Blog masonry

Background

National

Obi, Kwankwaso Join NDC For Abuja, Beg Supporters To Join

By: Esther Ayoola Two of Naija top opposition, Peter Obi and Rabiu Musa Kwankwaso on Sunday like dis don buy waka officially join Naija Democratic Congress (NDC). Party big wigs, including leader Seriake Dickson naim welcome dem for di national secretariat for Abuja on Sunday. Afta di joining, Obi and kwankwaso  fry mouth, telling di gorment of di day to allow multi party system exist.

todayMay 4, 2026 16

National

VP Shettima Tell 2026 Hajj Pilgrims To Package Good Behaviour For Saudi Arabia

By: Esther Ayoola Vice Presido, Kashim Shettima don tell Muslims faithfuls wey wan go 2026 Hajj say make dem represent Naija wella and show good character. Oga Vice presido, tuk dis one on Sunday when e flag off di Hajj airlift for Nnamdi Azikiwe Airport for Abuja. Im say, di Pilgrims be like ambassadors of di country, so dem must behave demselves and follow all di rules for Saudi Arabia. E also promise say gornment go make sure safety, better […]

todayMay 4, 2026 20

Lagos

Lagos-Ibadan Expressway Askident Pai Three, Wunjor One

By: Esther Ayoola FRSC, Ogun branch don Konfam say three kpai, while one wunjure for road askident wey happen on Sunday for Lagos-Ibadan Expressway. Dis na according to FRSC Sector Command for Ogun State tuk, tuk person, Odunsi Afolabi, Afolabi explain say di crash hapun around 1:04 p.m. for Oniworo area, and e involve eight Men Explaining di askident say na one blue Lexus Jeep collide with a black Boxer bike. FRSC say di cause of di crash sti dey […]

todayMay 4, 2026 22

obodo oyinbo

Trump Launch Plan to Free Ships for Hormuz

US Presido, Donald Trump don announce new naval mission wey dem call “Project Freedom”, to escort stranded ships comot from Strait of Hormuz. Iranian lawmaker Ebrahim Azizi say if U.S enter di strait, dem go see am as breach of ceasefire agreement. Say like dis, Iran Foreign Ministry still dey look di response wey dem receive from Washington on dia new 14-point plan to end di war. Trump bin already tuk say di Iranian proposal nor join at all, however […]

todayMay 4, 2026 13

Lagos

Lagos Community Cry For Help Say Dem Blackout Wan Finish Dem For Months

By: Esther Ayoola Residents of Aina Aladi Community Development Association for Alagbado, Lagos, tuk say dem dey suffer oh, serious blackout because of faulty transformer. Community leader, Afeez Lawal, naim carry dis mata dey yarn tori pipo on Saturday, Say dem carry mata to Ikeja Electric office, no response. E explain say di transformer misbehave for about three years before e finally break down for December 2025, wey leave over 300 houses without light. Say, how dem wan take repair […]

todayMay 4, 2026 23

Sports

Inter Milan Win Third Serie A Title in Six Seasons

Inter Milan don win Serie A title again, securing dia 21st Scudetto with 2-0 victory over Parma for San Siro. Marcus Thuram na im start di scoring before half-time, before Henrikh Mkhitaryan add another goal for second half to seal di win. With three matches still remaining, Inter don dey top Napoli by 12 points and AC Milan by 15 points. Dis na dia third title in six seasons, as coach Cristian Chivu celebrate a big achievement for im first […]

todayMay 4, 2026 15

Lagos

LAWMA Beg Gornment To Arrange Long Term Plan For Lagos Waste Management

By: Esther Ayoola Di Managing Director/CEO of Lagos Waste Management Authority (LAWMA), Dr Muyiwa Gbadegesin, don konfam matas, say Lagos State never sti get proper Waste Management Master Plan. E yarn dis one when e receive European Union and ECOWAS delegation for Ijora Olopa, Lagos. E explain say LAWMA dey push make gornment develop di plan wey go guide long-term waste management, investment, and beta sustainability for di state. Gbadegesin use di opportunate wire call to investors to come help […]

todayMay 4, 2026 24

obodo oyinbo

US Fit No Accept New Iran Peace Proposal – Donald Trump

Donald Trump talk on Saturday say e go check new peace proposal wey come from Iran, but e still show doubt whether di deal go work, as e no close door for possible fresh attack on Iran. Peace talks between United States and Iran don jam for ground since ceasefire start on April 8. One round of peace talks wey happen for Pakistan to end di war wey don pass two months no succeed. Dis development come after Tasnim News […]

todayMay 3, 2026 28

Politics

Why We Comot From ADC – Kwankwaso Camp

Spokesman to Rabiu Musa Kwankwaso, Habib Saleh Muhammad, don konfamate say di former Kano State govo and im political camp don decide to comot from African Democratic Congress (ADC), as internal wahala and time no dey before 2027 elections. For exclusive interview with media pipo, Muhammad talk say dem take di decision after plenty consultation with stakeholders across local governments. E further explain say di move come because of wetin e describe as political and legal wahala wey don dey […]

todayMay 3, 2026 30

WHO WE ARE

We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.

We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!

Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!

 

listen with your app

This will close in 0 seconds