Blog masonry

Background

Sports

Eddie Howe Dismis Tuk Say Im Wan Go Manchester United

By: Esther Ayoola Newcastle United manager Eddie Howe don make am clear say Man united job nor dey im eyes, because e dey very happy for him job. Howe don dey manage Newcastle since November 2021, and na one of di longest-serving managers for Premier League now. Even though some top pipo like di sporting director and chief executive don change, Howe don build strong relationship with di new bosses. Newcastle dey ninth for Premier League, dem dey near top […]

todayJanuary 6, 2026 5

obodo oyinbo

Maria Machado Vow Say She Go Return Venezuela

By: Esther Ayoola Venezuelan opposition leader Maria Machado tuk say she go return afta US military comot President Nicolas Maduro from power. For her first public tuk since di weekend post, di Nobel Peace Prize winner yarn for Fox News say she dey plan come back Venezuela as soon as possible. Machado no gree with interim president Delcy Rodriguez, say, she na one of di people wey plan torture, persecution, corruption and drug business. Rodriguez bin be vice president under […]

todayJanuary 6, 2026 5

National

Former Rep Member Say PDP Don Fail, Na Why Pipo Dey Run

By: Esther Ayoola Former House of Reps member, Dachung Bagos, don finally expose wey pipo dey gbase comot di pipos democratic party say di party don spoil beyond repair. Bagos yarn dis one for TV sitdon tuk afta e officially join APC, say dem no dey jump party for ambition or eye service but because PDP no dey give people voice again. According to am, APC agenda dey align with wetin people of Plateau State want, as governance na about […]

todayJanuary 6, 2026 7 9

National

Jaguda Bandits Storm Katsina Communities

By: Esther Ayoola Say nor be small tin Katsina state, dat some jaguda Bandits, wey carry dangerous weapons enter some communities for di State, kidnap  pipo for  night. Witnesses tuk say the armed men attack Unguwar Alhaji Barau before dem move go Gidan Dan Mai-gizo and Gidan Hazo for Na’alma Ward, Malumfashi Local Government Area. Security pipo never tuk officially, and nobody still know the exact number of people wey die or wey dem kidnap. Police tuk tuk for Katsina […]

todayJanuary 6, 2026 6 2

National

Army Stop Kidnap For Taraba, Rescue Three People

By: Esther Ayoola Troops of di 6 Brigade Nigerian Army don foil one kidnapping attempt and rescue three people for Taraba State. According to statement wey Umar Muhammad, Army Public Relations Officer for 6 Brigade, sign, di operation happen on January 5, 2026, afta soldiers get correct intelligence about kidnappers for Sangai Village, Karim Lamido LGA. Di Army tuk say as di troops pursue di suspects towards Taraba–Plateau border, di kidnappers abandon di victims and run enter bush. Umar Muhammad […]

todayJanuary 6, 2026 6 4

National

Army Torchlight Soldier Allegedly Kpaiing Of 13-Year-Old Boy For Akwa Ibom

By: Esther Ayoola Nigerian Army don start investigation into death of one 13-year-old boy wey dem allege say soldier shoot for Ikot Abasi Local Government Area of Akwa Ibom State. Di incident happen early momo of January 1, 2026, for Akongntekong Road, Ete, and e cause serious anger and tension for di community. Army Public Relations Officer for 2 Brigade, Mbiokporo, Captain Lawal Mohamed, tuk say Military Police don take over di matter and due process go follow. Witnesses tuk […]

todayJanuary 6, 2026 5

obodo oyinbo

China Move Mehn To Guide Latin America Say Ameriaca Dey Misbehave

By: Esther Ayoola China Foreign Ministry don yarn again say dem no dey happy with wetin US dey do for Venezuela and dem ready join other countries make international law stand gidigba. Dem tuk say dem ready to join hand with countries for di region to protect peace for Latin America plus Caribbean. You sabi say, China don call on US make dem free Maduro sharp-sharp and stop dey topple government for Venezuela. China yarn say di mata no be […]

todayJanuary 6, 2026 7

Lagos

LSFRS Update GNI, Fire Scarra House, Church for Lagos

By: Esther Ayoola Say nor be small fire burn area yesterday for 15, Pipeline Road, off Ekoro Road, Abule Egba, Lagos, wey scarra one residential house plus small church for di area. Lagos Fire Service wey confamate di tori  say, dem receive distress call around 1pm. and sharp-sharp na so dem rush with  dia fire crews from Agege and Abesan station go fight di blaze. Controller General, Margaret Adeseye, tuk say dia first check show say na di recycling site […]

todayJanuary 6, 2026 5

National

NNPP Clear Marras On Who Be Dia Party Leader

By: Esther Ayoola National Vice Chairmo of New Nigerian Pipo Party  for Northwest, Sani Danmasani, don reveal tuk say oga Govo of Kano state, Abba Yusuf, na be di real leader of di party, no be Rabiu Kwankwaso. Im sukili dis one for inside statement, say according to NNPP constitution, anybody wey be sitting governor and party member automatically be leader, and na why Abba Yusuf take get dat position for Kano and nationwide. Dis one sef dey come, supporters […]

todayJanuary 6, 2026 5

WHO WE ARE

We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.

We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!

Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!

 

listen with your app