Blog masonry

Background

Lagos

Federal High Court Launch Digital System For Lagos Division

By: Esther Ayoola Federal High Court for Lagos Division don launch e-filing system wey go make court work go digital, instead of using paper. Untop yarnings with tori pipo for court on Tuesday, Chief Judge, John Tsoho explain di new system, say e go improve efficiency, transparency, and make access to justice easier. E also tuk say di change na something wey  pass due process and dat di old manual filing bin  dey slow court process down.  

todayApril 29, 2026 24

Lagos

Lagos Assembly Back Tinubu Second Term, Praise Subsidy Removal

By: Esther Ayoola Members of Lagos State House of Assembly like dis, don join hand dey back oga Presido, Bola Tinubu make he run for second term as Presido. Dem take di decision for Tuesday plenary afta Ladi Ajomale from Oshodi/Isolo Constituency II move di motion. Ajomale spread bodi explain di Tinubu administration important reforms, like student loan scheme, removal of fuel subsidy, and big infrastructure projects like Lagos Coastal Road. Say all dis work need continuity, so dat Naija […]

todayApril 29, 2026 17

Lagos

Lagos APC Big Men Pick Hamzat As Consensus Candidate For 2027 Governorship Race

By: Esther Ayoola One ogbonge group, wey call dem selves, Governance Advisory Council (GAC), wey be top advisory body of All Progressives Congress for Lagos State, like dis don join force endorse Dr. Kadri Obafemi Hamzat as dem consensus candidate for 2027 governorship election. Chairmo of GAC, Oluyole Olusi, naim convasate dis mata to tori pipo on Tuesday as Govo Babajide Sanwo Olu carry Hamzat go see dem Oluyole say, GAC stand gidigba behind Hamzat, say make oga Deputy nor […]

todayApril 29, 2026 31

OBODO NAIJA

FG Push 30-Day Credit, Direct Fuel Sale to Save Airlines

 Federal Gornment through Aviation and Petroleum Ministries and NMDPRA don tuk say airline fuel marketers must give operators 30-day credit and also sell aviation fuel direct to dem. Dem tok dis one for executive summary wey come out Monday for Abuja, after high-level meeting wey involve FAAN, NAMA, NCAA, airline operators and fuel marketers. Di reason why dem take dis decision na to tackle serious jet fuel shortage and price hike wey don dey affect flight operations and cost of […]

todayApril 28, 2026 22

Politics

Peter Obi Pay Visit to Jonathan for Abuja

Di 2023 presidential candidate of labour party and now of di African Democratic Congress (ADC), Peter Obi, don  pay August visit to former Presido, Goodluck Jonathan for Abuja to tuk about how di country dey go and 2027 election. Di meeting hapun behind closed door, as Obi carry some South-East political leaders go meet am. Obi tell journalists say di visit na part of im consultation waka as e dey prepare ahead of di 2027 general elections.

todayApril 28, 2026 24

OBODO NAIJA

Naija New Housing Minister Promise Affordable Houses

Di new Minister of Housing and Urban Development, Muttaqha Darma, don promise say im go use teamwork take solve Nigeria housing shortage and make houses more affordable. E tuk dis one for handover ceremony wey happen for Abuja on Monday evening. Darma say im administration go work closely with all important pipo for di housing sector to fit achieve better results.

todayApril 28, 2026 19

OBODO NAIJA

Bandits Kpai 11, Injure 2 for Gurbi Community for Katsina

For Katsina State, some Jaguda boys, oyinbo dey call dem suspected bandits don go attack Gurbi community for Kankara LGA, kpai eleven pipo and wunjor two others. Police spokesman Abubakar Sadiq na im dey konfamate dis mata, say once dem receive distress call, joint security team with police and military quickly move go di area. Dis attack happen around 2:40pm on April 26, 2026, as di gunmen enter di zanga, dem begin shoot residents before security pipo con rascal dem. […]

todayApril 28, 2026 18

Sports

FIFA Plan New Yellow Card Rule

Say like dis FIFA, dey consider new disciplinary rule ahead of expanded FIFA World Cup. Di proposal be say dem wan add second “amnesty point” wey go wipe yellow cards after group stage and again after quarter-finals, dis one mean say, suspension go reduce. According to report, Dem dey do am because with 48 teams, players fit play up to six matches before semi-finals, and under current rule two yellow cards na suspension. Di aim for di World Cup na […]

todayApril 28, 2026 32

Lagos

Gas Truck Crash For Eko Bridge, Cause Emergency For LASEMA

Lagos State Gornment don activate emergency response after one gas truck accident for Eko Bridge, outward Apongbon. Di Gornment, through LASEMA spokesman Olawale Afolabi, konfamte dis mata on Tuesday. According to am, di askident hapun when di front tyre of di 10-tonne truck burst while e dey move. E explain say di truck wey carry about 10,090kg of cooking gas lose control, hit di road median and overturn. Di crash cause serious gas leakage, na why emergency teams quickly rush […]

todayApril 28, 2026 48

WHO WE ARE

We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.

We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!

Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!

 

listen with your app

This will close in 0 seconds