Blog masonry

Background

National

Wike Say Tinubu Give Makinde N50bn Despite Political Wahala

By: Ayobami Dada FCT Minister, Nyesom Wike, don tok say, Presido Bola Ahmed Tinubu do wetin e fit do to support Oyo State Govo, Seyi Makinde, even after di political wahala wey happen between dem after di 2023 election. Wike tok dis for TV siddon tok on Monday, as e answer question on whether Tinubu treat Makinde well despite di support wey di Govo give am for di 2023 presidential election. E say e dey directly involved for talks about […]

todaySeptember 22, 2026 13

National

Workers Tell Tinubu: “N500 Fuel Or N500,000 Minimum Wage!”

By: Ayobami Dada Civil servants under Joint National Public Service Negotiating Council(JNPSNC), Trade Union Side, don write President Tinubu say hunger and hardship don squeeze workers tire, make government move fast. Dem dey ask government make petrol price drop to N500 per litre, give workers Wage Award, plus add money to dia salary and allowances. Dem also want government set up committee to sit down negotiate new National Minimum Wage of N500,000 before January 2027. Workers say petrol price wey […]

todaySeptember 22, 2026 14

Lagos

Lagos Draw Ear Give Residents Say Fake Palm Oil Dey Outside

By: Ayobami Dada Lagos State Consumer Protection Agency (LASCOPA) don warn residents make dem dey careful when dem dey buy palm oil, as people don dey use more  ways to mix fake things inside am. Di agency give di warning on Monday after Dr Nurah Oseni from Auchi Polytechnic present research on palm oil adulteration for Lagos State Food Safety Conference and Exhibition 2026. Oseni say palm oil easy to spoil because plenty people dey buy am, as many pipo […]

todaySeptember 22, 2026 12

Sports

Nigerian Flamingos Beat Burkina Faso 2-0 For WAFU B U-17 Cup

By: Ayobami Dada Nigeria Flamingos fire Burkina Faso 2-0 for Yamoussoukro on Monday to continue dia strong run for di 2026 WAFU B U-17 Girls Cup, after Mary Dunstan score di opening goal eight minutes before full time. Di Flamingos control di game from di beginning for Yamoussoukro on Monday and put Burkina Faso under steady pressure, but dia opponents defend well to keep di first half without goal. Nigeria continue di pressure after half-time as Burkina Faso stand gidigba, […]

todaySeptember 22, 2026 16

obodo oyinbo

Flights For Major US Airports Delay As Control Cable Cut.

By: Ayobami Dada US aviation official Bryan Bedford talk say flights delay for major US airports on Monday after construction workers cut cable wey air traffic controllers need to guide planes during take-off and landing for New Jersey. US Transportation Secretary Sean Duffy say di workers dey work for Amtrak when dem cut di cable, causing ground stops for airports across New Jersey. Duffy say flights don start again for New York LaGuardia and Philadelphia on Monday, but plenty flights […]

todaySeptember 22, 2026 10

National

Wike Say Im Main Target Na To Make Sure Tinubu Win 2027 Election

By: Ayobami Dada FCT Minister, Nyesom Wike, don tok am again ooo, say im number one political target now na to make sure say President Bola Ahmed Tinubu win di 2027 presidential election. Wike talk dis on Monday for Abuja after e inspect some ongoing road projects across di Federal Capital Territory (Abuja). E also deny some kind tok say di Rainbow Coalition wey e dey part of na plan to scatter political parties, say that kind tok no hold […]

todaySeptember 22, 2026 12

National

Tinubu Extend Working Vacation, Go Return Back To Naija Dis Weekend

By: Ayobami Dada Wi Oga Presido, Bola Ahmed Tinubu don add some days to him working vacation, and e dey expected to return back to Nigeria dis weekend. For inside statement wey di presidency release on Monday, Presidential Adviser on Information and Strategy, Bayo Onanuga, tok say Tinubu still dey follow wetin dey happen for Nigeria and dey continue to direct di affairs of di country even as e dey abroad. Since Tinubu comot go London on di 30th of […]

todaySeptember 22, 2026 20

Lagos

FG Go Lock Lagos-Calabar Road In 2 Weeks

By: Ayobami Dada Federal Controller of Works for Lagos State, Olufemi Dare, yarn on Monday say di Federal Government fit close di Lagos section of Lagos-Calabar Coastal Highway within two weeks if drivers and oda road users no obey safety rules. Dare tok dis was as e go for inspection of di highway for Lagos on Monday, following order from Works Minister David Umahi because of safety problems, vandalism and illegal activities for di road. He say government dey give […]

todaySeptember 22, 2026 14

OBODO NAIJA

NSCDC Bust Illegal Juice Factory For Badagry, Gbab Two Women

Operatives of di Nigeria Security and Civil Defence Corps, NSCDC, don raid illegal juice factory for Aradagun area of Badagry, Lagos, and arrest two women. Di factory wey dem dey produce drink wey dem call Barkas Juice, dey Talabi Onilegbale Street, Aradagun, Olorunda LCDA, and NSCDC operatives discover am on September 19, 2026, around 9pm. Di two women, aged 48 and 50, bin dey di factory when NSCDC operatives from Badagry Divisional Headquarters arrest dem, as di Corps allege say […]

todaySeptember 22, 2026 15

WHO WE ARE

We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.

We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!

Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!

 

listen with your app

This will close in 0 seconds