Blog masonry

Background

Sports

Guardiola Insist Say No Excuse for City Title Race

Manchester City coachie, Pep Guardiola on Friday dey insist say dem nor go give any tight schedule as excuse if dem fail win Premier League title. E tuk dis one for pre match conference ahead Man city weekend game. City dey second for table, three points behind Arsenal, as season dey enter final stage for England. Di club get three matches in seven days from May 13 to May 19 including FA Cup final against Chelsea and rescheduled league games […]

todayMay 1, 2026 25

OBODO NAIJA

One Woman kpai, Pikins Wunjure as Israel Strike Lebanon

One woman kpai and even pikins injure as fresh attack hit southern Lebanon on Friday. Israeli army konfamate say dem strike about 40 Hezbollah positions, while Hezbollah sef say dem fight back with attacks on Israeli soldiers. Israel dey carry out systematic destruction of homes, infrastructure and water networks for di area. Activists say di attacks don affect tens of thousands of civilians and accuse Israel of war crimes, saying di aim na to make southern Lebanon unliveable.

todayMay 1, 2026 22

OBODO NAIJA

Akpabio Promise Beta Life for Naija Workers

Senate Presido, Godswill Akpabio don scatt im mouth untop matas, say National Assembly dey aware of di hardship wey Nigerian workers dey face. According to di message wey di senate presido send to mark 2026 Workers’ Day, say di national assemble go continue to work on laws wey go improve workers’ welfare. Di naija number three man, Akpabio assure nigerians say di 10th National Assembly go try dia best to make life beta for workers and improve workplace conditions.

todayMay 1, 2026 24

Lagos

Sanwo-Olu Dash Lagos Workers N50k To Mark May Workers Day

Govo Babajide Sanwo-Olu of Lagos don announce in di spirit of workers day celebration say dem go give all public sector workers N50,000 wage award for May. Di Lagos number one man, make dis announcement during 2026 Workers’ Day celebration wey hold for Mobolaji Johnson Arena, Onikan, Lagos. Na di Deputy Govo, Dr Obafemi Hamzat, represent am for di event. E tuk say di money go help reduce cost of living, and to appreciate workers unto di way dem take […]

todayMay 1, 2026 39

OBODO NAIJA

TUC Explain How Naira Stability Take Dey Marry Minimum Wage

Nigeria Workers’ Day don bring fresh talk about whether salary increase really dey help workers. TUC President Festus Osifo na im yarn dis one for interview untop di spirit of workers day celebration. According Osifo wage increase and currency value dem be Ejima, must work together to improve workers’ buying power.

todayMay 1, 2026 25

OBODO NAIJA

Atiku Abubakar Question Presido Tinubu Policy

Former Vice President Atiku Abubakar, don blast di economic policies of President Bola Tinubu, say na Nigerian workers dey suffer pass. Im put dis one for im Workers’ Day message, say dis year, nor be time to celebrate but to think about how workers dey suffer. Di koko of im message be say, Atiku agree say removing fuel subsidy dey necessary, but dat, di gornment to rush am with out plans to protect ordinary people. Im come add say since […]

todayMay 1, 2026 28

Lagos

Orile-Agege Chairman Hail Workers

Chairman of Orile-Agege LCDA, Mr Akinola Idowu, don salute workers as dem mark Workers’ Day, talk say dia strong spirit na wetin dey push development forward. For statement wey im Chief Press Secretary, Sunday Adefamoye release, Idowu praise workers say all dia sacrifice dey help community grow and secure beta future for everybody. Im come explain say labour naim be di block wey dey build nation, con encourage workers to stay strong, get hope, and stay united for Orile-Agege and […]

todayMay 1, 2026 21

Sports

Team Nigeria Get Setback Say Chukwuma, Ogundiran Fit Miss World Relays

Team Nigeria don get serious setback as two US-based sprinters, Rosemary Chukwuma and Blessing Ogundiran, fit miss World Relays 2026. Di Competition go hold for May 2 to May 3 for Botswana National Stadium, Gaborone, but both athletes never join di Nigerian team till now. Chukwuma delay na because of her passport wey come late from embassy. For Ogundiran side, she still dey wait for result of her SRY gene test.

todayMay 1, 2026 22

OBODO NAIJA

Obidient Movement Back Nigeria Labour Congress Wage Increase

Obidient Movement don show support for Nigeria Labour Congress as dem dey push make gornment increase minimum wage. Coordinator Yunusa Tanko talk for Workers’ Day say Nigerian workers na di real heroes wey dey keep di economy standing. E mention say current minimum wage na ₦70,000, but NLC dey propose make dem raise am reach ₦154,000 because of inflation and high cost of living. E come beg Federal Gornment under Bola Ahmed Tinubu make dem act fast, say workers no […]

todayMay 1, 2026 24

WHO WE ARE

We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.

We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!

Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!

 

listen with your app

This will close in 0 seconds