obodo oyinbo

US Fit No Accept New Iran Peace Proposal – Donald Trump

todayMay 3, 2026 7

Background
share close

Donald Trump talk on Saturday say e go check new peace proposal wey come from Iran, but e still show doubt whether di deal go work, as e no close door for possible fresh attack on Iran.

Peace talks between United States and Iran don jam for ground since ceasefire start on April 8.

One round of peace talks wey happen for Pakistan to end di war wey don pass two months no succeed.

Dis development come after Tasnim News Agency and Fars News Agency report say Tehran don submit 14-point peace proposal to mediator Islamabad.

Part of di proposal include make fighting stop for every front and make dem create new arrangement for Strait of Hormuz.

As reporters yarn with am for West Palm Beach, Trump no gree talk wetin fit cause fresh military action against Iran.

On Saturday too, Mohammad Jafar Asadi talk say another conflict between Iran and America fit happen again.

According to am, evidence don show say America no dey keep to dia word or agreement.

Written by: Rilwan Agbomeji

Rate it

WHO WE ARE

We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.

We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!

Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!

 

listen with your app

This will close in 0 seconds