Blog masonry

Background

Sports

Sir Alex Ferguson Land For Hospital Before Man Utd vs Liverpool

Manchester United legend manager, Sir Alex Ferguson, don land hospital after health matter catch am for Old Trafford. Di incident happen just before Sunday Premier League showdown between Red Devils and Liverpool. According to BBC, no be life-and-death emergency, na to play safe dem rush am go hospital. Even with that one, Sir Alex still comot di stadium inside ambulance. People for United camp dey confident say di Ferguson go bounce back quick and return house soon. As di drama […]

todayMay 3, 2026 35

Politics

ADC Fix Dates For Primaries

African Democratic Congress don drop full timetable for im 2026 primary election, as party members wey wan contest now don know when battle go start. For statement wey Bolaji Abdullahi release on Sunday, di party talk say sale of nomination forms go run from May 5 to May 10, 2026. Aspirants go submit their forms from May 11 to May 13, while screening go begin from May 14 to May 15. ADC also talk say anybody wey scale through screening […]

todayMay 3, 2026 33

Politics

Breaking: Peter Obi Dump ADC

Former Labour Party presidential candidate Peter Obi don comot from African Democratic Congress because of serious gbege inside di party and for di country. Di former Anambra State govo post dis statement wey im X on Sunday. E describe Nigeria politics as something wey don turn toxic, full of intimidation, insecurity, and discouragement. Obi explain dat, di decision im think am wella before resigning, hoping dat e go find beta platform for di 2027 general elections.

todayMay 3, 2026 26

obodo oyinbo

US Plan To Comot About 5,000 Troops From Germany

US Defense Secretary, Pete Hegseth,  don order make about 5,000 American soldiers comot from Germany within di next one year, according to Di Pentagon on Friday. Dis move dey come as fresh wahala dey show for relationship between United States and Europe over di Middle East war. At di same time, Donald Trump announce say tariff on cars and trucks from di European Union go rise to 25 percent from next week, accusing di bloc say dem no keep to […]

todayMay 2, 2026 25

Lagos

Ojeleye Collect APC Expression of Interest Form

Journalist, Adewale Lateef Ojeleye, don officially declare say e wan contest for 2027 general election after e collect All Progressives Congress Expression of Interest and Nomination Form for Ifako-Ijaiye Constituency 01 seat for Lagos State House of Assembly. Ojeleye collect di form today for APC secretariat, wey mark di official start of im political ambition to represent people of Ifako-Ijaiye Constituency 01. After e collect di form, Ojeleye talk say e ready to give purposeful representation, push grassroots development, and […]

todayMay 2, 2026 32

OBODO NAIJA

Benue Head of Service, Agbogbo Ode Kpai

Benue State Government don konfamate say their Head of Service, Agbogbo Ode, don kpai on Saturday, after short sickness. According to statement wey Secretatry to di State Government Serumun Deborah sign on Saturday, dem describe Ode as strong technocrat and public service veteran wey give plenty years of solid service to di state. Government talk say im death shake di system well-well, as many people know am for straight character, serious dedication, and di impact wey e leave for Benue […]

todayMay 2, 2026 20

obodo oyinbo

Two Men Kpai Senior Magistrate For Bolivia

Top judge for Bolivia, Victor Hugo Claure, don kpai after two men gun am down inside taxi for Santa Cruz. Police talk say di attack happen on Thursday night when two men ride pass on motorcycle, and one of dem begin spray bullets into di taxi wey di judge dey inside. Claure, wey be one of di highest judges for Bolivia agro-environmental court, bleed out before dem fit carry am reach hospital and prosecutors later konfamate say na four bullets […]

todayMay 2, 2026 25

obodo oyinbo

Xenophobic Attacks Dey Wor Wor For South Africa

As tension dey rise for South Africa, Nigerian Consulate, together with Nigerian Citizens Association in South Africa, don arrange free repatriation flight for Nigerians wey wan return home permanently. According to President of NICASA, Frank Onyekwelu, e say di wahala don force many Nigerians to lock their shops and businesses. E add say, no serious support system dey on ground for Nigerians wey di crisis affect, but di consulate intervention don at least open door for people wey wan comot. […]

todayMay 2, 2026 25

Sports

Carter Efe Beat Portable For Celebrity Boxing Match.

Portable finally jam im match for ring on Friday night as Carter Efe scatter am for all three rounds, come collect clean victory by unanimous decision for Chaos in di Ring 4 wey happen for Federal Palace Hotel, Victoria island. All three judges give Efe 30-27, as Portable lose im celebrity boxing crown sharp sharp. Portable wey don first beat Charles Okocha and Speed Darlington collect two belts,  dey boast say another belt don sure. But Carter Efe break portable […]

todayMay 2, 2026 27

WHO WE ARE

We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.

We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!

Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!

 

listen with your app

This will close in 0 seconds