Blog masonry

Background

foreign

EU Give Ukraine €90 Billion Loan Say Make Dem Use Am Guide Dia Economy

By: Rilwan Agbomeji Unto marras for di Ukraine war, say like dis, European union don join bodi arrange €90 billion loan for Ukraine say make dem use am take guide, as dia economy dey cry because of war blood. According to report, di Ukraine economy don worwor and that I worwor pass atutuporyoyo Di deal come afta plenty talks for brussels summit, wey Ukraine request more fund because of dia wahala with Russia.

todayDecember 19, 2025 12

National

Fuel Tanker Blow Auchi Road

By: Esther Ayoola Gobe burst for Auchi, Edo State, as one tanker wey explode kpai kpai pipo for di areas. According to police tuk tuk of Edo state, Eno Ikoedem, wey confamate di tori, na Wednesday around 6:30pm for evening na dis gbege sup. People dey ask, who dey involved, how e take happen, and how many pipo dem fit don jam. Once more detail come, u go get am for di channel.

todayDecember 19, 2025 18

Sports

Junior D’tigress Naija Jump Nine Places For FIBA World Ranking

By: Rilwan Agbomeji Right now, na junior dey hot for basket ball , say dem climb nine places for di latest FIBA world ranking for girls, moving to 26 for world. Di ranking wey come out for Thursday, show say Naija na di fourth biggest movers as dem jump from 30 to 26. For Africa, Junior d’tigress dey for number three with 469.5 points, behind Mali wey dey 16th and Egypt wey climb go 21st. For top of di table, […]

todayDecember 19, 2025 45

National

Oil Regulators Say Dem Wan Hawk Naija Crude Oil For Showglass

By: Esther Ayoola Hear mata, say di presidential nominees for Nigeria petroleum regulatory agencies don go promise wi senate, say dem go make sure local production become number one, di champion for Naija petrol mata, and say import go be only last option to cover supply gap. Based pressure wey dem face for dia screening for senate on Thursday, omo, dem nor know wen dem promise heaven and earth oh, say, dem activation, better style, na promote local production for […]

todayDecember 19, 2025 18

Sports

Joshua Ready To Whack Jake Paul For Miami Ring Fight

By: Esther Ayoola Naija, UK senior boxer Anthony Joshua say im don package beta blow for youtuber, Jake Paul for ring today for Miami, say Paul chor chor tukings, na today im go tidy am for ring. Joshua tuk say e wan beat Paul make other online tuk tuk dem learn, dat, nor by to tuk and dat boxing dey im blood, even afta im loss to Daniel Dubois last year. Jake Paul for Wednesday, sti tuk full ground give […]

todayDecember 19, 2025 25

obodo oyinbo

Trump Arrange Mhen Make Dem Rename Kennedy Art Center

By: Esther Ayoola US Presido, Donald Trump omo with all bodness buy waka go rename top arts centre for Washington afta himself based on working. According to Konfam aproko wey come out, Kennedy center wey dem first name afta president John f. Kennedy, say now, dem go dey call am “Trump-Kennedy centre” afta board wey trump choose vote ama. Dis move na example of how trump dey influence big institutions since e return power. E don been yabyab di Kennedy […]

todayDecember 19, 2025 16

National

Oga Presido Tinubu Cut Chain For 9ja Governors

By: Esther Ayoola Wi oga Presido Bola Tinubu don cut chain oh, wia dis vex come from sef nor bodi sabi, say mama Remi never rob im head some time, omo jagaban, enter meeting for Abuja for di mata, change am 9ja govos and APC members say make dem support di idea of state police and local government autonomy. Oga presido yanyanpu dis one for di 14th APC National Caucus meeting wey hold for Abuja on Thursday, say security dey […]

todayDecember 19, 2025 12

Lagos

Lagos Court Put Man For Kirikiri For Property Yahoo Yahoo

By: Esther Ayoola Starting with matas for Lagos, say one Lagos state high court for Ikeja don tie one  mata  for one  Chidi Nwaya head like gala, sentence am to 22 years for kirikiri, say im na ole and im yahoo  N28 million  for one failed property deal for Lagos island. Justice Modupe Nicol-clay, sama  am  beta two separate jail terms, 15 years, and 7 years, but say, im go run sentence together. Di judge talk say di case don […]

todayDecember 19, 2025 18

Sports

Alonso Dey Fight Make E Still Get Im Job – Tote

By: Rilwan Agbomeji  Former Real Madrid striker, Tote, don yarn say manager Xabi Alonso dey fight to keep im job for di club. Tote yarn dis for one siddon talk show say decision to sack Alonso don almost ready as confidence don low for am. E yarn say Xabi dey struggle every three days to prove himself, and di pressure na heavy for am. According to Tote, some people no dey believe in Alonso again, wey make di fight to […]

todayDecember 18, 2025 16

WHO WE ARE

We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.

We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!

Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!

 

listen with your app

This will close in 0 seconds