Blog masonry

Background

Sports

Former Super Eagles B Midfielder Explain Why Players Dey Japa Go Anyhow Countries

Former Super Eagles B midfielder Ifeanyi Ifeanyi don scata mouth say Nigeria premier football league dem nor dey pay well, na im make players dey take risk go countries wey nobody sabi E tuk dis one for interview with journalist, as im dey explain how life be for am since e move go play football for Iraq. According to am, di reason why people dey fear na because nobody really sabi wetin fit hapun next for Iraq. E add say […]

todayMay 1, 2026 21

Sports

Mikel Reject Fabregas as Chelsea Boss Option

John Obi Mikel tuk one bombshell say Cesc Fàbregas no suppose collect Chelsea manager job, at least for now, say e still too early. E tuk dis one for im Obi One Podcast, as e praise di work wey Fàbregas dey do for Como but insist say make e gather more experience first. Instead, Mikel carry hand point Filipe Luís as beta option for di Chelsea job, say na im fit handle. Even though Filipe Luís never spend too much […]

todayMay 1, 2026 13

Sports

Palace Hammer Shakhtar 3-1 For Semi-Final First Leg

Crystal Palace don scatta Shakhtar Donetsk 3-1 for UEFA Conference League semi-final first leg wey hapun for Krakow, Poland. Ismaila Sarr, Daichi Kamada, plus Jorgen Strand Larsen na im be di people wey score di goals wey give Palace di advantage. Even though Shakhtar dey try for Europe despite all di wahala from war, dem still nor fit match Palace strength

todayMay 1, 2026 14

obodo oyinbo

Hegseth Face Senate to Explain di Middle East War

US Defence Secretary Pete Hegseth don finish im second day for Senate hearing wey dem dey ask am about US military budget and Iran war. Im go Congress to request $1.5 trillion budget, but lawmakers still dey press am plenty questions about di ongoing Iran war. Meanwhile, US Navy don begin restock dia ships for Middle East with fuel, food, ammunition and other supplies to support operations.

todayMay 1, 2026 24

OBODO NAIJA

Army Begin To Touchlight Wetin Kpai Abuja NYSC Corper

Nigerian Armed Forces don begin investigate to know wetin really hapun wey lead to di kpaing of one NYSC Corper for Dei Dei, Abuja. Defence Media Operations oga, Michael Onoja, na im tuk dis one for Thursday during dia monthly briefing for Defence Headquarters, say dem go make sure say dem release di result when dem finish di investigation. Onoja still tuk say support wey come from United States don really hellep Nigerian Armed Forces work beta. E say di […]

todayMay 1, 2026 25

Politics

Wike Declare Say No Way Back for Atiku

FCT Minister, Nyesom Wike don throw shade, put mouth for di Supreme Court judgment plus Federal High Court ruling, saying e don put African Democratic Congress (ADC) for bad position. Im yarn dis on e for TV sit don tuk on Thursday. Where di mata take worwor say, Wike say, people like Atiku Abubakar and David Mark wey comot go ADC nor go get chance to come back to PDP again.

todayMay 1, 2026 21

OBODO NAIJA

NEC Approve 112 Emergency call Number Fix Naija Disasters

Naija National Economic Council (NEC) wey Vice Presido Kashim Shettima dey chair, Inside dia 157th virtual meeting, don approve 112  national emergency number. Say dis one sef go  make emergency response faster and remove delay during danger or disaster time. According to di number two man, di new numbers go hellep people for anywhere for Nigeria get quick response when emergency hapun, anytime and anywhere.

todayMay 1, 2026 15

OBODO NAIJA

FG Approve N548.98bn To Rebuild Carter Bridge

Federal Gornment don approve make dem break down and rebuild Carter Bridge for Lagos, and di whole work go cost about N548.98 billion. According to report, after investigation, dem find out say di part wey dey inside water don spoil beyond repair. Minister of Works, Dave Umahi, na im announce di approval after Federal Executive Council meeting wey hapun on Thursday.

todayMay 1, 2026 16

Lagos

Oba of Lagos Back EFCC To Fight Corruption

Oba of Lagos, His Royal Majesty Oba Rilwan Akiolu I, don assure EFCC say dem get full support from Lagos traditional institution for di fight against corruption. EFCC spokesperson, Dele Oyewale, na im tuk dis one for statement wey dem release on Thursday for Abuja. EFCC Acting Zonal Director for Lagos Zone 2, ACE1 Bawa Kaltungo, and im team na im go visit di Oba palace for courtesy. Oba Akiolu say di visit show respect to traditional rulers and e […]

todayMay 1, 2026 24

WHO WE ARE

We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.

We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!

Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!

 

listen with your app

This will close in 0 seconds