, 2026 5

National

ASUU Say No To FG-UK Coventry University Campus Agreement

By: Esther Ayoola Di Academic Staff Union of Universities (ASUU) like dis don reject Naija gornment agreement with UK to create branch of Coventry University for Naija. Im tuk dis one on Monday during public lecture wey ASUU Sa’adu Zungur University branch organize for Bauchi state. Piwuna say dem nor want any Coventry University branch for Naija because e fit spoil Nigerian university system. According to di ASUU oga, say e no fair say Nigerian students dey struggle to get […]

todayMarch 31, 2026 3

National

FCT Police Kick Off 2026 National Police Day With Big Clean-Up

By: Esther Ayoola Di Federal Capital Territory Police Command, like dis don start dia 2026 National Police Day celebrations with big cleaning exercise and free medical outreach for Abuja on Monday. Oga Commissioner of Police, Professor Ahmad Sanusi naim by imself lead di team say police nor dey fear social service. Oga Sanusi explain say di cleaning exercise na to sti show pipo of di Naija decision headquarters say, dem ready to serve dem untop policing.

todayMarch 31, 2026 1

National

Northern Govos Package Security Matas Condem Jos Attack

By: Esther Ayoola Di Chairmo of Northern States Governors’ Forum, Gombe State Govo, Inuwa Yahaya, don condemn di attack wey hapun for Angwan Rukuba, Jos North, Plateau State. Im yan dis one afta dia quarterly meeting for Abuja. Governor Yahaya yan say di governors  tuk about security mata for North and dem agree to  tackle di gbege wey dey affect di north.

todayMarch 31, 2026 2

National

Health Minister Explain Why Kontri Man Nor Suppose Use Small Sickness Play

By: Esther Ayoola Naija Health Minister, Muhammad Ali Pate don warn say anything wey dem dey call pandemics nor be something wey person suppose carry play, dat e fit shake national security. E tuk dis one during one health symposium for Abuja, where experts gather to share lessons on how to handle outbreaks. Pate sti stress say any small disease wey dem no control early fit blow like up coming turn big epidemic or pandemic, and say na why guy […]

todayMarch 31, 2026 6

WHO WE ARE

We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.

We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!

Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!

 

listen with your app