Blog masonry

Background

National

Makinde Shake Oyo Cabinet, Sack SSG Adeyemo

By: Esther Ayoola Oyo State Govo Seyi Makinde don announce cabinet reshuffle, on Monday, say im dey observe some kpiance doings. For di move, e sack Secretary to di State Government, Prof Olanike Adeyemo, with immediate effect, According to statement wey im media aide Sulaimon Olanrewaju release for Ibadan, Governor Makinde appoint Prof Musibau Babatunde as di new Secretary to di State Government. E still move Barrister Temilolu Ashamu from Ministry of Environment and Natural Resources go Ministry of Budget […]

todayJanuary 5, 2026 6

obodo oyinbo

Russia Send Bomb Scarra Kyiv, Kpai Two Pipo

By: Esther Ayoola Say nor be small tin Russia do with missile and drone for Ukraine early Mor mor on Monday, kpai, kpai two pipo for Kyiv area and wunjor plenty others. According to local oga dem, say, Air raid sirens dey shout across di country just afta midnight. Ukraine military even try air defence for different areas, ni soften di impact. For Kyiv, one private hospital catch fire afta dem strike am, State Emergency Service tuk say one person […]

todayJanuary 5, 2026 6 4

Sports

AFCON 25: Naija Super Eagles, Egypt Do Jim Jim Di Body For AFCON Round 16

By: Esther Ayoola Africa Cup of Nations Morocco 2025 don dey heat up beta style, say four teams don secure quarter-final spots while Round of 16 still dey go on. Senegal enter first afta dem knack Sudan on Saturday, keep dia unbeaten streak for di tournament alive. Later dat same day, Mali follow join, shock Tunisia for penalties even though dem dey play with 10 men. Now Morocco and Cameroon don also confirm, and fans dey ginger as knockout stage […]

todayJanuary 5, 2026 6 2

Lagos

15-Year-Old Boy Do Give Away For Mothers Inside Lagos Hospital

By: Esther Ayoola Area gather on Sunday for Lagos Island say one 15-year-old, Onate Oton-Efebo, do beta give away for mothers inside Maternity Hospital. Di Secondary student touchlight tori pipo frequency say, na heart of love for community and for mothers, ni make am run di show. According to Onate, di waka sef dey possible because of beta support wey im get from im mama and papa. Say, dis na just di beginning, as e plan to do even more […]

todayJanuary 5, 2026 6

Lagos

Sanwo-Olu Leak Sand For Beta Joinbodi Development For Lagos

By: Esther Ayoola Baba govo, Babajide Sanwo-Olu, don clear clear mata wey concern Lagos for 2026 say make Lagos residents nor worry demselves too much dat, 2026 go sengemege, say goment dey plan big projects for transport, agriculture, health, energy, environment and infrastructure. E tuk dis one on Sunday for di 26th Lagos State Annual Thanksgiving Service wey shelle for Tafawa Balewa Square, Lagos Island. Baba Sanwo Olu, say im goment go complete and commission all ongoing projects across di […]

todayJanuary 5, 2026 5 2

National

Kebbi Goment Open Town Schools Again After Bandit Wahala

By: Esther Ayoola Kebbi State goment don approve make some primary and secondary schools for big towns and cities resume immediately afta wetin jaguda boys use dia eyes see last year. U sabi say, dem bin close schools before, afta bandits attack Gorment Girls’ Comprehensive Secondary School for Maga town for November, wia dem kidnap 25 schoolgirls and kill one school guard. Commissioner for Basic and Secondary Education, Dr. Halimatu Bande, tuk say resumption go start today Monday, January 5, […]

todayJanuary 5, 2026 4 4

National

Kwankwaso Set Compass On How Im Wan Waka For 2027 Presidential Election

By: Esther Ayoola Oga national leader of New Nigeria People’s Party (NNPP), Rabiu Musa Kwankwaso, say im nor be mumu oh, dat im go only waka go another party, if dem agree to give am presidential or vice-presidential ticket for 2027 election. U sabi say, Peter Obi join African Democratic Congress (ADC) last year and e go dey contest presidential ticket with Atiku Abubakar and Rotimi Amaechi, wey fit cause wahala inside party. Pipo dey also talk say Kwankwaso fit […]

todayJanuary 5, 2026 4

obodo oyinbo

US Wan Enter Colombia, Trump Say Colombia Presido Get Bad Character

By: Esther Ayoola US Presido, Donald Trump like dis don turn attention to Colombia, say im no like Colombia Presido, Gustavo Petro. Dis one dey come afta world leaders send complain give am on why, U.S kramp Venezuela President Nicolas Maduro. For inside post for X, Trump tuk say goment for Colombia and Venezuela dey “sick,” and Petro dey do like person wey dey sell cocaine. Im still add am say, Cuba goment fit still join.

todayJanuary 5, 2026 3 6

Sports

Coach Chelle Explain Why Im Luck Super Eagles Training

By: Esther Ayoola Super Eagles coachie, Eric Chelle, don come clear im decision to close team training for three days before Nigeria play Mozambique for Africa Cup of Nations 2025 Round of 16. Some Aproko pipo for Morocco bin dey vex say dem nor get access to di super eagles. In fact, Photojournalist Olawale Quadri bin tuk say, rain and catarrh wan bin finish journalists, sake of say dem wan do media parley with di team but Chelle no gree […]

todayJanuary 5, 2026 4

WHO WE ARE

We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.

We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!

Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!

 

listen with your app