Blog masonry

Background

OBODO NAIJA

NANS Plan protest on Monday for Oyo state  Students, Teachers wey jaguda kidnap

By : Jolayemi Olajide Meanwhile,  Presido of National Association of Nigerian Students, Akinteye Babatunde, don announce give student across obodo naija say on Monday, all of dem go come out do we nor go gree, we no go gree protest for di release of  Oyo State students wey Jaguda boys  over di kidnap. For one invitation wey im release on Friday, Akinteye talk say di steady maltreatment wey dey jaguda boys dey give  of di victims dey painful and unacceptable. […]

todayMay 29, 2026 20

OBODO NAIJA

Oyo APC Blast Makinde Over Kidnap, Killing and Security Wahala for State

By : Jolayemi Olajide Di Oyo State chapter of di All Progressives Congress (APC) don cry out again over di regular kidnapping, killing, and fight-fight wey dey hapun without any break  for di state. Inside one statement wey di party Publicity Secretary, Olawale Sadare, release for Ibadan, APC talk say things dey go wrong sake of say di govo Seyi Makinde l dey do eye-service and politics with security. Di party  dey vex say di govo, wey suppose be di […]

todayMay 29, 2026 26

Lagos

Lagos Ministry Of Land and Deve Share Plans on How Dem Wan Take Turn Lagos To Mega City

By : Jolayemi Olajide Na true say nobody fit build room and parlour for one day, but with ogbonge plans, senior men still package the great Rome. Dis na di reality as di Lagos State Ministry of Physical Planning and Urban Development roll out dia plans for dia 2026 Annual Press Briefing. Commissioner for di Ministry, Oluyinka Abiodun yarn plenty for di meeting including how dem dey take collect land development money across Lagos State. E clear di air say […]

todayMay 29, 2026 14

Sports

Messi to Lead Argentina 26-Man Squad For World Cup

Argentina  coachie, Lionel Scaloni don release im  26 players wey im wan carry go di 2026 world cup say na Lionel Messi go lead dem. Di 38-year-old football king na im top di list, but one big surprise na say Real Madrid star boy Franco Mastantuono no dey among di players wey dey go di tournament. Dis major competition go make am di sixth time wey Messi dey play for World Cup.  

todayMay 29, 2026 46 1

obodo oyinbo

Israeli Airstrike Kpai 10 Pipo for Gaza, Even Children Nor Escape am

At least 10 pipo, including five childrenis, na im kapi after Israeli airstrike hit one residential building for Gaza City. Israel military talk on Thursday say dem carry out di strike as part of operation to target “two central Hamas terrorists” for Northern Gaza. Di suspected target of di attack na Hamas battalion commander Imad Asleem, wey reportedly kpai together with im teenage daughter Israa, dem later bury dem on Thursday. Hamas never give official statement on di incident as […]

todayMay 29, 2026 26

National

Army Chief Order Troops Make Dem Flush Out Bandits and Kidnappers for Kwara  

Wi Chief of Army Staff, Lieutenant General Waidi Shaibu don order troops of Joint Task Force North Central, Operation Savannah Shield, dat make dem stop all di okporkpise doings by terrorists, bandits, kidnappers and other criminals wey dey operate for Kwara State and neighbouring states. Di Army Chief give di order during im first operational visit to di headquarters of the task force for Sobi Barracks, Ilorin. Oga Waidi Press tuk say Nigerian Army remain committed to protecting lives and […]

todayMay 29, 2026 20

National

Former Deputy Senate Presido, Omo-Agege Cross Carpet to NDC

Former Deputy Presido, of Naija Senate, Senator Ovie Omo-Agege, don leave im old party run go join di Nigeria Democratic Congress (NDC). Di big politician don also let everybody know say im wan contest for di Delta Central senatorial seat for di 2027 general elections. Omo-Agege explain say im take dis decision after beta consulting of oracles including friends and supporters. Im praise di NDC wella and thank top leaders like Peter Obi and Kwankwaso wey dey carry everybody follow.

todayMay 29, 2026 24

National

Federal Gornment To Stop Flights From Ebola Countries

Wi federal government dey consider to ban flights from countries wey dey suffer Ebola virus, all join to make sure say di disease no enter Nigeria. Chief of Staff to oga Presido, Femi Gbajabiamila, na im break dis news on Thursday after one heavy meeting for Victoria Island, Lagos. Gbajabiamila say if dem close border finish, dem go still isolate any passenger wey show Ebola symptoms for airport  to avoid di spread.

todayMay 29, 2026 23

OBODO NAIJA

NYSC warn Corpers to avoid internet scorscor doings

By : Jolayemi Olajide NYSC Director-General, Brig. Gen. Olakunle Nafiu, don warn corps members during Abuja interview on Thursday say national service no exempt them from Nigeria cyberbullying laws. Im drop dis warning through the tatafo pipo sake of say some corpers dey use social media misbehave, thinking say uniform go hide dem. Di DG clear di air say police go arrest any corper wey go break di law with dia ID card, and law enforcement agencies go investigate di […]

todayMay 28, 2026 25

WHO WE ARE

We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.

We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!

Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!

 

listen with your app

This will close in 0 seconds