Blog masonry

Background

Lagos

How Heavy Lagos Traffic Trap Drivers for Oshodi-Apapa Express

Nor be small tin sup for popular Oshodi-Apapa Expressway completely, say traffic show commuters and motorists beta shegge yesterday. According to aproko pipo say na di Nigerian Ports Authority (NPA), nor too coordinate tin naim cause di jogolo. Di whole expressway block after container trucks and fuel tankers line up anyhow to enter di nation’s busiest seaports and depots without any orderly arrangement.

todayJuly 10, 2026 7

Lagos

DRIVER LAND FOR IKOYI PRISON

One 40-year-old korope driver, Kabiru Olajide, don land imself for Ikoyi Correctional Centre. Di Police drag Kabiru go court on top five-count charge because im allegedly stab one bar owner, Chimezie Okpoechi, and his wife, Kate Okpoechi, inside Ibeju-Lekki area. Dis bloody fight hapun on May 10, 2026, inside one bar for Oribanwa Phase 2 after a serious argument burst out because of one unpaid seventy-five thousand Naira drinks bill

todayJuly 10, 2026 7

Sports

France Beat Morocco 2-0

By: Yusuf Abuh France don qualify for 2026 FIFA World Cup semi-final after dem beat Morocco 2-0 for quarter-final match wey happen for Foxborough, Massachusetts. Kylian MbappĂ© open score for 60th minute before Ousmane DembĂ©lĂ© add another goal six minutes later to seal di win for Les Bleus. MbappĂ© score di opening goal even after Morocco goalkeeper save im penalty for first half. Di result don end Morocco impressive World Cup journey as France dey move closer to winning dia […]

todayJuly 10, 2026 11 7

obodo oyinbo

China Residents Begin Cleanup After Deadly Flood

By: Yusuf Abuh At least 39 people naim don die while nine others still dey miss after one serious flood hit Guangxi region for southern China, as rescue and cleanup work still dey go on like dis. Authorities tok say 26 of di deaths hapun after Liulan Reservoir break, while seven people still dey missing for dat area. According to report  plenty rescue vehicles and security personnel enter Liulan village to support emergency operation and help affected residents. Heavy rain […]

todayJuly 10, 2026 10 1

OBODO NAIJA

Tinubu Meet Security Senior Mehn For Aso Rock

By: Yusuf Abuh Wi oga Presido, Bola Tinubu dey complain oh, in fact im do closed-door meeting with top security chiefs for Aso Rock Villa, Abuja, to check how security mata be for di country. According to report Di meeting focus on fight against terrorism, banditry, kidnapping and oda security wahala wey still dey worry Nigerians. National Security Adviser Nuhu Ribadu, Defence Minister Mohammed Badaru, top military commanders, DSS, NIA and Police oga join di meeting. Di Presidency say di […]

todayJuly 10, 2026 10

south west

Ogun Police Rescue Abducted Prince, Kill Two Kidnappers

By: Yusuf Abuh Ogun State Police Command don rescue Prince Idris, one prince from Okun Owa for Odogbolu Local Government, after kidnappers jaguda go carry am comot from im house on June 30. According to police tuk, tuk person, DSP Oluseyi Babaseyi,  wey konfam dis mata, dem put serious pressure on di kidnapping gang before intelligence operation lead to di killing of two kidnappers. During di operation, police recover one AK-47 rifle, one empty magazine, two phones and one bag […]

todayJuly 10, 2026 10

OBODO NAIJA

Fifth Batch Of Nigerians Return From South Africa

By: Yusuf Abuh Federal Government don bring back another batch of Nigerians from South Africa as fifth evacuation flight land for Lagos on Thursday evening. Air Peace carry more dan 180 Nigerians come back after one technical problem stop di plane from flying as earlier planned. Di latest returnees, mean say about 1,000 Nigerians don now return home since di xenophobic attacks start for South Africa. Government say evacuation exercise still show commitment to protect Nigerians wey dey abroad whenever […]

todayJuly 10, 2026 11

OBODO NAIJA

Three Kpai as Heavy Windstorm Scatter Houses for Yobe

One strong windstorm wey blow for Wednesday evening don kpai three pipo and wunjure several others for Gashua, headquarters of Bade Local Government Area for Yobe State. Di Chairman of di LGA, Ibrahim Babagana, tell media tuktuk pipo say di windstorm last for just 30 minutes and e fit confirm say three pipo don kpai. E describe di incident as one of di worst windstorms wey e don ever see, saying Gashua never experience this kind disaster for many decades. […]

todayJuly 9, 2026 12

OBODO NAIJA

France Go Face Morocco as World Cup Quarter-Final Wahala Begin

France go face Morocco on Thursday for one heavyweight World Cup quarter-final clash as di tournament don enter di business end. After one month of action wey produce 280 goals in 96 matches, only eight teams remain, all chasing di World Cup trophy wey go be decided on July 19 for East Rutherford. France, wey many people see as one of di strongest teams for di tournament, go meet Morocco for Gillette Stadium, near Boston, in a rematch of their […]

todayJuly 9, 2026 13 7

WHO WE ARE

We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.

We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!

Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!

 

listen with your app

This will close in 0 seconds