Blog masonry

Background

OBODO NAIJA

EFCC Declare Former Minister Sadiya Farouq Wanted

EFCC don declare former Humanitarian Affairs Minister, Sadiya Farouq, wanted over allegation say she divert government money, abuse her office, and join hand for criminal conspiracy. Di anti-corruption agency put di notice for dia website on Saturday, tell members of di public say anybody wey know where she dey make dem alert EFCC sharp-sharp. According to di commission, anybody wey get useful information fit report for any EFCC office for Ibadan, Uyo, Sokoto, Maiduguri, Benin, Makurdi, Kaduna, Ilorin, Enugu, Kano, […]

todayMay 9, 2026 27

Politics

Obi Get Green Light as NDC Zone Presidential Ticket to South

Nigeria Democratic Congress (NDC) don reserve dia 2027 presidential ticket for Southern Nigeria, and many people dey talk say dis move fit boost former Anambra State Governor, Peter Obi chance well-well. Dem make di announcement on Saturday during dia national convention wey dey happen for Abuja. Di party still confirm am for dia official X handle, as dem post say, “NDC presidential ticket don go South!” Top party big men dey for di convention, including Peter Obi and former Kano […]

todayMay 9, 2026 33

obodo oyinbo

US Wan Rush Comot Americans From Hantavirus Ship

United States don talk say dem dey arrange evacuation flight to carry Americans wey dey inside one cruise ship wey hantavirus don affect, as di ship dey head go Canary Islands. According to one spokesperson from di U.S. State Department, government dey work to make sure say all American passengers return home safely. Dem also talk say dem dey cooperate with government of Spain and other U.S. agencies to handle di matter well. Di spokesperson sti add say dem don […]

todayMay 9, 2026 24 2

Sports

Super Falcons Set For UK Training Tour

African champions, Super Falcons, don set to travel go United Kingdom later dis month for training camp as part of preparation for di 2026 Women’s Africa Cup of Nations. Di training tour go happen from May 23 to 28, as Head coach Justine Madugu go use di chance check new players and test fresh legs ahead of di tournament. According to reports, di team go play one friendly match during di camping period. However, plenty of di big players fit […]

todayMay 9, 2026 31

OBODO NAIJA

Police Gbab 2 Jaduga Boys For Kwara, Recover AK-47 Gun

Police operatives for Kwara State don arrest two men wey dem suspect say na members of one kidnapping gang, and recover guns plus bullets for one operation for Ilorin. Di Commissioner of Police for di state, Adekimi Ojo, drop dis one for statement wey police tuk tuk person, Adetoun Ejire-Adeyemi, release on Saturday. According to di statement, na officers from di Intelligence Response Team wey dey under di state command carry out di operation after dem get correct informate and […]

todayMay 9, 2026 27

obodo oyinbo

Mexico Wan Close School Sake of World Cup and Hot Weather

Mexico government don yarn say dem go close schools 40 days before normal time because World Cup dey come and hot weather don too much for many parts of di country. Education oga Mario Delgado na im yarn dis one on Friday for one event wey happen for Sonora, Northern Mexico, say dem go close school on June 5 make pikin and teachers no suffer for di serious heat, and so gorment fit focus on preparations for World Cup matches […]

todayMay 9, 2026 24

obodo oyinbo

Ethiopia Woman Born 5 Pikin After 12 Years of Waiting

By : Jolayemi Olajide One 35-year-old woman, Bedriya Adem, don born rare quintuplets for Harari Regional State for Ethiopia after she wait 12 years to get pikin. According to report, She deliver four boys and one girl through Caesarean section on Tuesday evening. Doctors for the hospital talk say both di mama and the babies dey healthy, and di newborns weigh between 1.3kg and 1.4kg. Medical director of the hospital, Dr Mohammed Nur Abdulahi, sti konfam dat  the babies still […]

todayMay 8, 2026 27

OBODO NAIJA

Minister of Tegbe clear matas say im nor Promise to Fix Light In 3 Months

By : Jolayemi Olajide Power Minister-designate, Joseph Olasunkanmi Tegbe, don deny reports wey claim say e promise to fix Nigeria power grid within three months. E yarn dis one through im tuk tuk,  Adeola Adelabu, say di reports no represent wetin e truly tuk during im Senate screening on May 6, 2026. For statement wey dem post on X on Thursday, the minister explain say,  e only mention say gornment still dey work on timelines for di power sector reforms […]

todayMay 8, 2026 31

Sport Yarns

World Athletics Block IOC Move, Hold Ban on Belarus Sports Return

By : Jolayemi Olajide World Athletics don reject International Olympic Committee recommendation wey talk say Belarus athletes and teams fit return to compete under dia national flag for international events. Dis mata sef dey come after IOC executive board meeting on Thursday ginger sports bodies to allow Belarus back, but still maintain restriction on Russia because of Ukraine war. Both Russia and Belarus bin dey banned from Olympic competition since 2022, although dem later allow athletes to compete as neutral […]

todayMay 8, 2026 24

WHO WE ARE

We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.

We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!

Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!

 

listen with your app

This will close in 0 seconds