Blog masonry

Background

National

President Tinubu Order Security To Kramp Niger State Jaguda Boys

By Ebi Oboko Oga Presido, Bola Tinubu dey vex seriously don order im olopka, army, vigilante say make dem carry dia rake and fork enter the bushes of Niger state environs to gbab di jaguda boys wey attack communities for Niger State, kill over 40 pipo and kidnap plenty others. For statement wey im sign by imself on Sunday, Tinubu say im don send sms to wi Defence Minister, Service Chiefs, IGP and DSS boss to do james born track […]

todayJanuary 5, 2026 11 37

Sports

Cameroon Park South Africa Kaya Comot From AFCON, Beating Dem 2-1

By Ebi Oboko Junior Tchamadeu score first for 34th minute, and Christian Kofane add second goal two minutes after half-time, make Cameroon beat South Africa 2-1 for AFCON last-16. South Africa try fight back as Evidence Makgopa score late, but e no reach. Cameroon don enter  quarter-final, wia dem go face Morocco on Friday. Morocco sef beat Tanzania 1 kondo for dia round of 16 game just before the Cameroon game.

todayJanuary 5, 2026 14 17

Sports

EPL Result: Man City, Chelsea Play Draw Open Way for Arsenal

By Ebi Oboko E be like Arsenal don dey peel out with the EPL title beating Bournemouth 3-2, and with plenty wahala result yesterday. Leeds add salt to Ruben Amorim wunjury and Manchester United, drawing 1 1, Matheus Cunha ni score to save United one point. Everton lose 2 4 to Brentford as Igor Thiago run hat trick, while Beto and Barry score for Everton. Newcastle beat Crystal Palace 2 0 with Bruno Guimarães and Malick Thiaw goal, so like […]

todayJanuary 5, 2026 13 15

Business

Tins Wey You Need Sabi About Di Naija New Tax Law

By Ebi Oboko TO WHO E CONCERN – MAKE I JUST GIVE YOU DIS INFORMATE. QUESTIONS & ANSWERS ON DI NEW NIGERIA TAX LAW (Focus on Individuals and Small Businesses) 🟢 Q1: When Di  new Nigeria Tax Act go start work? A1: Di  new tax law go start from 1st January 2026. 🟢 Q2: Who dis tax law concern? A2: E concern everybody wey dey earn money for Nigeria – workers, content creators, remote workers, influencers, traders, etc. Even Nigerians […]

todayJanuary 5, 2026 15 14

OBODO NAIJA

Police Carry Joshua Driver Go Court

By: Rilwan Agbomeji Ogun State Police don carry driver of Lexus SUV wey involve for crash with boxing champion Anthony Joshua go court. Dem arraign di driver, Adeniyi Mobolaji Kayode, 46 years old, for Sagamu Magistrate Court on Friday, January 2, 2026. Police talk say dem charge am because of di accident, and di case don officially enter court. According to police spokesman, Oluseyi Babaseyi, di man face four charges, including dangerous driving wey cause death.

todayJanuary 2, 2026 15

Lagos

Sanwo-Olu Revisit GNI Building, Say 8 People Kpai

By: Rilwan Agbomeji Oga govo of Lagos state, Babajide Sanwo Olu don go back see di extent of damage for di Great Nigeria Insurance (GNI) building on Lagos Island for Balogun market wey burn last wee. Oga govo say so far na 8 pipo dem don confamate dead for di ugly marra. Visiting di site on Friday 2 January, 2026, di govo give a total breakdown of wetin relly hapun for di site.

todayJanuary 2, 2026 8 2

Sports

Mozambique Presido Promise To Give Players Bonus To Beat Super Eagles

By: Rilwan Agbomeji Mozambique Presido, Daniel Francisco Chapo don hail di Mambas afta dem qualify for di Round of 16 for 2025 Africa Cup of Nations wey dey happen for Morocco. E yarn tori pipo on Friday, say, di team show correct football and make di whole country proud, even though dem lose 2-1 to Cameroon for dia last group match. Chapo say di achievement na big one wey nobody don do before, and e sweet im well well. E […]

todayJanuary 2, 2026 8

Lagos

Sanwo-Olu Salute Lagos Pipo Grit, Promise To Run Matas Well For 2026

By: Rilwan Agbomeji Lagos State Governor Babajide Sanwo-Olu wan finish Lagosians with hailings say dem get strong mind, dat dem sabi somtin, and sabi cooperate. Di senior man of di state sukili dis one for im 2026 New Year message, e promise say im govment go focus more on people mata and hear wetin dem need. Sanwo-Olu yarn say everybody go need patience and join bodi, and im go dey act fast to fix wetin no dey work  for state. […]

todayJanuary 2, 2026 9

obodo oyinbo

Yemen Wahala, Say Saudi-Pipo An Separatists Scarra Yemen Border With Fight

By: Rilwan Agbomeji Fighting don break for Yemen, for Hadramout province wey dey near Saudi Arabia, between forces wey follow Saudi-backed govo and di Southern Transitional Council (STC) separatists. STC talk say Saudi Arabia dey bomb dia pipo near di border, but oga govo,  Salem al-Khanbashi yarn say dem just wan take back military bases “peacefully and systematically.” STC tuk, tuk, Lieutenant-Colonel Mohamed al-Naqib yarn say dia dey fight serious war against Saudi-led coalition wey dey support govo. Di fighting […]

todayJanuary 2, 2026 7

WHO WE ARE

We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.

We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!

Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!

 

listen with your app