Blog masonry

Background

OBODO NAIJA

Kwankwaso Resign From NNPP To Joinbodi With Oda Parti

Former Kano State govo Rabiu Musa Kwankwaso like dis now don catapult imself comot di New Nigeria People’s Party with immediate effect. E tok dis one for statement on Sunday say di decision no easy at all, but based on di move to save naija need new alignment na im make am comot di parti. Kwankwaso explain say e need join another platform wey go give am beta chance to make real change for di country. E still thank party […]

todayMarch 29, 2026 7

obodo oyinbo

US Plan Ground Attack On Iran Even As Talks Still Dey Go On — Iranian Speaker Yarn

Iran parliament speaker, Mohammad Bagher Ghalibaf, don blast say US dey plan ground attack coded, even as dem dey form say dem wan do peace talk. E talk say enemy dey shout negotiation for outside, but lowkey dem dey arrange ground attack. E still yarn our soldiers dey wait make US troops show face, make dem roast dem and deal with dia  allies finish. Dis gbege start since Feb 28 when US and Israel bomb Iran, kill dia top leader, […]

todayMarch 29, 2026 6

Sports

Adesanya Chop Fourth Straight Loss For Seattle UFC Fight Night

Former middleweight champ Israel Adesanya don chop im fourth straight loss as Joe Pyfer knock am out for UFC Fight Night on Saturday night. Pyfer win di fight by TKO for second round, inside Climate Pledge Arena for Seattle, USA. Adesanya start di fight well, use some kind of sharp movement and korect punches control di first round. But later, Pyfer chest di pressure, change di game with heavy blows and one takedown wey lead to di finish move.

todayMarch 29, 2026 3

Lagos

Lagos State Govo Sanwo Olu Celebrate Oga Presido At 74

Lagos State govo, Babajide Sanwo-Olu hail Bola Ahmed Tinubu as e celebrate im 74th birthday, call am korect leader wey get vision and love for kontri man and woman Sanwo-Olu praise Tinubu, call am patriotic and caring leader wey don help bring growth and development to Nigeria. For statement wey im media aide Gboyega Akosile release, di governor say Tinubu leadership don help renew people trust for government. Im still describe am as strong and experienced politician wey don dedicate […]

todayMarch 29, 2026 5

Lagos

Governor Sanwo-Olu Share Tech Device Give Students To Boost For Lagos Education

By: Esther Ayoola Di Lagos State Govo, Babajide Sanwo-Olu, like dis don expand im Hope for Digital Education programme by giving smart learning devices and core textbooks to public secondary school students across Lagos. According to statement by tuk tuk of di Lagos State Ministry of Basic and Secondary Education, Elias Olawale, say di programme go boost human capital and educational excellence for di state. Olawale say dis na part of of di govo T.H.E.M.E.S agenda, wey focus on Education […]

todayMarch 27, 2026 15

Lagos

Lagos CP Fatai Declare Say Old Police Doings Don Pass, Ready For Collabo

By: Esther Ayoola Lagos State Commissioner of Police, Fatai Tijani don drop promise say gone are those days wey pipo go dey fear police, say like dis na collabo doings di police dey do. Di new commissioner yan dis on Friday for command headquarters for Lagos ahead of 2026 Police Week wey go start on Monday. According to am, modern policing need cooperation, respect and trust, and na why dem dey use community policing take connect with pipo. Im come […]

todayMarch 27, 2026 11

Lagos

How Lagos Gorment Do Give Away For Families Of Dia Late Civil Servant

By: Esther Ayoola Like dis now, di Lagos State Gornment don begin share N701 million plus to 232 families of public servants wey kpai while working for di gorment. Say na commissioner of finance, Abayomi Oluyomi ni run di parrol, praising Governor Babajide Sanwo-Olu for always putting  workers welfare first. According to report, di Families enter Ikeja on Friday for dia cheque presentation for insurance death benefits, dat some collect up to N15 million.

todayMarch 27, 2026 12

National

Airport Police To Do Salutation For Fallen Heroes

By: Esther Ayoola Di Airport Police Command don arrange body to honor officers wey don kpai on duty for National Police Day 2026, dem title am, “Community Partnership: Building Trust.” Police tuk, tuk for Airport Command, Mohammed Adeola, ni post for X on Friday say di event go hellep public build trust. According to report, di celebration go start Monday, 30th March with cleaning exercise, continue with walkathon, public sensitization, and go end Tuesday, 7th April for Eagle Square, Abuja […]

todayMarch 27, 2026 6

National

Turaki PDP Do Anoda Emergency Meeting For Abuja

Pipos Democratic Pati, under Tanimu Turaki National Working Committee and Adolphus Wabara board of trustees, don hold another emergency meeting for Bauchi govo lodge for Abuja. Turaki say, dem dey open to reconciliation and dat from all indication peace fit return to di parti. Meanwhile, Abdulrahman Mohamed-led caretaker committee wey Nyesom Wike back insist say dem sti wan hold planned national convention for 29 and 30 March. Say di mata na to settle di wahala wey dey affect PDP leadership […]

todayMarch 27, 2026 6

WHO WE ARE

We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.

We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!

Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!

 

listen with your app