Blog masonry

Background

obodo oyinbo

Trump Wan Share Bomb Giv Oman On Top Hormuz Marras

US Presido Donald Trump on Monday don threaten to bomb Oman if di country try block any US deal with Iran over Strait of Hormuz, as e also tell Iran make dem surrender. Iran and Oman officials don dey hold talks for weeks on how ships go take pass through di important waterway, and Iran Foreign Ministry say both sides dey work on joint agreement. But Trump still dey insist say US get control of Strait of Hormuz, even as […]

todayAugust 17, 2026 12

OBODO NAIJA

Over 200 KASU Lecturers Stop Work, Tok Say Strike Fit Start

Nor be small gbege for Kaduna state university, say Over 200 professors and other academic workers don comot from Kaduna State University, KASU, over poor working conditions and di university failure to implement di 2025 Federal Government-ASUU agreement. ASUU-KASU chairmo, Abubakar Abdullahi, fry dis mata on Monday for press conference for di union secretariat inside Kaduna State University. Abdullahi say di 2025 FGN-ASUU agreement, wey suppose improve working conditions for lecturers across Nigerian universities, take effect from January 2026, but […]

todayAugust 17, 2026 13

OBODO NAIJA

Edo Assembly Speaker Comot From House of Assembly

Edo State House of Assembly Speaker, Blessing Agbebaku, don resign on Monday as some lawmakers dey move to impeach am, and im media aide, Ivy Ebojele, konfamate say he don comot. After di resignation during Monday plenary for Edo Assembly, Yekini Idiaye, wey represent Akoko-Edo Constituency 1, don emerge as di new Speaker. Idiaye tell journalists after di sitting say Agbebaku leave office because of poor leadership and alleged corruption, with too many adjournments during im time as Speaker.

todayAugust 17, 2026 14

Lagos

NDLEA Destroy N301bn Worth Of Drugs For Lagos

By: Kofoworola Olayinka NDLEA don destroy almost 330,000 bag of drugs of different illegal drug wey worth about N301 billion for Lagos on Monday, following Federal High Court order. NDLEA Chairman Mohamed Buba Marwa say di exercise for Navy Town, Ojo, na part of effort to stop drug pipu and cut dia money supply. Di agency say di drug include cocaine, heroin, cannabis, methamphetamine, tramadol, codeine syrup and other illegal substances wey officers seize between April 2025 and May 2026. […]

todayAugust 17, 2026 13

obodo oyinbo

US Teen Weh Dem Accuse Say E Kill Mama, Brother After ChatGPT Search

By: Kofoworola Olayinka Police for Massachusetts don charge teenager Aravind as adult for allegedly killing him 45-year-old mama, Sudha Venkatesan, and him 14-year-old brother, Siddharth, for dia house for Acton. Middlesex District Attorney Marian Ryan say police find some disturbing thing for Aravind internet activity, including searching for idea about killing family member on ChatGPT. Police go di house around 6:30 p.m. on Tuesday after Aravind papa ask dem to check on di family because a tutor could not enter […]

todayAugust 17, 2026 10

crime& security

Police Arrest Woman Over Alleged Baby Theft In Kebbi

By: Kofoworola Olayinka Kebbi State Police don arrest Khadija on August 14, 2026, after she allegedly carry another woman newborn baby run away and present di baby to her husband as her own. Police say Khadija allegedly deceive her husband for about nine months say she dey pregnant, after she face pressure over her inability to have a child. Di suspect allegedly use opportunity to take di newborn after she was sent to fetch water, as police later recover di […]

todayAugust 17, 2026 11

Sports

Cameroon Hammer Malawi 3-0, Win WAFCON For First Time

By: Kofoworola Olayinka Cameroon beat Malawi 3-0 on Sunday final to win WAFCON trophy for di first time. Marie Ngah score two goals, while Naomi Eto add another as Cameroon finally become African champions. Cameroon get second chance to play di tournament after organisers increase di teams from 12 to 16. For Malawi, di loss end dia surprise run after dem reach final despite being ranked 153rd for world.

todayAugust 17, 2026 12

Sports

Maresca Say Man City Problem No Be Only Because Rodri No Play

By: Kofoworola Olayinka Manchester City manager Enzo Maresca say Rodri na special player wey any team go miss when e no dey play. Maresca point to Rodri World Cup and Ballon d’Or success as proof say di midfielder dey important. But Maresca say fans no suppose blame all City problems on Rodri absence. He say di real matter na how the whole team dey perform, not only whether Rodri dey play or not.

todayAugust 17, 2026 9

obodo oyinbo

Russia-Ukraine Attacks Kill At Least 19 People

  By: Kofoworola Olayinka   At least 19 people die on Sunday after Russia and Ukraine launch fresh drone and missile attack, with both side reporting heavy attacks across different areas. Ukrainian drones reportedly kill five people for Russia’s Rostov region, while three others die for Belgorod, Kursk and Moscow during di attacks. For Ukraine, four people die for areas under Russian control, while Russia Defence Ministry say dem intercept 822 Ukrainian drones during what Moscow describe as one of […]

todayAugust 17, 2026 14

WHO WE ARE

We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.

We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!

Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!

 

listen with your app

This will close in 0 seconds