Blog masonry

Background

National

IGP Wire Commissioners Of Police To Check Tools

By: Esther Ayoola Oga Inspector General of Police, Tunji Disu, like dis don send order to all stations across di obodo Naija to check all dia working tools make wetin hapun for Delta nor repeat imself. Im yan dis one during a meeting with senior officers in Abuja on Tuesday. Disu clear im Commissioners of Police to conduct proper check of all dia tools. Dis sef dey come afta a viral video of officers shooting a handcuffed man for Warri, […]

todayMay 5, 2026 29

National

Sowore question Tinubu Nomination Form for 2027 general elections

By: Esther Ayoola Senior man human rights activist and former presidential candidate Omoyele Sowore don cut chain again dey drag wi oga presido, Bola Tinubu, say why im go persin go pick nomination form am. Di reaction come afta former Ebonyi State govo and Minister of Works, David Umahi, sign Tinubu presidential nomination form wey cost N100 million. Umahi, for statement through him aide Francis Nwaze, say di endorsement na to show commitment to continuity and consolidation of Tinubu administration […]

todayMay 5, 2026 24

National

JUST IN: Say 16 Reps Buy Waka From ADC To NDC

By: Esther Ayoola For National Assembly for Abuja on Tuesday plenary, Deputy Speaker Benjamin Kalu drop ogbonge update shake everywia say nothing less than 16 House of Representatives members naim don dump African Democratic Congress (ADC) go join Nigerian Democratic Congress (NDC). According to di lawmakers say dia decision na based on “unresolved crises” for di ADC. Among di defectors na Yusuf Datti, Uchenna Okonkwo, Adamu Wakili, Thaddeus Attah, George Ozodinobi, Lilian Orogbu, and others wey follow move during the […]

todayMay 5, 2026 22

National

Senior Man Bank Chairmo Jim Ovia Hang Boot Afta 12 Years

By: Esther Ayoola Unto ogbonge update from banking sector say Chairmo and founder, of Africa biggest bank, Jim Ovia, don retire as e tenure don end. Di announcement come out on Tuesday for dia 35th Annual General Meeting wey sti dey go on, dem confirm am for statement too. Di bank tuk say Ovia comot afta e complete di mandatory 12 years as non-executive director and chairmo, as Central Bank of Nigeria governance rules require. Ovia become chairman for July […]

todayMay 5, 2026 14

obodo oyinbo

Turkey, Saudi Arabia Drop Plan To Improve Ties, Cooperation End

By: Jolayemi Olajide Turkey and Saudi Arabia like dis, dey plan sign agreement to remove visa requirement for dia citizens as their foreign ministers go meet for Ankara on Wednesday. Say di Tuks go involve Hakan Fidan and Faisal bin Farhan under Turkey-Saudi Coordination Council. According to reports, Relationship between the two countries don improve after di 2018 killing of Jamal Khashoggi for Istanbul cause serious tension before. Turkey say dem go still push for regional solution to di Middle […]

todayMay 5, 2026 21

Sports

How Rangers Coachie Ilechukwu Jinger im to Players Not to Lose Focus

By: Esther Ayoola Enugu Rangers coachie, Fidelis Ilechukwu don tell im players to stay focus as dem push for Naija Premier Football League title. Rangers beat Bayelsa United 2-0 away for Samson Siasia Stadium on Sunday to remain top of di table. Chidiebere Nwobodo naim score di first goal while Godwin Obaje seal di win with him 12th goal of di season. Ilechukwu tuk say di win important but dem must keep diafocus well well as season dey reach final […]

todayMay 5, 2026 19

National

Jonathan Hail Yar’Adua 16 Years After Im Buy Waka Go Di Land Of No Return

By: Jolayemi Olajide Say you nor dey know di value of person until u lose am, and dat na di situation of Nigeria as Former Presido, Goodluck Jonathan pay tribute to late Presido, Umaru Musa Yar’Adua marking 16 years remembrance since e kpai. Jonathan Sukuli dis one for im social media post, dat true, true, Naija dey Miss Yar Adua. Dat Yar’Adua na true servant leader wey sabi as “Gentleman President” because of him humility and integrity. Jonathan sti describe […]

todayMay 5, 2026 25 20

Lagos

One Woman Kpai, Four Injured As Two Sienna Buses Jam Demselves For Third Mainland Bridge

By: Jolayemi Olajide Say nor be small jogolo sup for Third Mainland bridge as two Toyota Sienna buses jam demselves kpaing one woman and wunjor four other passengers on Tuesday. According to report dis askident hapun for early momo near Iyana-Iworo, and both buses carry full passengers. LASEMA tuk, tuk, Olawale Afolabi, later konfamate dis mata to tori pipo dat emergency team reach di area quick to calm di situation. Say dem don carry di wunjured persons  go nearby sick […]

todayMay 5, 2026 31 3

obodo oyinbo

Iran Fit Strike UAE – US Mission Warn

US mission for United Arab Emirates don issue warning say possible aerial threats fit happen. Dem advise Americans say make dem follow instructions from UAE authorities and get ready to run, after reports say, Iranian missiles and drones dey target UAE. Di US Mission explain say dis warning na based on di rising tension and safety concern for di region.

todayMay 5, 2026 26

WHO WE ARE

We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.

We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!

Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!

 

listen with your app

This will close in 0 seconds