Blog masonry

Background

Lagos

Lagos Passenger Jump Out From Moving Bus Kpai Himself

By: Mariam Ajayi One passenger go jump comot inside moving commercial bus con kpeme, say di bus get askident go jam  iron pole for  Ojuelegba for Lagos State. According by di Lagos State Traffic Management Authority oga Adebayo Taofiq, for statement wey im wrap like moimoi, say di  driver drink alcohol con dey drive wahwahwah. Taofiq say na based on di Driver wawa  driving naim make di motor get askident Agency tok say investigation still dey go on to find […]

todaySeptember 28, 2026 12

Sports

Ndidi Assure Super Eagles Say Mistake No Go Happun Again

By: Mariam Ajayi Super Eagles captain, Wilfred Ndidi, don give strong assurance say di team no go repeat di mistakes wey cost dem during di last World Cup qualifiers. Ndidi say di Super Eagles dey fully focused and ready to start di 2027 AFCON qualifiers with strong performance against Madagascar tonight for Uyo. E say di first game important well-well because good start go give di team di confidence and momentum to face di other matches. Di Super Eagles go […]

todaySeptember 25, 2026 13

obodo oyinbo

US Strike Kpai 18 People For Iran, As War Tension Rise Again

By: Mariam Ajayi US strike for Iran don kpai 18 pipo and wunjure 108 others, according to Iran Health Minister. Iran organisation wey dey helep pipo for emergency, war, natural disaster and other serious situations. Society say four pipo kpai and 67 others wunjure when one of di attacks hit wedding ceremony near di coast of Strait of Hormuz. Kuwait military also report missile and drone attacks early Thursday, while US Presido Donald Trump threaten more military action against Iran […]

todaySeptember 25, 2026 15

OBODO NAIJA

Naija Beg World Make Dem Give Violence Victims More Help

By: Mariam Ajayi Naija don beg countries around di world make dem no stop to dey helep pipo wey terrorist attacks don affect. Defence Minister, General Christopher Musa, make di call for di United Nations General Assembly, UNGA meeting for New York. Musa say Africa don suffer plenty from terrorism, with sub-Saharan Africa recording about 60 per cent of all deaths from terrorism around di world for 2025. E say terrorist attacks don make many families lose dia homes, money […]

todaySeptember 25, 2026 12

OBODO NAIJA

Obi Say Election rigger Go Go Jail

By: Mariam Ajayi NDC presidential candidate, Peter Obi, say anybody wey rig election under im administration go enter jail, even if na only one vote dem rig. Obi talk dis one for siddon tok on Thursday, September 24, as e yarn about election rigging, opposition parties and how e wan run government. E also say opposition parties no go face harassment under im administration, as e promise to involve dem for important decisions wey concern di country.

todaySeptember 25, 2026 17

Lagos

Elites Lions Club Support Kosofe Students With School Things

By: Mariam Ajayi Lagos Elites Lions visit Kosofe Junior High School for Ketu-Alapere, Lagos on Thursday, 24th of September, 2026 to support students and promote reading. Di club organize school-support and literacy programme to encourage di students make dem take dia education serious. Dem also donate books and oda school materials to help di students for dia studies. Di programme also include motivation to encourage di students make dem read more, work hard and do well for school.

todaySeptember 25, 2026 24

Sports

Chelle Tuk Say Na Our Target Against Madagascar

By: Mariam Ajayi Super Eagles coach, Eric Chelle, don assure Nigerians say hin boys ready to fight for di three points against Madagascar for dia 2027 AFCON qualifier for Uyo. Chelle give di assurance on Thursday during pre-match press conference as Naija dey prepare for Friday’s big game. E say di team don put di result of dia last World Cup qualifier behind dem and dem don focus fully on Madagascar. Chelle say dem don complete dia final training and […]

todaySeptember 25, 2026 12

OBODO NAIJA

Obi Press Yans say hin do any Crede doings for office

By: Mariam Ajayi Seniorman presidential candidate of the Naija democratic Congress, Peter Obi don use hand role head insist say hin no borrow or issue any bond for Anambra during hin eight years as governor. Im fire dis mata for  TV sit down tuk,  even as di anambla gornment dey release evident, Obi say, when e comot for office for March 2014, hin settle all salaries, pensions, gratuities or verified contractors’ bills. The former govo  dey respond to Anambra State […]

todaySeptember 25, 2026 17 1

Sports

Chelle Say Three Points Na Our Target Against Madagascar

Super Eagles coach, Eric Chelle, don assure Nigerians say hin boys ready to fight for di three points against Madagascar for dia 2027 AFCON qualifier for Uyo. Chelle give di assurance on Thursday during pre-match press conference as Nigeria dey prepare for Friday’s big game. He say di team don put the result of dia last World Cup qualifier behind dem and dem don focus fully on Madagascar. Chelle say dem don complete dia final training and prepare well, adding […]

todaySeptember 25, 2026 13

WHO WE ARE

We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.

We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!

Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!

 

listen with your app

This will close in 0 seconds